Dem shoot her severally and e disfigure her face - how Cameroon conflict dey destroy lives

One woman wit plenty scars across her face, e stretch from her forehead down her nose and around her mouth. E appear say dem carry out surgery on her nose .
Wetin we call dis foto, Unknown gunmen shoot Median Bah several times for face
    • Author, Paul Njie
    • Role, BBC Africa
    • Reporting from, Ogoja
  • Published
  • Read am in 9 mins

Median Bah na just 15 wen her life changed forever.

She remember di date well-well - 7 April 2018. She no well and she dey for bed.

Armed men bin storm her family compound for Cameroon Southwest region, one of di kontri two English-speaking areas for di centre of one separatist conflict.

Median, now 23, tok say she bin dey deep asleep wen her brother wake her up, as a group of armed men dey shoot anyhow into di air.

E escape through one window. But for Median, to escape bin no dey easy.

"Since I dey sick, I bin no get strength to jump through di window wit am, so I gatz pass through di door," she tell di BBC.

Dat decision go get serious consequences.

She say she come face to face wit two of di attackers for di backyard, wey open fire at her.

Dem first shoot her for di thigh bifor dem fire several more rounds, wey seriously damage her face.

"I continue to dey beg dem make dem no kill me, say I no well. However, I see myself for floor," she remember.

Evritin first blank. She lost consciousness and she no fit see or speak.

Median bin first tink say she dey dream.

"To my surprise, na reality."

Di attack leave her wit serious facial injuries. Her jawbone damage, most of her teeth scata and most part of her mouth seriously injured.

Two men wear military uniforms, bulletproof vests, helmets and dark sunglasses stand for di street dey hold guns. Yellow and white saloon cars dey visible for di background
Wetin we call dis foto, Di Anglophone crisis start for 2016, wen English-speaking Cameroonians take up arms on top alleged marginalisation by di French-speaking govment (file photo)

Ova di past eight years, don go through at least four reconstructive surgeries for Cameroon, Ghana and India, wit more procedures expected next year.

Dem reconstruct parts of her face from di tissue dem take from oda parts of her body.

Di attack and treatment make am hard for her to breathe normally through her nose and mouth. Doctors do tracheostomy for am, na surgery wey dem take create small opening for neck so air fit enter directly into di windpipe.

For eight years, na through tube she bin take dey breathe. Na recently doctors remove di tube, and now she fit breathe normally again on im own.

One teenager wey get severe injury for face, one mama wey dey forced to run comot from her house, and one student wey di crisis scata im education. Nearly 10 years of figh-fight for Cameroon, don destroy plenty lives and families.

Di crisis bin start for October 2016, wen lawyers and teachers for Cameroon English-speaking regions bin go on strike on top alleged marginalisation of Anglophone communities by di Francophone-dominated government.

Dem bin dey concerned about di appointment of French-speaking judges and teachers to courts and schools for di English-speaking Northwest and Southwest regions.

Initially, di protest bin dey peaceful, as thousands of pipo dey demand for greater recognition from di English-speaking minority.

But human rights groups don accuse security forces say dem dey use excessive force to suppress di protests.

Critics tok say di crackdown, help fuel armed separatist movement.

By 2017, plenty armed groups don emerge, according to di International Crisis Group, wey dey seek independence for di two English-speaking regions and di creation of one breakaway state wey dey known as Ambazonia.

Map of western Cameroon and eastern Nigeria highlight Cameroon two English-speaking regions. Dem shade di Northwest and Southwest regions wit pink and label am, along wit neighbouring Cross River state for Nigeria. Major locations wey dem mark include Ogoja for Nigeria and Yaoundé, Cameroon capital. One inset map show di highlighted area for West Africa.

From dat time, separatist fighters don continue one long and often brutal fight against govment sojas.

Human rights groups don document serious human rights abuses from both sides.

Dem accuse separatist fighters say dem dey do targeted killings, kidnap pipo for ransom, torture victims, and attack schools plus oda public and private facilities.

Meanwhile, govment forces don face accuse say dem dey arrest, detain, torture and kill pipo anyhow.

Both sides don deny di accusations, although for some instances dem acknowledge responsibility for abuses.

Di violence don destroy many communities and force nearly half a million pipo from dia homes, according to data wey di UN publish dis year.

Human Rights Watch tok say at least 6,000 pipo don die since di kasala start.

UN refugee agency, UNHCR, tok say more dan 70,000 Cameroonians don seek refuge for neighbouring Nigeria.

One young woman dey look camera. Di background dey dark but you fit see a brick wall
Wetin we call dis foto, Gloria Akom dey among di 15,000 pipo wey run comot from Cameroon go Nigeria Cross River state

44-year-old Glory Akom, dey live wit one disability afta she survive severe burns for one incident wey no relate to di conflict.

Di mother-of-two now dey live for one camp for Ogoja, one town for Nigeria south-eastern Cross River state, near di Cameroonian border.

Ogoja dey host about 15,000 refugees across three settlements, Richard Effiong, from di UNHCR, tell BBC.

Di UNHCR do provide di refugees wit brick houses wey dem cover wit tin roofs.

For many, however, e still neva dey clear if dem go ever return home.

