You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
83 more Nigerians arrive for South Africa as 'mama of all protests' dey come
Eighty-three more Nigerians don enta di kontri wit South African Airways flight from Johannesburg, according to di Federal Ministry of Foreign Affairs.
One statement by di ministry tok say two officials from di Consulate-General of Nigeria for South Africa, follow dem enta di kontri.
Di Ministry torchlight say "di fact be say di repatriation exercise of dis batch of returnees na private individuals run am, buy di flight tickets".
As dem don land see di Director, African Affairs Department, Ministry of Foreign Affairs, Ambassador Haruna Ali-Gombe, say dem dey expected to dey handed ova to di necessary govment for documentation and profiling bifor dem go finally link up wit dia families.
Na on Wednesday di ministry tok-tok pesin Kimiebi Imomotimi Ebienfa bin release statement wey announce say 83 more Nigerians go land for Lagos on Wednesday wit di South African Airways.
Dis dey come afta March and March anti-immigration group give new deadline of 30 September for all illegal migrants to comot for South Africa.
Di federal govment bin end dia voluntary repatriation programme wey bin see like 1,490 Nigerians comot South Africa enta back Nigeria sake of anti-migrant protests.
Di ministry tok say, "In line wit im Citizen Diplomacy agenda, di govment no see Nigerians for di diaspora as burden but as ogbonge assets for national development and dey dedicated to ensure say dem dey protected and dey live well."
Di ministry also tank di pipo wey tanda to help wit dis humanitarian waka.
Dem tok say dia donation be beta example of di "whole of society approach" and di public-private collabo wey di govment dey ginger to take handle di wahala wey Nigerians abroad dey face.
Di ministry hail dia patriotism and selflessness say dia contributions don help calm di wahala of Nigerians for South Africa.
Dem kon ask make organised private sector, corporate joinbodis, state govments and well-meaning Nigerians for house and abroad make dem do wetin dis pipo don do say, "our collective efforts go ginger our national capacity to take ansa consular emergencies effectively".
Di govment tok say dem tanda gidigba to ginger strategic partnership wit host nations including South Africa. Dem dey run dis collabo to find wetin dey cause di koko of Afrophobia and make sure say acts of kasala and discrimination against Nigerians go dey prevented and dey strongly condemned.
Meanwhile, di March and March movement say dem go repeat di 30 June nationwide protest - dis time, di theme na for Africa kontri leaders to "fetch dia pipo".
Inside one statement, March and March say dem go gada outside di SADC summit auditorium during di event on Monday.
"We dey announce di second wave of di 30 June National Day of Action and call on di heads of state to prepare for massive deportation of all illegal foreigners for South Africa by 30 September wey go be di mama of all protest."
Dem add say, "South Africans gatz follow di law and remain di eyes and ears of di police against any illegal foreigners for di kontri."
Di 46th Ordinary SADC Summit of Heads of State and Government bin happun for di Inkosi Albert Luthuli International Convention Centre for Durban.
President Cyril Ramaphosa dey expected to become di SADC chairman for di 2026 and 2027 term.
Leaders for di 16 member states for SADC bin gada for di meeting - including kontris wey already evacuate dia citizens from di rainbow kontri during di tension.
Di Southern African Development Community (SADC) get kontris like Namibia, Mozambique, Mauritius, Zambia, Tanzania and Angola.
Di odas na Botswana, Malawi, Comoros, DR Congo, Eswatini, Madagascar, Seychelles, Zimbabwe, Lesotho and South Africa.