Ghana authorities postpone evacuation of citizens from South Africa ova xenophobia afta number increase from 300 to 800

Wia dis foto come from, GHANA HIGH COMMISSION IN SOUTH AFRICA
Ghana authorities don postpone di evacuation of citizens from South Africa sake of xenophobic attacks afta di number of registered Ghanaians rise from 300 to 800 for di last-minute.
Di first batch of 300 pipo bin dey expected to move to di kontri on Thursday 21 May bifor, but di foreign ministry announce say plans don change.
Inside one statement from di ministry, dem confam say dem push di evacuation forward by few days to allow dem to get travel documents for di oda pipo wey bin register later.
"Wit dis new number of pipo, considering South Africa legal conditions like passenger screening, flight permits and odas, we don push di planned evacuation forward," di foreign ministry explain.
Dem add say "dis go allow di high commission to meet di evacuation conditions for all di passengers bifor di flight".
Di statement also add say Ghana and South Africa authorities don gree to make di process quick.
Authorities say di high commission go dey work closely wit di citizens and any oda pipo wey wan join di registered 800 pipo to return home to ensure say tins dey in place for di evacuation.
Even though dem no announce di new date for di evacuation, di foreign ministry assure di citizens say dem go do evritin to make sure say dem be safe.
Local media earlier report say only one pesin show up for di O.R Tambo International airport for di Thursday evacuation but im no find any Ghana official for dia.
"I be barber for South Africa , I even come sleep for di airport on Wednesday night so I go fit get chance for di flight sake of we be plenti, but since I come here, I no find anybodi," di young Ghanaian barber tok Newzroom Afrika.
Im add say, "I dey stay for di kontri wey I dey use passport to operate barbershop wey I bin dey renew my asylum permit evri three months."
"But wen di Ghana govment tok say dem go carry us comot hia sake of di tins wey dey go on, I decide to join."
Since early April, foreigners for di kontri dey face harassment and threats from vigilantes and anti-immigration groups.
One of di groups March and March bin accuse di foreigners say dem collect dia jobs wey dem dey involved for crime.
Dem say all foreigners gatz comot dia kontri, so di locals fit get jobs and oda opportunities.

Wia dis foto come from, MAYOR MDUDUZI MYEZA/FACEBOOK
Anti-immigration protests dey happun since early April
One Ghanaian wey go viral afta some protesters harass am wey dem demand im immigration documents wen im dey work for im shop, spark international concern.
Ghana authorities raise alarm about di incident wey dem condemn di harassment of di citizen – Emmanuel Asamoah wey dey do legal work for di kontri at di time.
Ghana foreign minister Samuel Okudzeto Ablakwa describe di incident as "unacceptable" wey im demand investigation by South Africa authorities.
Di govment since dat time don repatriate Emmanuel Asamoah to Ghana wey dem offer am job to start im life all ova again.
Ghana petition di African Union to discuss di issue of xenophobia for South Africa for dia mid-year coordination meeting wey go happun for Egypt for June.
Nigeria authorities also bin raise alarm about attacks on dia citizens for di kontri wey dem also begin to register pipo wey wan comot di kontri.
Oda kontris like Angola, Mozambique, Kenya, Ethiopia, Malawi, Lesotho and Zimbabwe don issue advisory to dia citizens to stay away from protest areas and keep safe as South Africans continue to dey protest for streets.
South Africa President Cyril Ramaphosa condemn attacks on foreigners for im kontri but im deny say di kontri be xenophobic.
Im tok say even as di kontri gatz investigate di mata of harassment and attacks on foreigners, dia govment gatz deal wit di issue of illegal immigration and undocumented foreigners wey dey scata di kontri.
Ramaphosa say di plenti undocumented foreigners for di kontri dey put pressure for di small resources for di locals for some communities.
Despite dis, di United Nations (UN) and oda groups still dey call on South Africa to protect foreigners from attacks, in line wit di African Charter on Human and Peoples' Rights.
Protests happun for Durban, Pretoria, Mthatha, Johannesburg and oda cities across di kontri wey dem still dey happun.
Di vigilantes and anti-immigration groups say dem go continue to protest till di end of di year.
In fact, Ghana High Commissioner to South Africa Benjamin Quashie say di African ambassadors network dey go to court to ask di mayor of di Estcourt to return di keys wey im seize from foreign shop owners for im municipality.
According to di high commissioner, di mayor Mduduzi Myeza carry di keys wey im seize from more dan 25 foreign shop owners to di locals say make dem operate di shops.
"Di mayor also give di foreigners 21 days to pack out from di area, we tink say wetin di mayor bin dey do be illegal."

Wia dis foto come from, GHANA HIGH COMMISSION IN SOUTH AFRICA
'Govment go give di repatriated citizens some financial package'
Di foreign affairs minister oga Samuel Okudzeto Ablakwa say di Ghana govment go offer wetin im describe as "welcome home financial package" for di pipo wey dey evacuated to Ghana.
Im also announce oda tins for di citizens as dem arrive for di kontri.
Di govment go provide "transportation assistance" for dem to dia various locations across Ghana.
Dem also dey entitled to wetin di foreign minister describe as "re-integration allowance" as well as free psychological support.
Di govment agencies also go put dia names inside one database for jobs and oda start-up opportunities, so dem go fit apply for jobs.
Dis plans na to re-integrate dem for di society afta dia return from dia business and oda tins dem bin dey do for South Africa bifor.
Pipo don already begin dey demand full disclosure about di financial commitment wey di Ghana govment dey pump for dis whole project.
But for authorities, dem say di immediate focus be to remove di Ghanaian citizens from danger and attacks, di oda tins go follow afta.










