Harry Kane two second half goals send DR Congo comot from 2026 World Cup
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, England captain, Harry Kane wild celebration as e score against DR Congo
Published
Read am in 7 mins
DR Congo troway dia early lead as dem lose 2-1 to England for di Round of 32 of di 2026 Fifa World Cup.
DR Congo score as early as di seventh minute but dem fail to find di net again sake of dia missed chances and too much defensive play.
DR Congo bin tink say dem don win dis match bifor England captain Harry Kane score two second half goals to beat DR Congo.
England Coach Thomas Tuchel make some beta changes wey add fire, quality and momentun for di game.
As e be so England go face host Mexico for di Round of 16.
Match Highlights
Second Half
Full Time England 2-1 DR Congo
90+6 Match don end like dis.
90+6 Joan Wissa play am but e go over di bar.
90+6 Freekick for DR Congo, na dia last chance to score be dis.
90+4 Match dey go on as DR Congo dey find equaliser.
90+3' Injury just dey happun upand down , first na DR Congo player fall dey hold im leg, now Harry Kane don fall for ground dey hold im leg too.
90' Referee add 6 minutes
89' SUBSTITUTION for DR Congo, Joris Kayembe don enta for Arthur Masuaku.
England 2-1 DR Congo
86' DR Congo goalkeeper Mpasi bin save di shot wey England player Jude Bellingham play as e push di ball outside but anoda England player pick di ball pass am to Harry Kane wey fire shot inside net.
86' GOALLLLLLLLLLLLL for England! Harry Kane again!
84' DR Congo player Elia Meshack strike but e no disturb Pickford wey be England goalkeeper.
81' DR Congo need to find goal by any means if dem wan stay for di World Cup but England def dey play noe-two touches to slow di game down.
79' England player fire shot as e target di top right corner but di ball go wide over di bar!
78' Game don change, England and DR Congo don begin double up for attack and defence.
75' England 1-1 DR Congo
75' Bukayo Saka pass to Eberechi Eze , wey pass am to Declan Rice wey pass am to Anthony Gordan wey later pass am to Harry Kane wey score.
75' GOALLLLLLLL for England!!!!!!Harry Kane!!!!
73' Freekick for England again, dem play am but DR Congo defence stand gidigba.
73' Cornerkick for England dem playam but DR Congo defence clear di ball.
72' Thomas Tuchel wey be England coach dey bring all im attackers becos e dey find goal.
71' SUBSTITUTION for England. Eberechi Eze don replace Djed Spence
71' Match don start.
71' Players don dey return too di field.
68' Water break! Referee give only 3 minutes.
66' England player bring DR Congo player Wissa down as e pull im shirt, referee blow foul , give DR Congo freekick.
64' SUBSTITUTION for DR Congo, Nathanael Mbuku don comot Meschack Elia don enta.
61.SUBSTITUTION for England,Marcus Rashford and Noni Madueke don comot, Anthony Gordon and Bukayo Saka don enta, wetin dem fit do? Make we dey look.
60' Freekick to DR Congo wey give dem chance to hold di ball now.
59' England no wan release ball since o but Cipnga of DR Congo tiff di ball give Wissa but Wissa lose to ball to Harry Kane but e play di ball to hit DR Congo player hand.
57' England dey wit di ball dem dey try slow down di game to force DR Congo to comeout.
54' DR Congo dey defend wetin no good as England dey put pressure on DR Congo defence.
53' RASHFORD! England player Marcus Rashforsd drag am wit one DR Congo player but e play di ball enta side of di net.
50' Corner to England dem play am but DR Congo tiff di ball.
50' Masuaku of DR Congo use head clear di ball wey England play.
47' England pass di ball as second half start, na dem still hold di ball now. Dem still dey find chance to score but Mpasi , DR Congo goalkeeper nod di attempt out again.
46' Players don return to di field, match don start.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Brian Cipenga celebrate goal e score against England for di 7th minute
First Half
Half-Time England 0 -1 DR Congo
45+6 Referee don blow whistle, first half don end.
45+6 SAVE for DR Congo! Harry Kane fire beta shot from di corner kick wey England play but DR Congo goalkeeper Mpasi save di ball again.
45+6 Na di final minutes for first half be dis , England get one last chance to attack wit dia corner kick.
45+4 Throw-in for DR Congo wey hold ball now, dem dey run go England area but England player stop di ball.
45+ 2 SAVE! for DR Congo! Mpasi wey be DR Congo goalkeeper save beta ball from Jude Bellighnam again as e use one hand save di ball wey wan enta net. Di ball nearly enta net!
45+2 England dey hustle di ball to score but no way!
45' Referee don add 6 minutes
45' Match don continue.
45 VAR CHECK! VAR no waste time sef wen dem conclude say no be penalty.
44' Dem dey call for penalty but Referee say na dive no be penalty.
44' Harry Kane of England dey find penalty afta e dive fall for di 18 yard box as e bin collide small wit DR Congo goalkeeper.
43' MISS for DR Congo! Joan Wissa miss clear chance to give DR Congo di lead.
41' DR Congo dey hold ball now but England donn collect am.
40' Cornerkick for DR Congo dem play am and dem dey try use am drag England oujt from dia goal area.
38' England play di freekick but e land for DR Congo player leg wey clear di ball.
37' Freekick for England afta DR Congo player pull Marcus Rashford of England down afta e bin dey make beta run towards goal area.
36' Noni Maueke of England and Marcus Rashford try dem luck too to fire shot but DR Congo defenders block am.
35' Throw-In for England, na dem hold di ball now, dem enta DR Congo goal area but no space to score as DR Congo defenders clear di shot from England.
32' DR Congo goalscorer Cipenga fire anoda shot but dis time e no dey on target.
30' England player Declan Rice head di ball from outside di box but DR Congo keeper jump use im hand push di ball to safety.
27' DR Congo continue wit di pressure, dem get corner kick, dem play am but England escape own goal wit few inches as Declan Rice touch di ball wey almost enta net.
26' Dem don come back from water break an dmatch don resume.
23' Di players don go on water break.
22' Ball possession so far na almost equal even though DR Congo get 45 percent and Englang get 44 percent.
19' YELLOW CARD for England, Jude Bellingham don enta referee book afta e foul DR Congo player wit bad tackle.
18' DR Congo dey put England under serious pressure sotay England don dey play back pass.
14' Corner kick for England, Declan Rice play am but di ball too long e just dey roll comot from field.
10' England still dey try to settle down for dis match.
England 0-1 DR Congo
7' Cipenga of DR Congo fire di shot wey Mbemba give am from outside di box wey beat England goalkeeper enta net.
7' GOALLLLLLLLLLL for DR CONGO!
4' Harry kane of England pass ball to Noni Madueke wey dey near DR Congo goal area e dribble players but e no see space , e pass di ball back to Kane wey pass am to Rashford wey fire di shot ut DR Congo goalkeeper catch di ball.
2' England hold ball for di first minute but DR Congo don collect di ball
1' Match don start
Wia dis foto come from, Lars Baron, Mattia Ozbot via Getty Images