Wike, Soludo, Adeleke and Amosun make list of APC presidential campaign council - who else dey?

Wia dis foto come from, Charles Chukwuma Soludo, Nyesom Wike, Ademola Adeleke, Senator Ibikunle Amosun/Facebook
Osun State govnor Ademola Adeleke and former govnor of Ogun State, Ibikunle Amosun dey trend sake of say dem dey for di All Progressives Congress (APC) presidential campaign council list.
Di All Progressives Congress release names of dia campaign team on Tuesday and dem go do di inauguration on Wednesday 13 October, 2026.
Some of di pipo wey dey di list wey dey cause tok-tok na di Federal Capital Territory (FCT) Minister Nyesom Wike wey dem appoint as di campaign coordinator for President Bola Tinubu for Rivers State and di FCT.
Na since di former Rivers State govnor declare im intention to support President Tinubu di way im bin support am for di 2023 presidential election.
Osun State govnor, Ademola Adeleke na di campaign coordinator for Osun State.
Di announcement of Ademola Adeleke no be surprise for di list, di former senator bin don declare afta e im win re-election say im go support president Bola Tinubu for di 2027 election too.
Im bin pledge im support for Tinubu wen im bin go visit am for di Presidential Villa to tell am " thank you".
When Nigeria President Bola Tinubu meet di Govnor of Osun State for di Presidential villa afta e collect im certificate of return e tell am say make im no make any single individual di victim of im campaign.
"You no conquer anybody. Na election you win. Na di essence of democracy".
Oga Tinubu say make Adeleke go celebrate im victory so dat Osun pipo go dey happy wit am.
"No make a single individual di victim of your campaign all for di reconciliation, expand your coast na di only way you fit give tanks to Osun pipo. No be di way you celebrate am but di way you act am."
Full of APC campaign
Oda ogbonge pipo for di list include Anambra State govnor Charles Chukwuma Soludo wey be di campaign coordinators for Anambra State.
Senator Ibrahim Dankwambo and Obafemi George na campaign Council Advisers na dem go dey advise on media.
Deputy Speaker Benjamin Kalu na di Deputy Director General (South II)
Rivers Speaker Martin Amaewhule - South-South Deputy Coordinator for State Assemblies mobilisation.
Minster of Works David Umahi - Deputy Director General (Infrastructure and Sensitization).
Delta State Governor Sheriff Oborevwori na di Director of Finance.
Governor Dapo Abiodun of Ogun State and Nigeria Revenue Service (NRS) Chairman Zacch Adedeji na fundraising coordinate.
Aviation Minister Festus Keyamo, House of Representatives member wey dey represent Kiru/Bebeji Federal Constituency of Kano State, Abdulmumin Jibrin; FCT Minister Nyesom Wike media aide Lere Olayinka; and Segun Sowunmi.
All oda dem dey for di list for media communications.
Odas na former Super Eagles captain, Joseph Yobo wey be di Deputy Director for Sports Sector Mobilisation.
Ayiri Emami na di Director for Special Duties.
Former Kano govnor, Abdullahi Ganduje - Director for Stakeholder Mobilisation.
Former Lagos govnor Babatunde Fashola na South West Zonal Coordinator for Stakeholders Mobilisation.
Senator Abdulaziz Yari go continue to lead as Director-General of di re-election campaign.
Senator Adams Oshiomhole na Deputy Director-General wey dey in charge of Mobilisation.
Femi Gbajabiamila na di Deputy Director-General for Administration.
Govnor Hope Uzodimma of Imo State dey continue as Secretary of di Campaign Council.
APC National Secretary Ajibola Bashiru and former Managing Director of di Nigerian Ports Authority (NPA), Hadiza Bala-Usman na Deputy and Assistant Secretaries.
Minister of Solid Minerals Development, Dele Alake, go continue im role as tok-tok pesin for di Campaign Council.
Lawmaker James Faleke na Deputy Director-General for Election Planning, Coordination, and Monitoring.




















