Ivory Coast 0-0 Norway live updates of World Cup 2026 round of 32 match

Wia dis foto come from, MAURO PIMENTEL,PETER POWELL VIA GETTY IMAGES
First Half
23' Corner kick for Norway dem play am but Ivory Coast defenders clear am comot but in di process Yao Diomande collide wit Norway player, referee blow freekick, but time don reach for water break.
21' Ivory Coast get chance to score but di player afta e delete di defenders wey dey im front, e put di ball for di side net.
20' Norway try enta Ivory Coast goal area but defnder clear am.
18' Ivory Cost dey worry Norway for di last two minutes for dia goal area, Ivory Cost hold di ball but Norway defender force di ball go out of play for danger zone.
15' Corner kick for Ivory Coast but Norway defence clear di ball.
13' Alexander Sorloth of Norway carry ball dey run go Ivory Coast area but Ivory Coast young defender tiff di ball from im leg , Sorloth fall for ground.
10'Ivory Coast no dey give Norway chance to play dia game as dem dey follow Norway players neck to neck.
9' Pepe of Ivory Coast play di corner kick wit beta cross but e no meet any of im teammates wey for fire am enta goal.
8' Ivory Coast get chance for Norway goal area but defender no let am pass, corner kick for Ivory Coast.
7' Norway fans full evriwai for di Dallas stadium dey ginger but Ivory Coast fans even though dem no plenti still dey show diasef.
5' Norway dey control di ball now as dem dey do short-short passes., dem dey try build up from back.
3' CHANCE for Norway, Erling Haaland head di ball for Ivory Coast goal aread but e land fpr defender body wey laster clear di ball to safety.
2' Ivory Cost start di match wit beta ginger as dem hold ball ball Norway don collect ball from dia leg.
1' Match don start
Starting Line up
Ivory Coast : Y. Fofana; Doue, Kossounou, Agbadou, Konan; Oluai, Sangare, Kessie, Y. Diomande; Pepe, Bonny.
Norway: Nyland; Pedersen, Ajer, Heggem, Wolfe; Odegaard, Berge, Berg, Sorloth, Haaland, Nusa.
Both Ivory Coast and Norway shine well for di group stage, but one of dis two teams go crash out of di World Cup few hours from now.
Na di first time Ivory Coast dey play for di World Cup knockout stage, and dem go begin dia title chase against strong Norway side, wey superstar striker Erling Haaland dey lead. Im don shine well for im first World Cup tournament.
Ivory Coast na one of di record nine African teams wey qualify for di round of 32, and wit talented young player Yan Diomande for dia squad, dem hope say Africa go continue di impressive run wey di continent dey get for di 2026 World Cup.
Afta three straight group-stage exits for di 2010, 2014 and 2018 World Cups, Ivory Coast don finally qualify for di knockout stage.









