South Africa share point wit Czech Republic wit Mokoena penalty

Published
Read am in 6 mins

South Africa goal wey come from penalty wey Tehobo Mokoena score don give Bafana Bafana life line for Group A.

Czech Republic dominate di game for di first half and part of di second half.

Czech Republic score for di sixth minute and South Africa wait till almost di end of second half bifor dem score through Mokoena penalty.

Di two side get good chances to score more goals but dia defence and goalkeepers balance well for di match.

South Africa get ginger afta dem score as dem bin create more opportunities.

As e be so di group still dey open well-well.

Second Half

Full Time Czech Republic 1-1 South Africa

Match don end

90+7 Last chance for South Africa to score but Czech Republic goalkeeper and defender clear di ball.

90+6 South Africa and Czech Republic dey find di winning goal but di defenders and goalkeepers no dey gree at all.

90+3 Czech Republic get chance to score but South Africa defender run follow di ball to clear am to safety.

90' Referee add seven minutes.

90' Corner kick for Czech Republic, dem play am but South Africa defenders clear di ball from goal area.

88' South African don begin control di game, dem just miss beta chance to take di lead as Czech Republic defender punch di goal bound ball.

86' Game don change wit dis South Africa goal, di two teams don get ginger wit only four minutes to regulation time.

83' South Africa don get lifeline back for Group A.

83' GOALLLLLLLLLLLL! Tehobo Mokoena score di penalty kick for South Africa.

81' PENALTY FOR SOUTH AFRICA afta ball touch Czech Republic defender hand by mistake.

79' South Africa goalattempt for Czech Republic area hit defender go outside di net.

76' Substitution for Czech Republic.

75' Krejci of Czech Republic collect Yellow card as e foul South Africa player Maseko.

74' Czech Republic defence dey do South Africa wetin dey good, dem no wan allow dem score at all.

71' Play don resume afta water break and na Czech Republic hold ball bifor South Africa collect am from dia leg.

68' Dem don go on water break

67' Double substitutions for South Africa and Czech Republic.

64' Freekick for South Africa afta Czech Republic player foul Mudau.

60' Mudau of South Africa bin dey front of Czech Republic goal as e wan play di ball enta net im opponent tiff di ball from im leg but linesman bin don raise flag for offside.

58' Mofekeng of South Africa just escape booking afta e foul Ceric of Czech Republic, di female centre referee just pity am.

57' Di match don dey hot, e be like say South Africa don wake up, dem dey hold ball and distribute ball for di midfield.

55' Double substitutions.Czech Republic do

53' Krejic of Czech Republic head di ball but e go few inches ova di bar.

52' Mokoena of South Africa use all im strenght clear di threat of Czech Republic.

49' Mbokazi of South Africa shot di ball from outside di box but e hit di wall of Czech Republic defence.

47' SAVE! Ronwen Williams, South Africa goalkeeper punch di ball wey dey go straight inside di net as e stop Czech Republic player Darida shot.

47' Czech Republic don start dis half again to hold ball.

46' Match don start, South Africa make some changes as second half dey start.

First Half

Half Time: Czech Republic 1-0 South Africa

45+4 First Half don end

45+4 CHANCE! South Africa get beta chance to score but Czech Republic goalkeeper punch di ball to safety.

45+2 Di match don turn battle of di midfield for di last two minutes.

45' Referee add 4 minutes

45' South Africa captain Tehobo Mokoena collect pass from Mudau but e shot di ball far into di crowd.

43' South Africa hold ball, dem dey play short-short passes wey don lead to corner kick, dem play di corner but di ball land for Czech Republic player leg.

41' Referee give free-kick to Czech Republic but dem play di ball towards di sky.

40' South Africa player don collect anoda Yellow card, referee show Mbatha card afta e tackle Czech Republic player.

37' South Africa miss opportunity to score as Mudau play di ball go side of di goalpost afta beta counter attack.

34' South Africa captain Tehobo Mokoena go miss dia next match sake of Yellow card e collect afta e foul Czech Republic player.

32' Modiba of South Africa run toward Czech Republic goal area , e shoot di ball but Czech defender nod am comot.

30' Czech Republic tiff di ball from South Africa player leg , e run towards goalpost but no space.

27' South Africa resume from di water break wit beta ginger, dem dey worry Czech Republic defence but beta chance neva dey to score.

25' Match don resume

22' Dem don go on water break

22' South Africa neva use di ball possession do anytin for now.

20' South Africa don hold di ball for di last two minutes , dem dey give short-short passes.

18' South African player Maseka dey for ground afta Czech Republic player tackle am.

16' South Africa player Maseko miss one -on-one chance to score for im kontri, e balloon di ball ova di bar.

14' South Africa captain, Mokoena stretch im leg to reach ball for Czech Republic goal area but e miss di ball, e no fit stand up again for some seconds.

13' Corner kick for South Africa , dem just pass di ball to make attempt from outside di box but e no work.

11' South Africa dey dey try to hold di ball but Czech Republic players go always tiff di ball from dia leg.

8' Czech Republic dey pepper South Africa as dem bin make anoda attempt to score but South Africa defender clear di threat.

6' Sadilek of Czech Republic collect beta cross from im teammate, e dribble di South African defender bifor e fire di ball inside net.

6' GOALLLLLLLL FOR CZECH REPUBLIC!

4' Corner kick for Czech Republic but notin come out from am.

3' Game just strat and both team dey hustle di ball possession.

1' Match don start

Line ups

Czech Republic starting 11:Kovar, Holes, Hranac, Krejci, Coufal, Sadilek, cerv,Sojka, Hlozek, Darida, Schick

South Africa starting 11: Williams, Modiba, Mbokazi, okon, Mudau, Mbatha, Maseko, Mokoena, Adams, Appolis, Rayners