Iranian authorities flog popular singer wey perform without hijab 74 strokes of cain

Iranian singer Parastoo Ahmadi perform for Qom, Iran, during one livestream concert for December 2024
Wetin we call dis foto, Parastoo Ahmadi performance bin dey livestreamed on her YouTube channel for December 2024
    • Author, David Gritten
    • Author, Ghoncheh Habibiazad
    • Role, BBC Persian
  • Published
  • Read am in 4 mins

Iranian authorities don flog one popular singer wey perform without di compulsory hijab and four members of her band and production team, lawyers tok.

One member of dia defence team tell BBC say dem beat Parastoo Ahmadi, three musicians and one producer 74 lashes each for di city of Qom.

29-year-old Ahmadi, bin wear one sleeveless dress during one concert wey dem livestream for December 2024.

Iran laws don ban public performances by women and e require dem to wear headscarves and modest clothing.

For June dis year, one criminal court for Qom bin find Ahmadi and eight oda pip guilty of "offending public decency" afta dem publish wetin authorities describe as "obscene and indecent material".

But Ahmadi and di oda defendants deny di accusation, dem tok say dem no do any wrongdoing.

For di end of September, one appeal court for Qom bin reject di defendants' appeal and confam di sentence, her lawyers tok.

Oda Iranian artists and human rights activists bin condemn di sentences, as dem warn say to flog pipo dey cruel, inhuman and na degrading punishment, dem add say e go against di international prohibition on torture.

On Monday, one of di defendants' lawyers tell BBC say dem flog Ahmadi and four of her male co-defendants for di third branch of di Criminal Sentence Enforcement Office for Qom.

"We do evritin for our power make dem for overturn di verdict overturned, or at least to secure reduction for di sentence or make dem even give dem suspension, but e no work out," e tok.

"Di oda lawyers and myself bin even try make dem postpone di enforcement, but di enforcement branch insist say dem must carry am out immediately."

Pro-reform daily Etemad wey cite anoda defence lawyer, Mostafa Nili, bin identify di four men dem flog alongside Ahmadi as Soheil Faghih-Nasiri, Amin Taheri, Amirali Pirnia and Mohsen Lashkari.

"Parastoo Ahmadi flogging becos she sing and dress as she like na serious violation of her basic human rights. E still show say Iranian authorities dey ready to crack down on women freedom and use force punish anybody wey challenge dia discriminatory laws and policies," Bahar Ghandehari, advocacy director for Center for Human Rights in Iran (CHRI), tok.

Under Iranian law, wey dey based on di kontri interpretation of Sharia say, women and girls above di age of puberty must cover dia hair wit one hijab and wear long, loose-fitting clothing to disguise dia figures.

For 2022, protests bin sweep across di Islamic Republic afta Mahsa Amini, one 22-year-old Kurdish woman wey morality police detain for Tehran for September dat year on top accuse say she wear her hijab "improperly", die for custody.

Women burn dia headscarves or wave dem for air for di nationwide demonstrations against di clerical establishment, during which hundreds of pipo die from di crackdown by security forces.

Since then, many women and girls don stop to dey cover dia hair for public altogether for open defiance of fi dress code.

Authorities bin respond to di periodic waves of arrests, warnings, business closures and oda measures.

For January dis year, thousands of pipo die and dem arrest tens of thousands wen security forces crush anoda wave of mass anti-establishment protests, but dis time, na di kontri economy wahala spark di protest.

Since di beginning of di Iran war wit US and Israel for late February, authorities don increase dia use of di death penalty against protesters.

According to di Norway-based group Iran Human Rights, Iran court don convict at least 39 men ova January protests and don execute di two pipo wey dem find guilty ova di 2022 unrest, dem also execute 16 pipo wey allegedly get connection wit banned opposition groups and dem find 17 odas guilty of espionage or say dem dey collabo wit foreign states.

Di group say another 121 protesters wey dem arrest for January, including six women and five young people wey never reach adult age, don receive death sentence and fit face execution any time from now.