'Dem put gun for my head rob me' - returnees share experiences and wat next as 83 more Nigerians arrive from South Africa

Wia dis foto come from, @nidcom_gov/X
Nigeria don finally welcome di 83 citizens wey dem repatriate comot for South Africa sake of di anti-immigrants wahala.
Di group of 83 Nigerians arrive for Lagos on Wednesday night, as concern still dey grow ova protests against illegal migrants .
Di new batch of returnees na private individuals bin pay for di flights and not di govment, according to wetin di Nigeria foreign ministry tok.
Meanwhile, di Nigerian govment don do about five batch of evacuations of Nigerians wey dey willing to comot from South Africa.
Di govment voluntary repatriation programme officially end for July 2026 afta dem arrange five batches of flights under di evacuation programme wey bringing more dan 1,500 Nigerians back to di kontri.
And na only Nigerians wey bin register to leave South Africa dey included for di programme.
Nigerian govment say di flights wey evacuate di previous returnees na through public funds and di returnees no pay for dia journeys.
Howeva, e still get some Nigerians wey still dey for South Africa as more threats dey mount ontop undocumented migrants to comot.
But as di March and March group don dey ginger for anoda protest against illegal migrants for South Africa, worry dey ova wetin Nigeria go do next as part of plans to bring back more Nigerians wey still dey South Africa.

Wia dis foto come from, Nidcom/X
'Police go come carry some pipo and arrest dem'
Some of di returnees wey land for Nigeria on Wednesday narrate di kain experience wey she get for South Africa.
Dem follow Nigerians in Diaspora Commission (NiDCom) tok on wetin dia eyes see before dey return to Nigeria.
Di young lady say she dey for South Africa for about 13 years wia she dey food for di street.
"I don dey South Africa for 13 years now, I dey street dey sell rice, e no dey easy. During di day, di police go come caryy some pipo and arrest dem."
She say dem don rob her many times for South Africa, while police go come during di day to come arrest pipo.
For her, she dey happy say Nigerian govment come help dem comot for South Africa.
She narrate say for night, dem go rob her at gun point for her head.
"For night, some pipo go come rob, I no fit rememba how many times dey rob me, dem go put gun for my head. E dey tough, na Nigerian govment help us to come back."
Anoda man wey tok afta e land for Nigeria say di experience for South Africa dey tough and e gatz struggle to survive.
Na about 58 adults, 23 children and 2 infants, dey among di new Nigerians wey dem evacuate comot for South Africa.
Wat next for Nigerian govment to comot dia citizens
Wit Nigeria completing dia five batches, serious concern dey ontop wetin go do dose Nigerians wey still dey for South Africa.
Nigeria foreign ministry say private individuals pay for di flights of di new arrivals say dia "generous support enable dia safe return to Nigeria."
Dem don hand dem ova to relevant govment agencies for documentation and profiling bifor dem reunite wit dia families.
Dia return come as South Africa dey face anoda protests ova undocumented migration.
Some groups don call on foreigners without legal status to leave di kontri and dem set 30 September as deadline for undocumented migrants to comot for South Africa.
Officials of di Nigeria Foreign Ministry say dem no fit force pipo comot for South Africa, say na dose wey register to comot dem go evacuate.
But di ministry no give clear tori if dem still organise anoda evacuation programme bifor di September 30 deadline for anoda big protest.
South Africa don see several protests ova immigration dis year, wit protesters wey dey call for tight migration controls for di kontri.
Although di govment don condemn attacks on migrants but e be like say e dey increase but dem add say dem dey also make efforts to enforce immigration laws and tackle irregular migration.
South African authorities say dem don remove more dan 80,000 undocumented migrants from di kontri as part of di measures.










