ICC go kontinu to dia work despite Burkina Faso, Niger and Mali withdraw from International Court

Wia dis foto come from, EPA
Di International Criminal Court (ICC) don react to di decision wey Burkina Faso, Mali and Niger take to pull out from di international court.
Di Presidency of di Assembly of States Parties to di Rome Statute, respond to di steps wey di govments of Burkina Faso, Mali, and Niger take for dia withdrawal from di Rome Statute.
"Di treaty establish International Criminal Court ("ICC"), don take note of di situation wit concern.
Di Presidency regret dis developments. Decisions by States Parties to disengage from di Rome Statute risk to undermine di collective pursuit of justice and e weaken global efforts to end impunity.
Im tok say di ICC stand for di heart of di international system of accountability, and e effectiveness depends on sustained and unequivocal support from di international community. Di strength to pursue justice go only get strength through unity of purpose.
Di Presidency dey urge Burkina Faso, Mali, and Niger to remain for di ICC make dem dey committed to States Parties to di Rome Statute and to continue to engage constructively within di framework of di Assembly of States Parties.
Di Presidency add say all States Parties dey entitled to raise dia concerns within di Assembly and im dey encourage Burkina Faso, Mali, and Niger to all dem to do meaningful tok-tok on dis mata.
According to di Presidency weda di three African kontris withdraw from Rome Statute no remove dia responsibility as State Party wey arise during di period wey dem be Party to di Statute.
Di President add say Burkina Faso, Mali, and Niger don contribute to di collective work of di Assembly of States Parties in support of di International Criminal Court wey be independent and impartial judicial institution.
Wen dia withdrawal go take effect
According to di Public Affairs Unit of di International Criminal Court ICC response, dem refer to Article 127(1) of di Rome Statute, wey state say di withdrawals go take effect one year afta di date wey dem receive di notice of withdrawal.
Di ICC tok say even though to join or comot from di treaty na sovereign right and decision from di kontri under international law, dem dey always regret any decision to comot from di collective effort to end impunity for di most serious international crimes.
Dem add say until di withdrawal take effect afta one year, Burkina Faso, Niger and Mali still dey fully bounded by dia obligations as State Party.
Dem also make reference to Article 127(2) wey tok say even afta di withdrawal take effect, di States wey comot still remains bound by obligations wey dem bin dey do wen dem bi members.
"Withdrawal no affect any pre-existing cooperation obligations wey arise from criminal investigations or proceedings wey bin don start bifor di withdrawal take effect, and e no prejudice in any way di continued consideration of any mata wey already dey under consideration by di Court prior to di date on which di withdrawal go take effect. We hope say we don inform you sufficiently."
Tori be say June 2026, Niger officially submit request to withdraw from di International Criminal Court (ICC), nine months afta dem announce dia intention to comot.
For September 2025, Niger wit dia allies Mali and Burkina Faso - wey all of dem dey under military rule - bin issue joint statement to say make dem no recognise dem as ICC authority.
Dem call am "instrument of neo-colonialist repression".
Di court bin acknowledge say dem receive di "instrument of withdrawal" on 18 June, according to one statement wey tori pipo AFP news agency see.
Statement by the Presidency of the Assembly of States Parties on the withdrawals from the Rome Statute by Burkina Faso, Mali, and Niger.
Di ICC dey base for The Hague for Netherlands na for 2002 dem bin set am up to pursue cases of genocide, crimes against humanity, war crimes and aggression.









