You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Why Isa Patanmi, Adebutu and odas dey miss from Inec governorship candidates list
Di Independent National Electoral Commission (Inec) don debunk one tori wey dey circulate for social media on top issues wey affect di list of governorship candidates for six states, wey include, Zamfara, Gombe, Delta, Plateau, Yobe, and Kano.
According to di tori, di electoral body don drop one special announcement on top di govnorship candidates wey dia names no make di final govnorship candidates list for di 6 February 2026 election, wey di commission release ova di weekend.
Di commission for one statement on dia official X account on Monday, 12 October make am clear say, dem no make any special announcement, say make pipo ignore di report.
"Di commission wish to categorically inform di general public say di publication na FAKE and e no originate from Inec," di electoral body tok.
Dis clarification dey come afta di names of some prominent governorship candidate for di opposition parties wey include Isa Pantami and Ladi Adebutu of di Peoples Democratic Party (PDP), di govnorship candidates for Gombe and Ogun states, plus Aminu Abdussalam Gwarzo of di Nigeria Democratic Congress (NDC) for Kano state fail to make di list.
For di statement, Inec no tok why dem comot di names of some of di candidates, howeva, BBC don reach out to dem for comment and dem say dem go soon respond.
Di commission tok say di list wey include dis states; Zamfara, Gombe, Delta, Plateau, Yobe and Kano, "no originate from Inec."
Dem ask Nigerians to verify evri informate from dia official website and social media pages to "avoid false or fraudulent publications.
Some of di governorship candidates wey dia names no dey on INEC final governorship list on Sunday don react.
Who be di govnorship candidates wey no make di list
Ogun State: Oladipupo Adebutu - PDP
Following di release of di list, Adebutu don assure im supporters say im still be member of di PDP party and im go pursue di issue through di appropriate channels, as e call on Inec to respect di electoral process for im eligibility as PDP governorship candidate in Ogun State.
"We go pursue dis mata through di appropriate channels and insist say make due process dey respected".
PDP say na all di names of dia candidates wey go participate for di coming elections dem submit give Inec officials.
Gombe State: Isa Pantami - PDP
Isa Pantami, di PDP govnorship candidate for Gombe state for im reaction tok say di omission na temporary challenges and na normal part of electoral process. E make am clear say dat no be di final determination.
Suleiman Mohammed, tok-tok pesin to di former minister of Communications allege say dem dey aware say na some pipo dey work behind di scene to frustrate good and responsible leadership for Gombe State, but dia legal and liaison teams don dey engage wit di party leadership and Inec to ensure say dem rectify am.
Also, PDP tok-tok pesin Jungudo Haruna Mohammed tell di candidates say dem don engage wit Inec to try resolve di issue of di omission of dia names from di final list of candidates wey go contest for di 2027 governorship elections.
E assure all di candidates say dem dey treat dia concerns wit "utmost seriousness and go communicate further developments as appropriate."
Kano Sate: Aminu Abdussalam Gwarzo of Nigeria Democratic Congress (NDC)
For di NDC govnorship candidate Abdussalam Gwarzo wey im name miss for di list, di party tok-tok pesin Habibu Mohammed say di omission na great concern among di party supporters, but dem believe say na administrative error na from Inec.
"We dey shocked, becos we believe we no get any issue or any pending court judgement, we believe na administrative error," e tok.
"We go engage Inec and we dey certain say tins go work out becos we no get any reason to feel otherwise."
Wetin di Nigeria law tok about party members registrations on Inec portal
On 24 September, Supreme Court restore Section 77(5), 77(6), 77(7) and 84(2) of di Electoral Act 2026 wey di Court of Appeal don declare unconstitutional for July.
Under Section 77(5), only party members wey dia names appear for di membership register wey di party submit to INEC within di period dey eligible to participate for party primaries, congress and conventions.
Section 77(6) tok say political parties suppose use di register wey dem submit for dia primaries. But Section 77(7) tok say any party wey no submit dia register within di time dey ineligible to field candidates.
Wen BBCNewsPidgin reach out to Inec tok-tok pesin Adedayo Eriye Oketola, e tok say di commission dey handle di matta at di moment.
"Later we go issue statement on di matta but now we still dey handle di matta," e tok.
Full list of govnorship candidates Inec approve for 2027 elections
Di All Progressives Congress (APC) govnorship candidate for di 2027 election for Rivers State don get clearance from di Independent National Electoral Commission (Inec).
Inec clear Kingsley Chinda for di 2027 govnorship election for Rivers State, south-south, Nigeria afta dem include im name for di list of govnorship candidates wey dem release on Saturday night.
