You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wafcon 2026: Cameroon vs Nigeria quarter-finals preview
Di Indomitable Lionesses of Cameroon go face di Super Falcons of Nigeria for di quarter-finals of di 2026 Women Africa Cup of Nations.
Di ogbonge match wey go decide weda Nigeria or Cameroon go qualify for di semi-finals go happun for di Larbi Zaouli Stadium, Casablanca, Morocco.
Evritin dey at stake for dis match sake of say di winners of dis match wey go progress to di semi-finals go also get automatic qualification for di Fifa Women World.
Di Fifa Women World Cup to happun for Brazil next year and dis na di dream of many African Women football players.
Nigeria Super Falcons na di defendng champions for Wafcon afta dem win di title for a record 10th time for di 2024 edition wey dem play for 2025.
While di Super Eagles struggle to reach dis stage afta dem lose dia opening match 2-3 to first timers Malawi, Cameroon just dey cruise dey go for dia group.
Cameroon win Group D, while Nigeria finish second afta Head -to-Head and goal diference tie breaker wey Caf use decide for Group C afta all of dem bin tie on six points.
Cameroon and Nigeria dey meet for di Wafcon finals for di 14th time, e make am di most-played fixture for di history of di competition.
Nigeria dey play for Casablanca for di first time for dis edition sake of say dem play all dia group matches for Rabat, but di stadium no dey new to dem as dem bin play all dia fivematches for di Larbi Zaouli Stadium last year.
Match stats
Cameroon and Nigeria get plenti history for Women football for Africa. Dem don meet for evri stage of di Wafcon tournament.
Dem bin jam for di group stage, quarter-finals, semi-finals, third-place play-off and final.
Dis na dia second quarter-final meeting, afta Nigeria beat dem 1-0 victory for di quarter-finals for 2022.
For di 13 times wey dem meet, Nigeria win nine for open play and anoda two on penalties. Cameroon win only one while one di oda game end for draw.
For dia first meeting for di centralised Wafcon finals for 1998 semi-finals, Nigeria beat Cameroon 6-0.
Dis go be dia sixth direct knockout meeting between di sides, minus finals and third-place play-offs.
Nigeria and Cameroon don jam for three Wafcon finals, di Super Falcons win all three: 5-0 in 2004, 2-0 in 2014 and 1-0 in 2016.
Di only time Cameroon beat Nigeria for Wafcon na dia 1-0 success for di 2012 third-place play-off.
Dia most recent meeting na for di finals for di 2022 quarter-final for di Mohammed V in Casablanca on 14 July, wen Rasheedat Ajibade score di only goal for di 56th minute.
Nigeria score 33 goals for di previous 13 Wafcon meetings wit Cameroon and concede only six.
Nigeria get eight clean sheets against Cameroon and fail to score only two times – for dia 1-0 defeat for di 2012 third-place play-off and di 0-0 draw for di 2018 semi-finals, wey di super Falcons win on penalties.
Cameroon
Cameroon don reach di knockout rounds for di 12th time for 13 appearances for di centralised Wafcon finals. Di only timendem comot for di group stage na for 2000.
Dem don reach di knockout rounds evritime for dia last 11 tournament.
If Cameroon e go be dia 11th Wafcon semi-final. Dis na also Cameroon 12th direct Wafcon knockout match excluding finals and third-place play-offs.
If Cameroon beat Nigeria e go be dia their third Fifa Women World Cup, dem bin qualify for 2015 and 2019.
Cameroon complete di group stage undefeated for the sixth time for Wafcon finals.
Nigeria
Nigeria go qualify for di Fifa Women World Cup for a record-extending 10th time. Dem don attend evri World Cup since di inaugural tournament for 1991.
If Cameroon beat Nigeria, e go be di first time wey dem go miss di Fifa World Cup qualification, e go also be di first tie wey dem neva at least reach di semi-finals of a centralised Wafcon tournament.
Nigeria na di only team wey don reach di knockout stages at all 14 centralised Wafcon finals.
The defending champions dey target dia 14th Wafcon semi-final appearance.
Nigeria dey appear for dia third Wafcon quarter-final and dem win dia previous last-eight encounters, against Cameroon in 2022 and Zambia for di previous edition.
Follow us for live text update around 6.00pm Nigerian time