Nafdac find methanol and cannabis for inside di herbal drinks wey kpai 48 pipo for Ondo state

Wia dis foto come from, Nafdac/X
Di National Agency for Food and Drug Administration and Control (Nafdac) tok say dem discover high concentration of methanol for di herbal drink wey don lead to di death of 48 pipo for Ondo state, southwest Nigeria.
Director-General of di agency, Prof. Mojisola Adeyeye for one statement on Saturday, 19 September tok say 11 out of di 15 samples dem analyse also test positive for Cannabis indica.
She add say as of September, Nafdac don record a total of 17 September 2026, a total of 182 cases, and 48 deaths confirmed.
Methanol na one highly toxic substance wey dey cause blindness, organ failure, and death.
Initial reports bin show 31 deaths — 20 for Odigbo Town and 11 for Araromi-Obu, but di figure don rise.
According to NAFDAC, di affected communities include New Town, Odole, Okele, Orita Odigbo, Araromi-Obu and Oniparaga, but di incident dey more pronounced for Odigbo Town and Araromi-Obu areas of ONndo state.

Wia dis foto come from, Getty Images
Nafdac for more update dem give on top di mata tok say, "182 persons dey affected, 90 dey admitted and dem later discharge dem. Six still dey for hospital, dem dey treat 31 as outpatients, while five persons bicom totally blind and two partially blind."
Di agency say clinical wey dey reported among victims include headache, general body weakness and pain, visual disturbances, difficulty in breathing and altered consciousness, and some cases dey worse rapidly.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem say laboratory analysis of samples dem collect from affected communities confam di presence of high concentrations of methanol, one highly toxic substance wey dey cause blindness, organ failure and death wen you swallow am, even if na in small quantities.
Nafdac explain say di acute oral toxicity tests dem carry out on di samples show significant toxic potential.
However, possibility dey say dos wey recover fit kpai if dem challenged wit second dose," di agency tok.
Dem say chemical screening wit Gas Chromatography confam high methanol concentration for di drinks.
"Di combination of high mortality in animal testing and confirmed methanol contamination strongly suggest say di samples pose serious public health risk. These findings require immediate regulatory intervention to prevent further harm," NAFDAC declare.
Di food and drug agency say investigations don lead to di arrest of 15 persons in connection wit di suspected production, sale, and distribution of di implicated locally produced alcoholic/herbal beverages.
How e take start?
Na on 5 September, tori bin first comot for Odigbo town and Araromi-Obu for Odigbo local govment area of Ondo state say some residents allegedly consume one herbal liquid substance.
Some of dos wey dey affected allegedly dey bicom unconscious bifor dem die for different locations.
On 10 September, Ondo State Ministry of Health bin launch investigation into di report of sudden and unexplained deaths for some parts of Odigbo local govment area of di state.
Dis bin come afta di deaths of more dan 30 pipo, as odas dey sick for hospital.
Dem report di deaths for several communities, including Odigbo town, Newtown and Orita, bifor similar reports show face from Araromi-Obu, wia some pipo kpai and some land for health facilities.
Di State Commissioner for Health, Banji Ajaka, at di time tok say di govment neva establish di exact cause of di deaths, but say preliminary findings don rule out viral and bacterial infections.
E say di report wey di investigation team receive suggest say di victims fit don consume alcohol mixed wit unidentified substance or concoction bifor dem start to fall sick.
On 13 September, di state govment ban di sale and distribution of unverified alcoholic drinks plus oda substances for di state.
Ondo police command at di time bin arrest one Oloruntoba Babatunde on top accuse say na im allegedly produce di harmful alcoholic substances, but 15 suspects dey dia custody now.














