Nigeria discover anoda 'fake agency', Tinubu suspend three permanent secretaries

Published
Read am in 5 mins

Nigeria don find yet anoda fake agency as di mata for di first alleged one still dey float im way through court.

Dis na as di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) announce say dem don find anoda fake federal agency.

ICPC say di new fake agency wey dem find na "National Brands Development and Made in Nigeria Special Project Office".

According to di Chaiman of di ICPC, Dr Musa Adamu Aliyu, di office of dis alleged new fake agency bin get "illegally allocated office space for inside di premises of di Office of di Secretary to di Govment of di Federation."

Di commission accuse one George Buchi Nwabueze say na im bin promote di agency togeda wit some senior public servants for di Office of di Secretary to di Govment of di Federation (OSGF).

"Di suspected promoter of di fake agency, Mr George Buchi Nwabueze, dey discovered to operate under four variants of im name," ICPC oga tok.

ICPC Chairman say dis new discovery dey among dia findings from di 'ongoing investigations of di fake Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC) promoted by Adeniyi Adeyemi Matthew.'

Following di Friday briefing by di ICPC, dem reveal say Nigeria President bin order make dem arrest di man, oga Nwabueze and also immediately suspend three permanent secretaries from di OSGF.

Unlike di first case, e no be like say dis particular alleged agency bin get allocaion for di national budget.

Dr Aliyu add say dis new alleged fake agency wey dem find out na sake of dia investigation wey bin comot based on di first alleged fake agency mata wey come outside earlier dis year.

Earlier dis month, di ICPC bin finish dia investigation into Adeniyi Adeyemi 'fake agency' PFICP.

Di commission tok say federal govment no send any money to di 'fake agency' wey dey linked to Adeniyi Adeyemi, di director-general of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council/Presidential Economic Advisory Council (PFIPC/PEAC).

Dem also torchlight say, di so-called Presidential Foreign Intervention Promotion Council/Presidential Economic Advisory Council no get any legal backing by di National Assembly or any executive order by di president.

As well as, say e get two more fake govment agencies wey dey linked to Adeyemi. Dia name na: FCT Investment Promotion Agency (FIPA) and Foreign Investment Promotion Agency and Public Private Partnership (FIPA-PPP).

Adeyemi bin dey also dey dey accused say im forge legislative instruments or "Enabling Acts" wey e bin use to open Bank Accounts in di name of di fake agency.

Dis na as di National Assembly agree to investigate how PFIPC take get di allocation of 1.302 billion naira allocation for di 2026 Appropriation Act even witout any legal backing.

ICPC findings for PFIPC case

Di ICPC chairman, Musa Aliyu, speak wit tori pipo for early August about wetin dem find out as dem torchlight di 'fake agency' mata.

Aliyu follow tori pipo tok afta e don meet wit Presido Tinubu for inside di State House and submit di investigations report to am.

Here na summary of wetin di ICPC find out:

  • Di letter of appointment wey oga Adeniyi Adeyemi tok say Femi Gbajabiamila sign and issue to am, na fake and e no even come from di president office
  • Di so-called Presidential Foreign Intervention Promotion Council/Presidential Economic Advisory Council no get any legal backing by di National Assembly or any executive order by di president.
  • E get two more fake govment agencies wey dey linked to Adeyemi. Dia name na: FCT Investment Promotion Agency (FIPA) and Foreign Investment Promotion Agency and Public Private Partnership (FIPA-PPP).
  • Federal govment no approve or disburse money to di fake PFIPC/PEAC.
  • Adeyemi also forge legislative instruments or "Enabling Acts" wey e bin use to open Bank Accounts in di name of di fake agency
  • ICPC no find any weaknesses for di systems of di State House or CBN and di processes dey clear.

Di commission come recommend to di President say make dem prosecute Adeniyi and di fake agency well well.

Wetin be dis new 'fake agency'?

Di alleged National Brands Development and Made in Nigeria Special Project Office claim to be agency under di Economic Affairs of di OSGF and dia work na to make sure say dem promote Made In Nigeria products dem.

According to statement from dia website, "di Made in Nigeria initiative bin dey conceived for 2006 during di Nigeria–Singapore Economic Forum. E bin dey formalized under di leadership of Ambassador Chike Alex Anigbo (MNI) and approve by di Federal Executive Council (FEC) in 2017".

Di site add say, "di project at first bin dey work as public-private partnership with Trade Nigeria."

Di agency bin list certain pipo as national coordinator, three zonal coordinators and 20 state coordinators for dia website wit George Buchi Nwabueze as National Coordinator and Executive Director of di agency.

Dem also get kontri representatives/ coordinators for di United States and China.

As per programs, dem bin schedule made in Nigeria fair and Expo for Abia and Anambra states for September and December 2026.

Even wit all dis informate and di fact say dem tanda for OSGF office, dem bin no get .gov website unlike di PFIPC and e no be like say dem bin get provision inside di Nigerian budget.