Rescue operation dey go on as Guinea rubbish landfill collapse kpai 30 pipo

Rescuers use an excavator to comb through a mountain of scattered rubbish at a major waste site in Conakry, Guinea, as local residents gather nearby. Photo: 23 August 2026

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Fears dey say di death toll fit rise further as some pipo fit still dey buried under di rubbish
    • Author, Jaroslav Lukiv
  • Published
  • Read am in 3 mins

At least 30 pipo don kpai afta mound of rubbish for one major waste site collapse onto nearby homes for Guinea capital Conakry, di govnt tok.

Anoda 22 pipo injure, including six seriously, for di city Dar-es-Salam area.

"Significant" resources and personnel - including di military - bin dey deployed to search for survivors afta di collapse at about 02:00 local time afta heavy rain overnight, di govment added for one statement.

One woman tell local media say her five children bin kpai for di disaster. Fears dey say di death toll fit rise further.

Dem later see rescuers dey use to search through mountain of scattered rubbish for di site as local residents gada nearby.

Guinea Prime Minister Mamadou Oury Bah bin visit di scene to assess di situation and oversee di search efforts.

Neighbourhood leader Lancine Sylla bin earlier tell di AFP news agency say e fear say di death toll go plenty.

"We don pull out 18 bodis wey dem take to di morgue," e tok.

Anoda landslide for di site kpai 10 pipo for 2017.

We dey update dis tori