South Africa nationals dey among hundreds of tourists wey dey miss as ova 90 pipo die for Nepal-Tibet flash flood
- Author, Phanindra Dahal and Laura Bicker
- Reporting from, Kathmandu and Beijing
- Published
- Read am in 5 mins
At least 95 pipo don die for Nepal and hundreds of tourists dey missing afta one massive flash flood and mudslide happun for Nepal-Tibet border. Di flash flood bin wash away villages and destroy roads and infrastructure.
Di missing tourists include more dan 100 from India, 47 from US, 3 from UK, 4 from South Africa according to Nepal tourist board.
Di area dey popular wit pilgrims and trekkers.
Nepal Prime Minister Balendra Shah say im dey left wit a "heavy heart" afta di kontri fatal flash floods.
"Di whole nation dey shocked and deeply distressed" by di loss of life and damage to property, e tok for one social media post, as e call di disaster "sudden" and "massive".
Di flood happun for di early hours of Wednesday for Rasuwa, just north of Nepal capital Kathmandu.
Initial information suggest say na earthquake wey trigger one avalanche wit melted snow wey dey pour into di Bhote Koshi river cause am.
Search operations dey go on for both sides of di border and dem don rescue 88 pipo so far, according to di Nepalese army.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Shaktimaya Tamang
Officials say work dey go on to establish di whereabouts of 579 tourists, wey include 466 foreigners from 28 different countries.
Out of di tourists dem don account for so far, 113 na Nepali, 54 from US, 33 na UK nationals, and 4 from South Africa, according to di police.
Di missing tourists include 12 travellers from the UK plus Americans, Malaysians, South Africans and Indians.
Alpine Eco Trek, wey dey offer guided tours and expeditions for Nepal, confam say 12 British nationals wey dey tour across di Nepal-Tibet border dey miss.
Ram Kumar Adhikari, di manager of Alpine Eco Trek, tok say two Irish nationals and four South African nationals wey also dey on excursion dey among missing persons.
Authorities say 200 out of di pipo wey dey miss na women and 203 na men.
Di foreign nationals come from 26 different countries.

Wia dis foto come from, Reuters
Several areas downstream of di Bhote Koshi river, wey dey flow from Tibet to Nepal, dey on high alert and roads, communications and power for di region also dey affected. Authorities don close di main road to Kathmandu.
Verified videos from Nepal show as water carry one bridge comot and as multi-storey buildings collapse by di force of floodwaters, one town wey also get many buildings destroy.
BBC Verify don locate di clips to di town of Trishuli Bazaar area of Nuwakot District for Bagmati Province, about 25km (16 miles) to di north-west of Kathmandu.
Di video show as di river Trishuli suddenly swell by enormous amounts of water, wey appear to don significantly increase in volume and speed and filled wit sediment.
Di second verified video, wey dem feem from di same location, show di devastating aftermath. Di river leveldon rise well-well, and di water clear trees and many buildings wey dey visible for di earlier video.
One new video wey dem feem from inside one bus for Trishuli show as many pipo dey try run as flash flood rush down di valley.
Pipo fit hear as di passengers dey cry, as di bus drive along di road wey follow di river.
'Water carry my family members away... for front of my eyes'
Some survivors of di flash flood follow BBC tok.
"Flood sweep my family members away for front of my eyes," Kalpana Malla from Nepal Nuwakot district tok.
She say di flood clear her father, mother, sister and her sister children were all swept away.
"Dem no fit escape di flood; no chance at all," she tok. "Dis flood take evritin except my son and I climb di rooftop of a house and survive but I no fit explain how."
Her son, Sugam Malla, say im pull im mama hand to save her.
Anoda woman, Goma Pandit, tok say she lost her buffaloes and all her oda cattle.
"My farmland don go. Ten sacks of mustard seeds, tons of corn and rice paddy evritin don go. Nothing remain."
Nepal Army tok-tok pesin Rajarm Basnet tell BBC say efforts dey go on to rescue 115 pipo from di village of Mailung.
Nepalese Ministry of Home Affairs huge loss of life go likely dey for Timure, Syabrubesi and Betrawati. Flooding don also cause damage to di Trishuli hydropwer project.
Di extent of di damage on di Tibetan side ineva dey clear but BBC tok to Guan Daoxuan for Sichuan province wey tok say im lost contact wit im wife on Wednesday morning.
Nepal disaster management authority don ask pipo wey dey live near river banks for vulnerable areas to remain alert and take precautions.
Nepal Foreign Affairs minister Shishir Khanal tell parliament say 26 police personnel, nine armed police officers and 44 members of di military dey miss.
E say one earthquake at 08:37 local time bin trigger one avalanche and preliminary information say na wetin cause di flash flood.
Rasuwa bin see deadly flooding last year wey kill 18 pipo afta one glacier burst on di Chinese side of di border.















