Jamb give candidates deadline on admission offer

Published
Read am in 5 mins

Di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) don extend di deadline for candidates wey dem offer admission to either accept or reject am on or bifor Wednesday, 30 September.

Di board bin earlier announce Monday, 31 August as di deadline, but dem extend am so dat all affected candidates go fit take action bifor di new deadline expire.

Di pipo wey fall for dis category na candidates wey Jamb offer admission between 2021 to 2026.

Tok-tok pesin for di board Fabian Benjamin announce di informate for one statement on Saturday, 29 August.

Benjamin say failure to do di needful go attract consequences, e warn.

"Candidates wit pending admission offers, wey neva accept or reject (regular or CUIIA) dey strongly advised to do so before 30 September 2026. Make dem no wait until di deadline, as failure to take action within di time dem give get consequences for di status of such admissions."

Di board also provide guidance for candidates wey no dey study for di institutions wia dem bin first offer dem admissions.

"For candidates wey no dey for di school wia dem bin first gain admission, or wey don change to anoda course wey different from di one wey dem originally get admission for, dem fit accept di admission wey still dey pending. Afta dat, dem go fit apply make dem correct or delete di admission record, depending on wetin concern dia case," Jamb tok.

Also, for candidates wey dey pursue dia second degree now, but still get one old admission offer wey dem neva accept, Jamb say make dem reject dat old admission and continue wit di programme wey dem dey do currently.

Di board also clear am say candidates wey dem offer admission for 2026, but still get previous admission offer to reject am, as doing so no go get any adverse effect on dia 2026 admission.

"Wen di deadline reach, all admission offers from 2021 till now wey candidates no accept or reject go automatically change to "Not Admitted" status. Di admission go remain like that for di board records, unless any dem take any oda official action on top di mata," Jamb warn

Earlier, Jamb bin announce one new policy wey go allow candidates to upload and verify dia O'Level results from house.

According to statement wey di Acting Director of Public Affairs and Protocol, Fabian Benjamin, release, "dis mata na part of di Board renewed commitment to make services to dey easier, faster, safer and more convinient for candidates".

Bifor candidates bin dey requires to go di Computer Based Test centre to upload dia results.

For di Jamb statement, dem tok say, "di verification service go give candidates easier option, especially for times of high patronage and nextwork wahala ofr CBT centres."

Dem bin also require candidates to find dia way go Jamb offices if dem make mistake for di filling of dia subjects.

Howeva for di new arrangement, na Jamb go verify di results wey dem submit directly wit di joinbodi wey dem do di exams.

Oga Benjamin tok say, "di new arrangement go also address di wahala wey dey wit manual O'Level result upliads wey fit include lost or mixed up paper resultss, presentations of unverified or fake results and mistakes for manual entry of subjects and grades".

Di way pesin fit run dis kain parole na to first verify di result den pesin fit come upload di results wey dem verifty.

To verify results pesin go need to

  • Visit di website: BUYRESULTS VERIFICATIONCODE
  • Type in and verify NIN
  • Choose di amount of sittings and exam bodies wey you dey use
  • Include di pesin email address and phone numver dem come click Pay now, wia dem go send you go where you fit pay for di code.
  • Afta di pesin pay, dem go need you to fill three tins wey be, Examination number, Examination series, and Examination year
  • Den you go come verify di resits for di nuber of sittings wey dey selected bifor you go come ask am to give you your verifications code.

Afta pesin don get dia verification code, di next tin na to submit am to fit apply to write di Matriculation exams.

  • Send di word "VERIFY" wit di verification code to one of dis numbers, "55019" or "66019".
  • Di results go dey uploaded and dem go send notification
  • If you be candidate wit two sittings, dem go tell you to visit your profile for e-Facilty.
  • For di e-Facility dashboad, you go enta "2026 UTME O'Level Upload".
  • Na di you go put your own verification code, wey go come reveal your two verified results go show
  • From dia, you go fit pick from di resuts as long as you make sure say e include minimun of five and maximum of nine subjects, and say no subjects dey selected more dan once
  • Dem you go come click di button, "Apply di O'Level Results".
  • Wen e don dey uploaded successfully, you go get notifications say you submission dey successfully.

Wetin e go do for students or di candidates?

According to Oga Fabian, dis new policy na due to feedback wey dem get from pipo wey don run through di exam process bifor.

"As responsive organisation wey dey committed to providing efficient and accessible services, Jamb don arrangle di verification caididates O'Level results directly from di various examination bodies wey dey run di Senior Secondary School Certificate Examination (SSCE)., we go start wit di West African Examinations Council (WAEC)", dis na according to di statement from Oga Benjamin.

Di statement add say, "dis one mean say, candidates go now fit to upload dia O'Level results from di comfort of dia homes as na di Board go run di verification of dat kain results directly to di issuing examination bodies.

"By using technology to reduce unnecessary visits go CBT centres, ques and manual processes dem, Jamb dey make candidate ease of service to dey for di centre of im operations."

So wetin e mean be say, di results go now dey directly verefied by Jamb wit di exam bodi wey di candidate write bifor dem put am for di candidate profile.

So far, tori comot say di Board bin find about about 1,600 fake results for di 2023 exams wey make em bring up di No Verification, No Admission policy for Direct Entry students.