Jamb release first set of 2026 results inside hijab controversy and abduction reports

Candidates dey write exam

Wia dis foto come from, Jamb Facebook

Read am in 5 mins

Di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) don release di first batch of results of 632,788 candidates wey write di exam on di first day.

According to Jamb tok-tok pesin, Benjamin Fabian for post on im verified X handle, im tok say, "pipo wey write di exam on Thursday, 16 April 2026, fit check dia results wit di UTME RESULT wey dem go send through SMS to 55019 or 66019 wit di phone number wey dem use during registration.

Candidates fit only check dia result to know wetin dem score but dem no go fit print am."

Jamb cut warning for candidates wey dey tamper wit dia results to stop any mago-mago wey dem dey plan sake of say na criminal offense and if dem gbab any candidate or parent, dem go face di law.

Di examination body tok say dem go continue to release results even as di exams dey go on.

Hijab kasala for CBT Centre

Di first set of di results dey come out inside one hijab palava. Hijab na headgear wey Muslims wey be females dey wear to cover dia head.

Reports say on di first day of di exam, one adhoc staff bin no allow one candidate write di exam sake of say she wear hijab.

Tori be say di adhoc staff bin tell di candidate to remove di headgear sake of say pipo dey use am do mago-mago, as dem dey hide gadgets wey dem dey use do exam malpractice during exams.

Jamb tok-tok pesin Fabian chook mouth for di kasala wey reports say hapun for one Computer Based Test Centre (CBT) for Ibadan, Oyo State.

Di examination body intervene for di mata say wetin hapun for di centre no dey in line wit dia policy.

"Through di monitoring mechanisms, di board bin observe wetin hapun during di screening exercise for di first session of di examination day on Thursday, 16th. Di board intervene for di mata sharp-sharp by calling di ad hoc official wey dey involved to order and issue immediate instructions say make dem no tell any candidate wey wear hijab to remove or change am.

Di board clear di air say di act no be part of dia official protocol or di CBT Centre but "na di action of overzealous ad hoc staff member wey fail to keep to di established guidelines regarding candidates religious attire of di board".

Jamb add say di actions no dey in line wit dia screening procedures sake of say dem respect religious beliefs and customs of all Nigerians.

Dem confam say dem later allow di hijab candidate write di examination.

Reports of abduction of Jamb candidates

Reports also say some candidates wey bin dey travel to go write dis 2026 Jamb examination no reach dia destination as gunmen abduct dem for road.

Reports say di incident hapun around di Ikobi area for Otukpo Local Govment Area of Benue State.

Di management of Benue Links Nigeria Limited confam di tori on Friday April 17, two days afta di incident.

According to di transport line, "one 18-seater bus, wey bin dey carry passengers—most of dem na candidates scheduled to sit for di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) examination di following day—wen armed pipo bin attack dem.

During di incident, di driver and few passengers manage to escape, while dem kidnap 15 passengers. Two of di passengers escape, wey bring di number of di pipo wey dem no fit account for currently to 13."

Tok-tok pesin for di transport company, Johnson Ehi Daniel, tok for statement say di trip no dey authorized and di driver do am in clear violation of di company operational guidelines.

Im explain say di company get standing order wia dem give directive wey ban all company vehicles from going on journeys wey dey beyond 6:00 PM due to di security challenges wey dey increase evriday.

"Di driver, wey act without di knowledge or approval of Management, bin remove vehicle from di company premises, pick up passengers and start di journey without due documentation or clearance."

Di company explain say na "breach of protocol, and dem no officially record di trip and di company no currently get comprehensive details of di affected passengers, aside from indications say majority of dem na Jamb candidates."

Di driver dey police custody and investigations dey go on to know how di incident hapun.

Meanwhile di Benue State Commissioner of police, Ifeanyi Emenari bin tell tori pipo say im dey Otukpko "all my... team and DPO dey here for inside bush and I dey head di operation."

Im add say dm dey go round to make sure say dem rescue di passengers safely.

Earlier, Nigeria Police bin assure candidates, parents and wards say dem don put security measures to ensure safety of candidates.

As at now, no family or guardian don come out to report say dia pikin wey go write jamb dey miss.