Why Cambridge youngest black professor resign?

One man wit dreadlocks dey smile for di camera as e sit for one wooden bench

Wia dis foto come from, Faculty of Education / Jason Arday

Wetin we call dis foto, One foto of Arday wey dem release wen dem appoint am as professor for Cambridge
    • Author, Caitlin Doherty
    • Role, BBC News
  • Published
  • Read am in 6 mins

One University of Cambridge professor for di centre of one plagiarism row don resign wit "immediate effect".

On Wednesday, 5 August, di university say dem don launch investigation into Professor Jason Arday "afta new information" about im "academic qualifications and honorary appointments".

Arday – wey bicom di university youngest ever black professor for 2023 – don admit errors for im work, but say im don face " face serious public criticism and personal attacks wey no dey stop, and e say "im no be liar".

Dis dey come afta series of media reports wey question some of im achievements plus accuse of plagiarism for im PhD thesis.

Arday say im don "conclude say di only way to close dis chapter na to step away".

For di statement wey di Good Law Project bin post on Wednesday, Arday say di appointment wey dem give am as professor "without any question, na di greatest professional privilege of my life".

But e add say: "Time dey come wen di personal cost bicom too great."

E say make nobody interpret im resignation "as a loss of faith in scholarship or for di values wey first bring me come Cambridge.

"Or mistake am to mean say I don accept all di narratives wey surround me." mistaken for an acceptance of the narratives that have surrounded me."

Thanking im students and colleagues, e say "for my own wellbeing, for my family, and for dos wey stand by me throughout dis difficult period, I don conclude say di only way to bring dis chapter to an end na to step away".

Arday say "dis no be di end of my work" and e say im need "time to heal".

"Wen dat time come, I go return," e add.

Wetin Arday dey accused of

Na Nathan Cofnas – one US researcher and self-defined "race realist" first raise alarm and accuse Arday of plagiarism for im work.

Dem bin terminate Cofnas appointment afta pipo criticize one view we hold, wen e tok say if under a true meritocracy, black pipo go "disappear from almost all high-profile positions apart from sports and entertainment".

E claim on Substack say im put Arday work through one plagiarism detection software, wey discover say "e lift many passages from oda pipo work, wit small editing, and for some cases, e retain copy-editing mistakes wey dey di original source".

Cambridge initially bin describe di allegations against Arday as "vile campaign to undermine im credibility".

Liverpool John Moores University – wey award am im PhD for 2015 – bin investigate di accuse of plagiarism wey dem raise against im thesis last year, but dem no file any charges against am.

BBC don contact di university for further comment.

Wide shot of one pathway wey lead to Jesus College for Cambridge University on a sunny day.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jesus College, wia Prof Jason Arday na fellow, say dem dey launch dia own process 'parallel' to di university investigation into di professor.

On Saturday, Arday tell di Times for one interview say im dey accountable for dos mistakes, but wetin im no be "na liar".

E tell di newspaper say: "Since e land Cambridge, one very well-orchestrated and co-ordinated campaign dey ground to unseat am from my position."

E suggest say wetin dey happun to am na "racially motivated" and say im don bicom a "lightning rod" for criticism of diversity, equity and inclusion (DEI) policy.

Arday tok say some errors for im early academic work na bicos of im autism, as im bin dey depend on mimicry to understand and process information.

E add say if pipo carry di same kind thorough scrutiny go check oda academics dia work, dem fit find similar mistakes there too.

"We dey tok about academia here. I no kill pesin. I think say di cruelty wey I don experience plus di way pipo dey position me like say I be liar and fantasist dey totally unacceptable," e tell di newspaper.

Cofnas don also question Arday claims say e run 30 marathons for 35 days, and 300 miles for three days for charity, wey Arday tok say don raise more dan £5m for charity.

E also say im run 600 miles on one treadmill for six days.

Arday tell di Guardian say dem raise di £5m wit di help of odas ova one 20-year period but add say im no go mention di name of di pipo as im don sign non-disclosure agreements.

Wen di newspaper ask am about di 600 miles challenge, e say dem actually complete am ova a 12-day period to allow for rest days sake of di "cumulative wear and tear of training" from previous challenges.

E tell di Times say im stand by di oda running records.

"I no fit make pipo believe me," e say. "Nobody dey live dia life wit receipt for evri single thing dem don say or do."

Kehinde Andrews, one black man wey wear dark shirt, square-framed glasses and one black and grey beard, hold microphone.

Wia dis foto come from, Getty Images

Earlier on Wednesday, publisher Simon & Schuster – wey ready to publish Arday memoir later dis month - defend Arday for inside one statement to AFP news agency.

"We dey proud to publish Professor Jason Arday. We don work closely wit am... and fit speak to di professionalism and integrity e don bring to evri stage of di publication," Simon & Schuster tok.

Separately, di Metropolitan Police confam say dem don investigate one journalist ova allegation of harassment afta e email questions to Arday, bifor dem conclude say e no commit any offence.

Police acknowledge say telling di journalist say make e no contact Arday again no be di correct action wey dem suppose take. Dem admit say dat decision fit hinder or frustrate legitimate journalism.

'No benefit for black pipo'

"Di elite universities like Cambridge and Oxford get one particular problem bicos pipo see dem as places wey dey quite harsh, places wey no dey too friendly and na mostly white pipo dey there, so dem wan change dat impression," she tell BBC Today programme.

Stock, wey resign from her post for 2021 for di middle of one campus row on top freedom of speech and her views on gender identity, tok say dis na "watershed" moment.

She claim say universities "bin pretend not to see di gaps, or maybe dem no just see di gaps bicos dem dey hopelessly naive or desperate for good publicity for way wey hide evri oda thought".

But Kehinde Andrews, one academic and author wey dey Birmingham City University bifor, tok say di idea say black academics get advantage bicos of dia racial background no be true.

E tell BBC Today programme say: "Wetin dey happun to black academics, no be say we dey for one place wia evritin sweet and di left-wing universities just love us and dem dey try to promote us. Wetin dey happun na say you go work for one place for 12 years, you go dey very successful, but dem go still fire you. Dat na di experience of black academics.

"For three years now, dem don dey dig through dis mata, dey try prove say some kain conspiracy dey to benefit black pipo. But for me wey be di example dem dey often point to, I fit tok say benefit no dey for black pipo for higher education, e almost dey impossible to get jobs like dat for Cambridge."

Jovan Owusu-Nepaul, wey describe imsef as associate of Arday, tell BBC Newsnight on Wednesday say im see "di whole thing regrettable".

"From di way dem dey treat am and di unnecessary intense attention dem don put on im CV and career for Cambridge University," e no really dey fair. "I also tink say e dey unfortunate say some informate wey don come out about im CV fit no get any truth."

E say e dey "appropriate" to respect Arday request for "a bit of space".