UK Court confam say Nigerian dancer Poco Lee go appear for plea and trial preparation

Poco Lee

Wia dis foto come from, Dave Pedley/Getty Images for SXSW

Published
Read am in 3 mins

Snaresbrook Crown Court for di United Kingodm don confam say Nigerian dancer and entertainer Iweh Pascal Odinaka wey pipo sabi as Poco Lee go appear bifor dem for plea and trial preparation on Tuesday, 15 September 2026.

According to di statement wey BBC News Pidgin receive from di court, Poco Lee dey face some charges and e go get im day for court to plead weda im dey guilty or not.

Dis dey come afta tori bin dey fly around social media say di entertainer dey for custody of di UK authorities for allegations wey dem sama am.

Meanwhile, one Nigerian diasporan wey dey live for UK, Benjamin Kuti wey pipo sabi as Oluomo of Derby, bin earlier confam on im X page say Poco Lee dey for UK authorities custody.

"Im next court date dey scheduled for di second week of September, wen e dey expected to get plea hearing. At dis hearing, e go typically enta plea of either guilty, meaning e admit to di offence, or not guilty, meaning e deny di offence," e tok.

Kuti say e go also attend di court proceedings as part of im support for di Nigerian community for UK, to "ensure say our fellow Nigerian receive di appropriate support during dis difficult period of im life".

Who be Poco Lee

Poco Lee, wey im real name na Iweh Pascal Odinaka, na Nigerian dancer, hype man, MC and entertainer. Dem born am on 21 October 1996 and e come from from Orlu, Imo State, southeast Nigeria, although na Ojo area of Lagos State, southwest Nigeria, dem raise am.

Im major breakthrough come around 2018, wen one video of am dey perform Zanku/Legwork bin go viral. Nigerian singer Zlatan Ibile see di video and work wit Poco Lee. Dat exposure help establish am as one of Nigeria most recognisable dancers.

Poco Lee later perform wit major Nigerian artistes including Davido, Wizkid, Burna Boy, Tiwa Savage, and Naira Marley.

Poco Lee don move beyond dancing into music and performance, and im songs include "YARD", and "Otilo." Im official website describe am as dancer, hype man and cultural connector.

Poco Lee bin study Microbiology for Lagos State University (Lasu).

E be one of di Nigerian entertainers wey help take street dance from Lagos to mainstream Nigerian pop culture, especially through di Zanku era.