South Africa police confam seventh bodi of woman for Gauteng Province as killings dey raise fear

Wia dis foto come from, Brenton Geach/Gallo Images via Getty Images
South African authorities say dem don discova di bodi of anoda woman for Ekurhuleni as fear don begin rise about women safety.
Dem discova di bodi wey bin float for one river for Clayville, near di Mall of Thembisa, on 7 September.
Acting Gauteng Police Commissioner Major-General Fred Kekana say di latest discovery go form part of di ongoing investigations into di deaths.
E mean say na seven bodis of women dem don find for di area since July - dem discova four of dis bodis in di past few days.
President Cyril Ramaphosa don direct police to urgently investigate and solve di murders of multiple women for Ekurhuleni.
South Africa acting Minister for Police, Firoz Cachalia, show serious concern as im send im condolences to di victim relatives afta dem discova di sixth bodi.
Di acting minister say to dey find multiple women dead for Kempton Park area dey worry dem but dem no go stop investigation into di mata.
BBC News Pidgin bin earlier report say police on Monday, 14 September announce say dem find di deadi bodi of 38-year-old jogger Elizabeth "Tsontso" Moselakgomo.
Dem say Tsontso bodi go make am di fifth bodi dem go discova for Kempton Park, especially for Rhodesfield area for Gauteng, in di past two months.
"Di discovery of multiple women wey dem murder for di Kempton Park area dey deeply disturbing. While di investigation gatz establish weda di cases dey linked, di possibility say di perpetrators fit dey target women demand our urgent and determined attention," Cachalia tok.
Wetin South Africa police dey do about di murder of women
As part of efforts to look into dis mata, di acting minister tok say acting national commissioner of di South African Police, General Puleng Dimpane, go meet wit di investigating team dis afternoon to get more detail on di progress of di investigation.
E tok say di meeting wit di investigating team go provide opportunity to look into di progress of di investigation and ensure say dem provide all necessary resources and operational support.
E say dem go do correct investigation wey go make dem establish di possible links wey dem need, identify dose wey dey behind and bring dem to justice.
"Di safety of women na priority. Di SAPS go continue to dey work wit communities and oda stakeholders to identify risks, strengthen policing response, and ensure say credible information get attention."
However, inside one interview by local media SABC TV, one woman bin tok say di sixth bodi wey authorities find for di area fit be her missing daughter, but local media neva confam di identity of di sixth bodi wey authorities discova on Tuesday morning.
"We appeal to anyone wit information wey fit assist di investigation to come forward through di appropriate police channels. We also urge di public make dem no circulate unverified information or make accusations witout evidence" police tok.
Di police condone wit di affected families
We no get any link to di perpetrators - police authorities
National Police tok-tok pesin, Athlenda Mathe tell tori pipo on Tuesday say dem see di sixth bodi for Katema area of di province on Tuesday morning and she look like pesin wey dey for her 30s.
"But dis bodi don dey decompose already, and dem dump am for dis area dis morning. As police, we neva reach dia yet. Di experts still dey analyse di dockets, di victim profile, and di behaviour of di suspect or suspects," she tok
She tok say dem still dey investigate weda dem dey deal wit one perpetrator or group of men wey dey kill dis women but dem no get any link, so dem no go fit rush di investigators becos dem go allow dem do "thorough job."
"Dis investigation no be wetin you fit rush, e dey quite complex. E involve a lot of women wey dem kill, and fit involve multiple perpetrators. But make we leave am for di detectives, becoa we want dem to give us di real perpetrators. If we put pressure on dem to speed up di investigation, we fit make mistakes, and we no wan catch di wrong pipo."
Who be di victims of dis killings?

Wia dis foto come from, SA Justice, Crime Prevention and Security
Di first victim na one 37-year-old woman wey authorities discova her bodi near R21 on 15 July.
Police neva confam her identity yet, but dem say dem find her naked and e be like say she bin dey restrained wit cable ties.
Justice, Crime Prevention and Security say dem don arrest one suspect and e dey for custody.
"For dis case, our investigators don already make progress, and one suspect currently dey for custody. Dem arrest di suspect on 17 July 2026. Di investigation into dis mata dey continue."
On 24 August, authorities discova di second bodi, one 32-year-old woman, near di R21. Dem also find her partially clothed.
Di third bodi na dat of one unidentified woman wey dem discova on 10 September 2026.
Police say di bodi bin dey advanced state of decomposition and dem find her naked. "At dis stage, we neva fit formally establish her identity. Di identification process dey go on," police tok.
Di fourth bodi na dat of one 38-year-old woman wey dem discova on 12 September for Rhodesfield for di back of one hotel for di area.
Di woman bin dey wear sports clothing and dem find her partially clothed.
Her identity still dey subject to formal confirmation by di family through di mortuary identification process, authorities tok.
Di fifth bodi na dat of 38-year-old Elizabeth "Tsontso" Moselakgomo. Police say her family identify her on Monday for di Germiston mortuary.
Moselakgomo bin go missing afta one afternoon run on 9 September for Rhodesfield, Kempton Park.
Her disappearance bin raise concerns for di area, as authorities bin put out resources to search for her.
Tributes don dey pour in for di ogbonge runner wey pipo sabi well well as "Tsontso" afta police confam her death.
South Africans also share di fear and anxiety women dey always feel for di kontri.
Advocacy group Women for Change say di discovery of dis bodis dey make dem vex.
"Wetin be di purpose of having a protective service like di police if we gatz make sure… we dey [protect] oursefs," Merlize Jogiat from di group ask.









