You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Caleb Yirenkyi late goal give Ghana three points against Panama for World Cup Group L game
Ghana Black Stars begin dia 2026 World Cup campaign wit 1-0 win ova Panama.
Young midfielder Caleb Yirenkyi score di only goal for di 95th minute afta one fine counterattack.
Manchester City attacker Antoine Semenyo begin di drive from midfield wen im pass to substitute Thomas Brandon-Asante.
Di Coventry City striker carry di ball enta di box wey im beat im marker to cut di ball to di middle of di Panama box for Yirenkyi to tap inside di goal.
Dat goal spark wild celebrations for di stadium and viewing centres across di kontri.
Di goal bin sink di hearts of Panama players and dia fans sake of dem bin get plenti possession wey dem get four shots on target - two more dan di number Ghana get.
Referee Glenn Nyberg wey bin add six minutes afta 90 minutes now allow di game to go on for 10 more minutes bifor im blow whistle for fulltime.
Di result mean say Ghana get three points, same as England wey sama Croatia 4-2 for di early game.
Panama bin dey third ontop di table wey Croatia dey last.
Di central American kontri dominate possession wit 62%, four shots on target and five shots off target.
Ghana Black Stars bin soak di pressure for most of di game and try to catch dia opponent for counterattack, na so dem get 38% of possession wit two shots on target and four shots off target.
Carlos Queiroz changes for di second half bin make di difference - wit Thomas Brandon-Asante, Fatawu Issahaku, Kwasi Sibo and Prince Kwabena Adu.
Accra Hearts of Oak keeper Benjamin Asare bin enta di game afta halftime to sub Lawrence Ati-Zigi wey pick up wetin dem sabi as injury.
Di defenders bin dey disciplined for di whole game, wey dem bin contain all di Panama threats.
But afta fulltime, na Ghana bin get all di three points for di bag; kontri wey face plenti controversy and drama ahead of di game.
Caleb Yirenkyi replace Thomas Partey for midfield wey im deliver
Bifor, sabi pipo bin worry and ask who go replace Thomas Partey for di midfield afta im lose di appeal against di visa refusal by Canadian authorities.
Canada immigration officers throwey im visa application as dem tok say im dey face multiple rape charges for di UK na so im no dey "admissible" to di kontri.
Lawyers for di 33-year-old midfielder and Ghana govment bin file appeal to challenge di visa refusal, but di Federal Court for Canada dismiss di appeal wey dem confam say immigration authorities get di right to approve or deny applicants dema visa if dem no dey satisfied wit di documents pesin dey present.
For im absence, 20-year-old Caleb Yirenkyi step up wey im deliver great performance and score di late winning goal.
Ghana coach Carlos Queiroz tok afta di game say "we fight like warriors for dis game wey we win di game wit di brains".
"Di first half na to suffer against ogbonge team and catch dem wit our strategy; I bin dey happy say we win dis game, also I dey happy for di boys," di 76-year-old coach tok afta di game.
Im add say "to win for dis World Cup dey veri expensive, but di boys dey ready to pay di price".
Panama coach Thomas Christiansen dey disappointed afta im team concede di last-minute goal against Ghana.
Im tok say im team bin lack focus for di final minutes of di game wey allow Ghana to score di winning goal.
Ghana go face England for dia second group L match bifor dem wrap up di group stage games wit match against Croatia.
Earlier, two goals by Harry Kane, one from Bellingham and anoda from Marcos Rashford give di Three Lions 4-2-win ova Croatia.