Inec publish di names of govnorship candidates for all di political parties wey go contest for di 2027 elections.
Kingsley Ogundu Chinda na di former minority leader of di House of Representatives and na former member of di Peoples Democratic Party (PDP).
Im bin dey represent di Obio/Akpor Federal Constituency from 2011 t0 2019.
Kingsley Chinda name begin trend months ago wen im emerge as di govnorship candidate for di All Progressives Congress (APC) for Rivers State wen di public bin know am as member of di Peoples Democratic Party.
Nigerians begin ask question about wen im port join di APC and weda im still be minority leader for di House of Representatives.
Afta di Supreme Court judgement on Thursday 24 September, 2026 Kingsley Chinda name begin trend again as di Supreme Court judgement restore some provisions of di Electoral Act 2026.
Supreme Court rule on di Electoral Act 2026 provisions wey dey govern political party membership registers and di nomination of candidates.
Di seven-member panel wey Justice Adamu Jauro lead set aside di court of appeal judgement wey bin void sections 77(5), 77(6), 77(7) and 84(2) of di Act.
Dis sections concern di statutory requirements wey relate to political parties membership registers, direct primaries or consensus as methods for di nomination of candidates by political parties.
Sake of dis supreme court judgement, one group Association of Legislative Drafting and Advocacy Practitioners (ALDRAP) ask di Independent National Electoral Commission (Inec) to disqualify Kingsley Chinda as di APC govnorship candidate for Rivers state for di 2027 election.
Di group bin ask Inec to check "di status of di APC govnorship nomination, di applicable membership-register requirements, di records wey bin dey submitted to Inec by di APC, and di appropriate steps wey dey required to give effect to di Supreme Court decision".
Wit all dis tok-tok, di APC for Rivers State tok say 'We no get issues' as dem bin react to di defection of dia candidate Kingsley Chinda.
Wit dis list wey Inec release, e mean say im no get any issue and im go still be di govnorship candidate for APC for di 2027 election.
List of some govnorship candidates state by state
Abia State
Opah Eric Chinemeucheya - APC
Kalu Kalu Agwu - ADC
Ijioma Uchechukwu Charles - APGA
Otti Alex Chioma - LP
Ogah Iroetugo Ndubuisi - NDC
Anosike Kelechi - PDP
Adamawa State
Modibo Hammantukur Ribadu - ADC
Umaru Babangida Bajabure - ADP
Amini Ahmed Galadima - APC
Ishaku Elisha Cliff - LP
Dahiru Aishatu Ahmed - NDC
Vunobolki Maurice Michael - PDP
Akwa Ibom State
John James Akpanudohedehe - ADC
Eno Umoh Bassey - APC
Jimmy Stella Monday - APGA
Mbaba Michael Bush - LP
Enyong Michael Okon - NDC
Brownson Ibanga Akpan - PDP
Bauchi State
Halliru Dauda Jika -ADC
Shehu Jinda Yunusa - ADP
Abubakar Mohammed Abdullahi - APC
Aliyu Idris Muhammed - LP
Kashim Ibrahim Muhammed - NDC
Adamu Usman Ahmed - PDP
Benue State
Hembe Iowase Herman - ADC
Nyimba Kwaghshir - ADP
Alia Hycinth Iormem - APC
Byuwan Mathias Terwase - LP
Shija Terhemba - NDC
Aondoakaa Michael Kaase - PDP
Borno State
Babagana Buhari - ADC
Munguno Rufai Alhaji - ADP
Gubio Alhaji Mustapha - APC
Konto Umar - LP
Ibrahim Sanusi Kashim - NDC
Abba-Gana Ibrahim Baba - PDP
