Nigerian dancer Poco Lee pre trial hearing go hold for February 2027 afta UK Court grant am bail

Pocolee raise im hand

Wia dis foto come from, Dave Pedley/Getty Images for SXSW

Published
Read am in 3 mins

UK Court don set pre trial date for Nigerian dancer and entertainer Iweh Pascal Odinaka wey pipo sabi as Poco Lee.

Dem set February 2027 as di date for di pre trial hearing wia di defendant go begin enta im plea.

Poco Lee case return to court for 15 September, 2026, though e no show face for di court premises.

Dis na afta Snaresbrook Crown Court for di United Kingdom confam for statement wey BBC News Pidgin receive say di dancer dey face some charges.

Tori bin fly around social media say di entertainer dey for custody of di UK authorities for allegations wey dem sama am.

Meanwhile, afta im first appearance for UK court wey make dem hold am for custody, social media tori say court don grant Poco Lee bail.

Some social videos also show wia e dey appear for one live video dey explain im ordeal for di UK.

Snaresbrook Crown Court for di United Kingdom confam to di BBC say dem grant di defendant Poco Lee bail on 11 September, 2026.

Di court add say di plea and trial preparation hearing go happun for 15 September.

Wetin happun for court

For court, Poco Lee no show sake of say di charge sheet no dey available. So, e no enta plea.

Some group of Nigerians dey di court for Poco Lee, as di whole gallery dey so full sotey, pipo gatz wait outside.

Howeva, do pre trial hear go now hold for 8th of February 2027 and na dat time e dey expected to enta plea.

Also, dem set di trial for 8 March, 2027.

Alreadi, di UK court don confam say Poco Lee dey on bail.

Who be Poco Lee

Poco Lee, wey im real name na Iweh Pascal Odinaka, na Nigerian dancer, hype man, MC and entertainer. Dem born am on 21 October 1996 and e come from from Orlu, Imo State, southeast Nigeria, although na Ojo area of Lagos State, southwest Nigeria, dem raise am.

Im major breakthrough come around 2018, wen one video of am dey perform Zanku/Legwork bin go viral. Nigerian singer Zlatan Ibile see di video and work wit Poco Lee. Dat exposure help establish am as one of Nigeria most recognisable dancers.

Poco Lee later perform wit major Nigerian artistes including Davido, Wizkid, Burna Boy, Tiwa Savage, and Naira Marley.

Poco Lee don move beyond dancing into music and performance, and im songs include "YARD", and "Otilo." Im official website describe am as dancer, hype man and cultural connector.

Poco Lee bin study Microbiology for Lagos State University (Lasu).

E be one of di Nigerian entertainers wey help take street dance from Lagos to mainstream Nigerian pop culture, especially through di Zanku era.