Fotos of how wildfires dey burn across France and Spain as ova 260,000 pipo run for safety

    • Author, Cachella Smith
    • Author, Tara Mewawalla
  • Published
  • Read am in 4 mins

Wildfires don continue to rage for France and Spain, as authorities don evacuate hundreds of thousands of pipo from dia homes.

Firefighters dey struggle to contain di wildfires wey dey burn for France and Spain, and dem say dem neva fit put am under control.

Almost 200,000 dey displaced for France alone, according to di kontri Interior Ministry, Laurent Nuñez tok.

E dey come afta dem evacuate almost 60,000 pipo from di towns for Bordeaux's western suburbs overnight - di latest in a series of evacuations wey dey affect Gironde and Landes regions.

Di towns wey dem move dem from na Saint-Médard-en-Jalles, Saint-Jean d'Illac, Martignas-sur-Jalles, and Saint-Aubin de Médoc, wey togeda get population of 58,400 residents.

Local prefect Sophie Brocas describe di Gironde blaze as an "XXL fire", wey don burn through more dan19,000 hectares (46,000 acres) of forest and destroy about 80 homes.

Meanwhile, di figure don rise to more dan 70,000 for Spain according to Francisco Martín, di Spanish govment representative for Madrid region tok.

Spain govment don declare national emergency, and dem don tell 25,000 pipo to evacuate and almost 40,000 told to stay indoors.

Madrid regional president Isabel Díaz Ayuso don describe am as di "worst fire for di history of di region", as di area dey face "perfect storm" of high temperatures, relentless wind and merging fire fronts.

For Spain, local emergency services tok say di wildfires dey move towards di municipalities of Robledo de Chavela and Fresnedillas de la Olivia, around 50km (31 miles) from di capital.

"Di wildfire dey for its peak and e currently don pass di power of firefighters to contain," Carlos Novillo, di Madrid regional govment emergency management chief, tell tori pipo.

"E no dey possible to attack di fire for dat area, so dem dey take defensive measures," e add.

Wia di wildfires dey burn for Europe

Wildfires don continue to spread across Europe as one exceptionally hot summer and dry conditions don create perfect conditions for fires to spread.

Dis na wia major fires don break out:

France: Dem don evacuate nearly 200,000 pipo for di south-west of di kontri for Gironde and Landes regions.

Spain: Spain don declare national emergency and don evacuate at least 60,000 pipo as fires burn near di capital Madrid.

Italy: More dan 350 fires - wey include 10 major blazes - bin break out on di island of Sicily, di head of di Sicilian Civil Protection tok wey lead to evacuations.

Scotland: Emergency services don declare major incident as dem continue to tackle wildfire wey dey burn for Cairngorms National Park for more dan 10 days now

Extreme conditions across southern Europe

Di European Union don deploy aircraft and helicopters to support firefighting efforts for Spain and France, as most part of southern Europe grapples wit repeated heatwaves and prolonged drought.

Italy report wildfires dis week, and Sicily na one of di worst affected areas wia one firefighter died as e dey tackle di outbreak.

Europe na di fastest-warming continent, e dey hot twice more dan global average since di 1980s, according to EU Copernicus Climate Change Service.

Wildfires don burn more land for Europe already dis year pass di annual average for di past two decades, according to di European Forest Fire Information System.

Di European Environment Agency say "climate change don increase forest fire risk across Europe", wit di greatest danger expected for southern Europe.

Fotos of di wildfires

Get in touch

Are you in an affected region? If it’s safe to do so, get in touch.