NDC senatorial candidate Ovie Omo-Agege escape Delta campaign attack wey allegedly kpai four pipo

Senotor Ovie Omo-Agege wear white cloth wit black cap
Wetin we call dis foto, Senator Ovie Omo-Agege na former Deputy President of di 9th Senate
Published
Read am in 4 mins

Di Nigeria Democratic Congress (NDC) don strongly condemn di kasala and attacks wey dey happun to members of di political party.

Dis dey come afta viral video wey dey fly upandan online show pipo wey get different kain injury on Wednesday for Uduere Community, Ughelli North Local Govment Area, Delta State.

For statement wey di Nigeria Democratic Congress release on Monday night, di party clealy condem di act wey happun to di campaign train of dia senatorial candidate, Ovie Omo-Agege.

For statement wey di National Publicity Secretary, Osa Director sign, e say jaguda pipo attack di campaign train of di NDC senatorial candidate for Delta Central and former Deputy Senate President (DSP) Ovie Omo-Agege.

E allege say di party suspect say di jaguda pipo na agents of di ruling party, di All Progressives Congress (APC).

"Sadly, as at press time, four pipo dey feared dead, including a close aide of DSP Omo-Agege, while several odas sustain different degrees of injuries. Indeed, Omo-Agege narrowly escape assassination."

Di National Publicity Secretary claim say dis na attack against di NDC for di umpteenth time for Delta State.

"Na clear and calculated, and cowardly attempt to silence opposition voices and scare our members and supporters away from di democratic process."

Di party dey call on di Nigeria Police and all relevant security agencies to immediately investigate dis attack and make dem bring di suspects and di pipo wey dey sponsor dem to face di law.

"Election no be war. No life suppose loss for di contest for power."

Police declare curfew for part of Delta State

Meanwhile di Delta State Police don declare 6.00pm to 6.00 am curfew for Ughelli North Local govment area.

Dis dey come afta di reported violence during di campaign rally of di NDC senatorial candidate, Senator ovie Omo-Agege for Uduere Community, Ughelli North Local Government Area.

According to statement wey dey Delta State Police Command release dem say di violence allegedly kpai pipo.

"Di Delta State Govment don impose curfew for Ughelli North Local Govment Area, from 6:00 p.m. to 6:00 a.m. daily until further notice. Di Command dey start investigations to ascertain di circumstances surrounding di incident and identify di pipo wey dey responsible."

Di Police Command dey tell residents to strictly wit di curfew wey dey restrict movement between 6.00pm to 6.00 am until further notice.