Trump say US go hit Iran 'veri hard' tonight and threaten to take Kharg Island - wetin to know about Iran major oil hub

Wia dis foto come from, BBC, Mandel NGAN / AFP via Getty Images
US President Donald Trump say di kontri go hit Iran "veri hard" tonight.
Inside post on Truth Social, e also vow to "assume total control" of Iran oil and gas markets and to take Kharg Island - wey be major oil terminal off di coast of Iran - for "future wey no too far".
Earlier, three Indian sailors kpai for US strike for one ship, di Settebello, near Oman on Wednesday, while dem hit di Marivex on Monday.
Di US also confam say dem don carry out strike against one third ship - di Guinea-Bissau-flagged vessel Jalveer - as e "violate di blockade" by attempting to transport Iranian oil through di Gulf of Oman.
In recent days, di US don hit military, surveillance and radar sites for southern Iran. Tehran don respond wit strikes on US military sites for di region overnight.
Wetin to know about Kharg Island, Iran major oil hub
Di small island off di coast of Iran na home to major oil terminal wey dey considered di kontri economic lifeline.
On 13 March, di US bin launch strikes on Kharg, and Trump say US forces bin "totally obliterate" evri military target dia. Dem no target di island oil infrastructure, but di president warn of possible further American action.
Taking di island fit choke off Iran oil exports and provide platform for di US military to carry out attacks against di mainland.
Di US fit use di island as leverage to compel di Iranians to keep di strait open.
But, analysts warn say e fit dey challenging and a US landing force gatz move considerable distances, either through naval vessels or airborne forces.
Why Kharg Island dey important to Iran?

Kharg Island na small rocky outcrop just 15 nautical miles (24km) off di coast of Iran.
Despite di size, na one of di most critical pieces of Iran energy infrastructure.
Di US striking dis small but vital island for northern Gulf be like say make dem dey go for Iran economic jugular vein.
Ninety percent of Iran crude oil dey come through one terminal wey dey for di island - dem dey transport am through pipes from di mainland.
Trump don specifically tok say dem fit target dis pipelines, but e tok say e don hold back to avoid long-term economic damage to Iran economy.
"We fit do am within five minutes no. E go dey ova ," Trump tok on 16 March. "Just one simple word, and di pipes go vanish too. But e go take time to rebuild dat."
Veri big tankers - wey fit carry up to 85 million gallons of oil - fit reach di island long jetties to pick di oil.
Di coast of di island close enof to deep water, unlike di coast of di mainland wey dey shallow.
Di tankers go den come back down di Gulf and out of di Strait of Hormuz, to China - di main buyer of Iranian oil.
Dis island, wey get terminal for di export of Iranian oil, dey provide major source of revenue for di Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC).









