You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
South Africa security ministers warn against attacks for anti-immigration protests as Ghana evacuate ova 800 citizens ova xenophobia on Wednesday
South Africa Justice and Development minister Mmamoloko Kubayi don tok say pipo wey dey protest against illegal immigration gatz respect di rule of law.
Afta one emergency security meeting on Monday, she bin address di media wia she tok say "protesters gatz inform di security agencies about any demonstration or march, so say we fit provide security and di organisers gatz inform us about di routes and destination."
Di Justice, Crime Prevention and Security (JCPS) cluster meeting gree say dem go provide security for di nationwide protest for 30 June against foreigners, if di organisers provide information about di numbers dem dey expect, di routes and oda tins.
"As a kontri, we no be xenophobic wey we no dey believe say South African pipo be xenophobic. We gatz issues to deal wit, but we don dey appeal to South Africans make dem know say legal migrants also bin dey for dis kontri. We be part of global society," Justice and Development minister Mmamoloko Kubayi tok.
She add say "we don commit say we go ensure say wia illegal immigrants dey, di law enforcement go act according to law. Di pipo wey commit crime be criminals, whether dem be South Africans or foreigners."
Di minister also explain say dem go deploy deputy ministers to ensure visibility on di ground "to ensure say pipo dey comply wit di current laws."
Justice and Development minister Mmamoloko Kubayi bin reflect for di July 2021 unrest wia pipo bin die wey di kontri lose billions for infrastructure damage, she say govment don learn lesson from dat incident.
"We no fit allow pipo dia properties and business scata, we gatz protect life and property during dis protests. Also when pipo die for dis marches, somebody gatz take accountability. Somebody gatz dey responsible for di deaths sake of families go demand justice," she tok.
Anti-immigration protests bin dey happun across di kontri wey begin for early April.
Vigilantes and anti-immigration protesters dey ask foreigners to leave di kontri as dem dey accuse dem of taking dia jobs and committing crime.
Di foreigners, wey largely be African nationals, don deny dis allegations wey dem tok say dem just dey di kontri dey do dia business, wey some bin dey dia for asylum.
But di March and March movement especially bin dey involved for all di protests wey dem dey insist say foreigners gatz comot di kontri.
In fact, for some communities and provinces, local authorities don pursue foreigners wey dem seize di keys to dia shops.
Di March and march movement say dem go take drastic action if foreigners continue to stay for di kontri by 30 June.
Di mayor of Estcourt for example bin give foreigners for dia neighbourhood 30 June deadline to pack dia tins and comot di area.
African kontris like Nigeria, Angola, Ghana, Ethiopia and odas don condemn di attacks on foreigners wey dem ask South African authorities to call dia pipo to order.
Di international community also bin chook mouth for di development for di kontri - di United Nations (UN) and di African Union (AU) all condemn di xenophobic sentiments.
Di AU dey expected to discuss di issue of xenophobia for dia midyear coordination meeting for Egypt wey go happun for June.
Ghana dey screen ova 800 citizens for evacuation on Wednesday
Ghana High Commission officials don confam say dem dey screen hundreds of citizens ahead of evacuation on Wednesday.
"Ova 800 pipo don register now, we dey screen dem and process dem for di evacuation. Di first batch of 300 go dey ready to enta di flight to Ghana," di High Commissioner Benjamin Quashie tok.
Im add say "at least 25 Ghanaians don confam say dem suffer physical attacks from South Africans for various communities. Dis be unacceptable wey we no want make oda nationals decide to carry out reprisal attacks against South Africans."
Di Ghanaian authorities say dem go ensure di safety of all di citizens.
Di govment apart from say dem go evacuate di citizens free of charge, say dem go give all di pipo wey go return wetin dem call welcome moni and transportation to dia various locations.
Dem also go give dem somtin dem call re-integration allowance and psychological support bifor dem go add dia names for one job platform.
Protests dey expected to continue for Durban, Johannesburg and oda places for di kontri.
Even as South African authorities dey try to fix di wahala, di citizens dey insist say foreigners gatz leave.
Dem say make di foreigners go fix dia own kontris, make South Africans fit enjoy life for dia own kontri.
Security analysts fear say tins fit get worse if dem no find quick solution to dis tension.
Dem say e get di potential to also scata di diplomatic and bilateral relations between South Africa and oda African kontris.