Who be di most wanted terrorists wey Nigerian Army place 60 million naira bounty on

Wia dis foto come from, Nigerian Army/X
Di Nigerian Army say dem go give correct amount of money to any member of di public wey go fit provide credible information ontop di location of most wanted commanders and terrorists of di Islamic State of West Africa Province (Iswap).
Army also say anyone wey get informate on how to gbab di wanted terrorists go collect money up to 60 million naira (around 44,000 US dollars).
Dis wanted commanders na members of Iswap wey dey operate around di Nigeria northeastern Borno State.
Nigerian Army announce dis afta dem carry out offensive operations against Iswap/ISIS terrorists for di Lake Chad region of Northern Borno State.
"During di operations, troops recova several technical devices and oda high-value intelligence materials, including a camcorder used by Iswap terrorists to record propaganda videos and document operational activities.," di Army tok.
Na during dat operation di Army say dem identify di activities of senior Isawp leader wey dey operate for Borno State.
Dem say di equipment wey dem recova from di terrorists help dem trace and identify locations wey terrorists dey operate.
Isawp commanders wey Army dey find
"Forensic exploitation of di recovered devices generate actionable intelligence, wey lead to di identification of locations associated wit terrorist activities as well as identities of several senior Iswap leaders wey dey operate within di Mangari–Metele–Dogon Chukun axis along di fringes of di Lake Chad Basin for Abadam and Kukawa local govment areas of Borno State."
Army identify di terrorists leaders and key operatives as; Abu Musa Al-Mangawi Baa Shuwa – Wali (Govnor of ISIS West Africa Province), im Deputy/Amirul Jaish Muhammad Jidda ("The One-Handed Man") and Hamad Abu Hanifa di Amirul-Fiya of Iswap.
Dem offer 10 million naira for information ontop di location of Muhammad Jidda wey dem identify as di commander of Iswap for Jaish unit.
Dem offer 50 million naira for information ontop di location of IBN Muhammad wey dem identify as di commander of Iswap for Amniya unit.
Oda high ranking members of di jihadist group also dey di list of wanted terrorists wey di Army dey find.
Di Army release posters wit di pictures of di militants wey dem want credible information for dia capture.
Nigerian Army statement tell members of di public to assist security agencies and give dem any information wey dem get on di individuals to help track dem down and bring dem to justice.
"All information wey we receive go dey treated wit confidentiality, and di identity of informants go dey fully protected in accordance wit established security procedures," Army tok.
Di task force of Operation HADIN KAI also warn citizens against attempt to arrest di militant commanders by demsef or hold dem until di arrival of di security agencies sake of di dangers involved.
"Citizens dey strongly advised make dem no confront or attempt to apprehend di suspected terrorists under any circumstances," Army tok.
Dis latest bounty offered by di Nigerian military show how dem dey willing to comot Iswap and Boko Haram insurgents from di Lake Chad basin.
For recent operations, di Nigerian Army don kpai and capture jihadists commanders and dem dey continue to put more pressure on di terrorists.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post