Glory tok say her life for Cameroon better well-well pass di life she get now. She bin get business and she fit provide for her family.

But evritin change wen di fighting intensify for 2017.

She dem send sojas to her area for di Southwest region wey pursue residents enta bush, force dem to abandon dia homes and run enta Nigeria.

"We dey sleep for bush, as we always dey run," she tok.

"If you sleep for your house, dem fit kill you for there."

Initially, she bin settle for one neighbouring village bifor she move go Ogoja, wia dem later allocate for permanent house for her.

Like many oda refugees, Glory dey depend on $67 (£51) monthly cash assistance from UNHCR to support her children, one of dem dey suffer from sickle cell and e go need regular medical attention.

Di money no reach to cover food, medical bills plus oda necessities, she tok.

Di pain wey she dey feel say she leave her house na di same pain oda Cameroonian refugees wey BBC tok to for Ogoja dey experience too.

21-year-old Maurine Mangha, tok say she and five oda members of her family run comot from Akwaya for di Southwest region afta separatist fighters open fire during celebrations wey mark wetin dem describe as dia independence on 1 October 2017.

"Dem shoot plenty pipo, and we no get choice but to run enta bush," she tell BBC.

Two young schoolgirls for maroon uniforms, pink shirts and yellow Crocs walk past military vehicles
Wetin we call dis foto, Education for Cameroon Southwest region dey seriously affected sake of di conflict (file photo)

Maurine bin stop to dey attend school months earlier becos of one separatist-imposed education boycott.

Di 2017 boycott campaign, wey seek to pressure di govment, bin involve threats and attacks against schools and dos wey go against orders to stay away.

Di consequences for children dey very severe.

Currently, more dan 200,000 children dey out of school for di conflict regions, while nearly 2,500 learning institutions remain non-operational for di two regions, according to di UN children's agency, Unicef, dem cite Cameroonian education authorities.

Despite di disruption, Maurine manage to secure scholarship through one higher education programme for refugees wey di UNHCR dey manage.

Now, she dey study microbiology for one local polytechnic.

But Maurine tok say she no fit help thinking about friends wey remain for Cameroon.

"I feel very bad for my friends as dem no get di opportunity [to further] dia education sake of di crisis," she tok.

Close-up shot of one young woman wey dyey look straight into di camera. She dey stand for di corner of one room wey get brick walls
Wetin we call dis foto, Maurine Mangha don manage to get one scholarship to continue her education

After nearly one decade of fighting, di Cameroonian govment want make di separatists to abandon dia armed struggle.

For September, di authorities bin launch one community dialogue initiative wey di aim na to find grassroots solutions to di conflict.

"Na you, all of us wey siddon for here, wey get di capacity today to organise to tok to dos boys [separatists], to tell dem, di time don come for dem to leave," Prime Minister Joseph Dion Ngute tok during di launch for Buea, capital of di Southwest region.

E repeat one similar message for Bamenda, di main city for di Northwest region and one of di epicentres of di conflict.

For both events, dem present nearly 60 pipo wey dem describe as former separatist fighters say dem abandon dia armed struggle and surrender to di state.

One similar initiative for 2019 fail to end di fighting.

As of November 2026, almost 1,500 former separatist fighters bin dey undergo rehabilitation for Disarmament, Demobilisation and Reintegration (DDR) centres for di two English-speaking regions, one Cameroonian official from di agency wey dey oversee di programme tell BBC.

"Dem don kill plenty Amba boys [separatist fighters], odas don surrender, and many of dem don abandon di ideology of independence," Clovis Naseri, one former separatist commander tok.

One older man wit grey moustache, wear one white shirt and black coat, e dey look into di distance.
Wetin we call dis foto, President Paul Biya, wey don dey power since 1982, don face criticism ova im govment military crackdown on Anglophone separatists

Clovis bin spend about two years wit di White Tigers of Ribbons, one armed group wey dey operate for di Southwest region, bifor dem abandon di group for 2019.

Dem later admit am to one reintegration centre, wia e undergo rehabilitation for several years.

Now, e be vocal critic of di separatist movement and dey advocate for peace and national unity.

Despite defections and govment efforts to encourage fighters to surrender, separatist groups continue to carry out attacks across di two regions.

Some analysts argue say di conflict don go on for too long partly becos of govment failure to address di grievances wey trigger am.

Roland Fru, one researcher on di Anglophone crisis, tok say di authorities neva demonstrate a clear understanding of di issues wey dey drive di conflict.

BBC don contact several govment officials for comment but e no receive any response.

Cameroonian authorities don frequently reject criticism of di way dem dey handle di crisis.

Last November, President Paul Biya tok say di reconstruction efforts, wey international partners dey support, dey help restore normality for di affected regions.

"These efforts go continue steadily," e tok during im swearing-in ceremony, as e dey hail security forces for dia "effective actions" and "professionalism" in improving di situation.

For survivors like Median, Glory and Maurine, however, lasting peace fit no happun until di fighting come to a permanent end.

As dem try to rebuild dia lives and hold on to hope, Median, wey still dey live for Cameroon, tok say she remain grateful say she don survive.

"I don defeat death," she tok confidently. "I no tink say anything fit stop me."

Additional reporting by the BBC's Michel Mvondo