Wetin Senate dey do ontop bill to create State Police wey Tinubu send

Nigeria president bola Tinubu

Wia dis foto come from, JUSTIN TALLIS VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, President Bola Ahmed Tinubu
Published
Read am in 3 mins

President Bola Tinubu don send one constitution amendment bill go Senate wey dey seek make Nigeria get state police as part of efforts to reform di kontri security system.

Di proposed law, wey dey inside one letter dated June 15, 2026, Senate President Godswill Akpabio read am during plenary on Tuesday.

According to di president, di bill go provide legal framework for dual policing system for Nigeria, wey go allow states create and run dia own police services alongside di federal police.

E tok say di proposed amendment na important part of efforts to reorganise di kontri policing system so security fit improve and citizens fit get better protection.

E add say communities, villages and local govment areas go play bigger role for policing responsibilities under di new arrangement.

Afta di presentation, Akpabio refer di bill go Senate Committee on Constitutional Review and direct dem make dem report back on Wednesday.

E tok di importance of community-based security, saying local authorities go better know suspicious activities and fit quickly alert security agencies.

"You go know when foreigners don infiltrate Nigeria and alert security agencies so dem fit react proactively instead of reactively," di lawmaker tok, expressing confidence say cooperation between di executive and legislative arms go make di initiative successful.

Akpabio explain say dem go implement am in phases through constitutional amendment and subsequent Acts of Parliament.

"We go do am in two phases through alteration and Act of Parliament. Plenty safeguards go dey; make we come do dis important task. E dey veri important make we come tomorrow," Akpabio tok.

Di Senate President also inform senators say plenary no go entertain oda major discussions sake of di death of House member Yahaya Tongo from Gombe State.

Also di Nigeria House of Representatives, di lower house of parliament bin don pass di bill for di establishment of State Police.

According to dem, di bill go make way for di decentralisation of Nigeria police system through fundamental restructuring wit di creation of both Federal and State Police formations.

Di bill wey dey titled "A Bill for an Act to Change di Constitution of di Federal Republic of Nigeria 1999 to Provide for di Establishment of State Police; and for Related Matters (Sixth Alteration) Bill, 2026," witness 288 lawmakers vote in favour, while four lawmakers vote against am.

Di mark ogbonge step for di long-running debate ova decentralising policing and tackling insecurity.