Cross River
Otu Bassey Edet - APC
Obu Ogar Osim - LP
Archibong Arthur Javis - PDP
Joelyn Ita Hogan - Bassey - ADP
Delta State
Ogboru Ovedje Great - ADC
Oborevwori Sheriff - APC
James Esther - LP
Itovwaye Chris - NDC
Mrakpor Peter - PDP
Obuseh Felix Ogechukwu - SDP
Ebonyi State
Ukpai Mbah Udeh - ADC
Nwifuru Ogbonna Francis - APC
Nwodom Lucy Chinwe - APGA
Eze Oko Spledour - LP
Igwe Nwagu Palinus - NDC
Chukwuma Odii Ifeanyi - PDP
Enugu State
Ocho Bodoeze Chukwuma - ADC
Mbah Peter Ndubuisi - APC
Ugwu Okwudilichukwu Chukwudera - LP
Ohaa Chiyeaka Christian - NDC
Nnaji Uchechukwu Geoffrey - PDP
Iloka Friday - SDP
Gombe State
Bala Bello - ADC
Adeh Nuhu Milah - ADP
Gwamna Jamil Isyaku - APC
Muazu Zubairu Halilu - LP
Ardo Babayo Kumo - NDC
Jigawa State
Sabo Mohammed Nakudu - ADC
Sulaiman Ibrahim - ADP
Namadi Umar - APC
Abdul'aziz Aminu - LP
Dutse Aminu Sani - NDC
Sule Mustapha Lamido - PDP
Kano State
Ibrahim Ali Amin - ADC
Muhammed Abdullahi - ADP
Yusuf Abba Kabir- APC
Santuraki Hamisu - LP
Abacha Muhammed Sani - PDP
Hussaini Bello Ado - SDP
Katsina State
Ahmed Baba Kaita - ADC
Ahmed Murtala - ADP
Umar Dikko Radda - APC
Ilu-Barde Aliyu - NDC
Gard Yakubu Lardo - PDP
Kwara State
Zakari Muhammed - ADC
Adeshina Ajisafe - ADP
Yakubu Danladi Salihu - APC
Abdulmunin Yinka Ajia - NDC
Kawu Suleman Bolakale - PDP
Amokanye David Adetoyese - NNPP
Kebbi State
Malami Abubakar - ADC
Yahaya Ayuba - ADP
Idris Nasir - APC
Usman Aliyu - LP
Umar Faruk - SDP
Niger State
Mohammed Kpataugi - ADC
Mohammed Umaru Bago - APC
Mohammed Adamu - APGA
Mohammed Usman - LP
Muhammed Yahaya Adam - NDC
Muhammed Mamman Nami - PDP
Lagos State
Gbadebo Rhodes Vivour - ADC
Hamzat Kadri Obafemi - APC
Odunaike Oluwapemilerin Olurotimi - LP
Doherty Olufunsho Adeshina - NDC
Doherty Adedeji Olugbemiga - PDP
Olaniyi Olufemi - SDP
Ogun State
Lawal Jimi Adebisi - ADC
Anifowose Johncrownfit Kayode - ADP
Adeola Solomon Olamilekan - APC
Ola Williams Adeyinka - SDP
Rivers State
Pidomson Gabriel Baritulem - ADC
Kingsley Ogundu Chinda - APC
Boms Chima Ernest - LP
Lulu-Briggs Dumo Owukori - NDC
Ejekwu Samuel Soni - PDP
Ben-Gurion Peter - SDP
Nasarawa State
Nuhu Angbazo- ADC
Christopher Mamman - ADP
Aliyu Ahmed Wadada - APC
Gaza Jonathan Gbefwi - LP
Emmanuel David Ombugado - PDP
Muhammed Abubakar Adamu - SDP
Oyo State
Adegoke Taofeek Adeboyega - ADC
Alli Sharafadeen Abiodun - APC
Salami Gbolagade Tajudeen - APGA
Kareem Thompson Sola - LP
Yusuf Akim Adebola - NDC
Gbolarumi Hazeem Ola - PDP
Plateau State
Sura John Sunday - ADC
Dawop Sani Sai'du - ADP
Muftwang Caleb Manasseh - APC
Nura Tanko - LP
Ropshik Kefas Wungak - PDP
Sokoto State
Manir Muhammad Dan'iya - ADC
Sarkin Larabawa Nasiru - ADP
Aliyu Ahmed Sokoto - APC
Haliru Abubakar Dikko - LP
Aliyu Shamsudeen Ahmad - NDC
Abdullahi Sokoto Abubakar - PDP
Taraba State
Abubakar Umar Tutare - ADC
Mamman Abubakar Mustapha - ADP
Kefas Agbu - APC
Shiddi Danjuma Usman - APGA
Nathan Sanda - LP
Yahaya Mohammed Sani - NDC
Bwacha Emmanuel - PDP
Yobe State
Kassim Gaidam - ADC
Mohammed Nasiru Saleh - ADP
Wali Baba Mallam - APC
Kolomi Aji - LP
Ibrahim Mallam Shuaibu - NDC
Usman Abdullahi - PDP
Zamfara State
Aliyu Bashir - APGA
Yusuf Sani - LP
Marafa Kabiru Garba - NDC
Shehu Gusau Ibrahim - PDP
Musa Hamza - SDP