Wetin be El Nino and how African countries dey prepare for di bad weather

Indonesia bin dey hit by extreme fires during di 2015-16 El Niño

Wia dis foto come from, Getty Images

Published
Read am in 5 mins

African Union (AU) say meteorologists for di continent don dey prepare for El Niño, one weather pattern wey dey bring extreme weather to many parts of di world.

Di union for di 21st African Continental Climate Outlook Forum say wit El Niño, dem no go just respond to climate-related disasters afta e happun, but dem go champion proactive approach wey centre on anticipation, preparedness, and coordinated early action.

El Niño dey expected to affect key socio-economic sectors across di continent, di AU tok.

Sake of dat, dem go support quick action to protect vulnerable communities and dia livelihoods plus safeguard Africa critical but climate-sensitive sectors, wey include agriculture, energy, health, infrastructure, tourism, and water resources.

El Nino dey come wit floods, droughts, heatwaves and storms to different regions. E dey happun evri two to seven years.

Kenya, South Africa - How Africa dey prepare for El Nino

One woman dey dig hard ground during draught

Wia dis foto come from, AFP

Apart from di steps wey di African Union dey plan to take, some national govments for di continent wey go dey badly hit from di effect of El-Nino don dey take measures to ease di impact of di disaster, dem don also issue advisory to dia citizens.

Di govment of Kenya for statement on Tuesday, 1 September say dem don activate seven key measures to strengthen dia preparation for di extreme weather.

Globally, several countries don already dey experience El Nino and meteorologist tok say di impact for Kenya go dey very strong, about 90%.

"Di anticipated impacts include flooding, drowning, injuries, fatalities, displacement and isolation of communities, diseases outbreak, disruption of essential services, damage to roads, plus oda critical infrastructure, losses to crops, livestock and livelihoods."

Di govment say part of wetin dem don do and wetin dem dey plan to do:

  • Hotspot mapping to identify areas wey dey vulnerable to flooding and oda impacts of heavy rainfall.
  • Unclogging and desilting of drainage system, culverts and oda water channels dey go on to improve water flow and reduce di risk of urban planning.
  • Relevant agencies dey inspect bridges, roads and critical utilities for flood prone areas to identify vulnerabilities.
  • Dem don pre-position emergency relief materials wey include food, non-items and emergency medical supplies for strategic locations to facilitate rapid response in di event of displacement or oda emergencies.
  • Rapid response teams dey on standby and dem don strengthen dem to dey ready for emergencies.
  • Evacuation of pipo wey dey live for high-risk areas dey on track.
Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

South African Weather Service (SAWS) don also warn say di kontri go likely experience below-normal rainfall and above-normal temperatures dis spring as strong El Niño event develop for di Pacific Ocean.

For inside one statement on Tuesday, SAWS say di latest predictions show say El Niño go likely intensify further and fit bicom di strongest event in living memory.

"Di latest forecasts show say di current event dey very likely to exceed di 3°C threshold," SAWS tok.

Sake of dat, di weather service don advise kontri pipo and weather-sensitive industries to follow monthly seasonal forecast updates and daily short-term weather forecasts to prepare for heatwave conditions plus oda high-impact weather events.

Di weather service tok say di 2026/27 El Niño event, combined wit global warming, go likely make 2027 di warmest year, di rainbow kontri don eva record.

"Di 2015/16 very strong El Niño event bin bring unprecedented heatwaves to di southern African region and di region don continue to warm up even afta 11 years since then.

"If di 2026/27 El Niño event bring di expected below-normal rainfall to southern Africa, heatwaves dey likely to occur more frequently.

"Dis heatwaves get di potential to be severe. Howeva, as current forecasts indicate di potential for an exceptionally strong El Niño, dia strength and regional impacts neva still dey clear," SAWS warn.

Di govment say dem go closely monitor di event and go communicate disaster management structures, weather-sensitive industries give kontri pipo.

Wat is El Niño

Foto

Wia dis foto come from, NOAA

US scientists say El Niño fit bring extreme weather to many parts of di world.

Di National Oceanic and Atmospheric Administration (NOAA) tok say El Niño conditions dey likely to strengthen ova di rest of 2026.

Many forecasts suggest say e fit be one of di strongest El Niños ever recorded.

Coming on top of decades of human-caused warming, 2027 fit be di hottest year on record, wit disruption to weather, food supplies and economies.

Some scientists don warn say dis El Niño fit dey especially strong, partly bicos di water beneath di surface of di Pacific dey unusually warm.

Dis waters don dey about 6C above average in places, according to di UN World Meteorological Organization.

Deep-sea heat often dey followed by warmer waters for di surface.

One "very strong" or so-called "super" El Niño na wen di warming of di central tropical Pacific Ocean surface reach 2C or more ova an extended period.

Dis events don only happun a few times since 1950.

Wat impact El Niño fit get on pipo?

UN secretary general, António Guterres, don warn di world to prepare.

"El Niño conditions go pour fuel on di fire of a warming world. Impacts go hit even harder, travel even farther, and cross borders wit devastating speed," e tok.

Di UN Food and Agriculture Organization (FAO) and di World Food Programme (WFP) don list di following African countries wey include Cameroon, Ethiopia, Kenya, Madagascar, Malawi, Mozambique, Nigeria, Somalia, South Sudan, Sudan, Uganda and Zimbabwe as nations wey dey more at di risk of El-Nino.

On 1 September, Unicef warn say more dan 162 million children, ova two-thirds of all children for Eastern and Southern Africa, live for areas wey dey exposed to di impact of di 2026/2027 El Niño.

Unicef say intensifying drought, extreme heat and flooding go threaten children nutrition, health, access to safe water and sanitation, education and safety. Forecasts provide a narrow but critical window to act bifor pipo begin feel di severe consequences.