UN experts say dem get grounds to believe say US commit war crimes for Iran strikes

    • Author, David Gritten
  • Published
  • Read am in 6 mins

UN human rights experts tok say dem get reasonable grounds to believe say US commit war crimes for two airstrikes wey dem carry out for Iran, wey kill at least 177 civilians.

One new report by di Independent International Fact-Finding Mission on Iran tok say di missile strikes on one primary school for Minab and for one sports complex for Lamerd establish indiscriminate attacks wey cause di death of civilians and destruction to civilian infrastructure.

Immediate comment neva dey from di US. Dem don deny bifor say dem strike Lamerd and dem say dem dey investigate wetin happun for Minab.

Experts also discova say Iranian authorities commit crimes against humanity during one crackdown on mass anti-govment protests for January.

Dem say killings wey security forces carry out occur on "a staggering and unprecedented scale" across all 31 provinces.

Iran also neva comment on di findings, but dem previously reject allegations of systematic violations of human rights.

"Civilians for Iran dey trapped between serious human rights violations and crimes against humanity wey dia own govment commit, plus di kontri deadly conflict wit United States and Israel," di fact-finding mission warn for one statement dem issue on Thursday.

For dia latest report to di UN Human Rights Council, di mission three independent experts investigate two of di deadliest attacks on civilians during di conflict.

On 28 February, wen US and Israel launch dia war against Iran, Tomahawk missiles strike Shajareh Tayyebeh Primary School for di southern town of Minab, wey kill at least 156 pipo, including 120 children, according to local authorities.

Di fact-finding mission experts tok say di school dey close to one Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) naval complex wey dem also attack dat day, but say di school dey clearly identifiable and no information show say dem dey use am for military purposes.

Di experts say, based on di evidence wey dem gada - including media reports, preliminary US military inquiry find say US forces dey responsible, plus di fact say US na di only party to di conflict wey get Tomahawk missiles – dem get reasonable grounds to believe say na di US carry out di attack for dat school.

Dem also conclude say di school na "di intended point of impact and di damage no be sake of one errant strike or collateral damage" from di attack on di IRGC complex, dem cite survivors wey tok say dem strike di school two times.

US military neva release di findings of dia own investigation into di Minab strike, but Defence Secretary Pete Hegseth say dem no go "eva target civilian targets".

Also on 28 February, Precision Strike Missiles (PrSM) scata clouds of tungsten pellets ova one sports complex and residential area for di town of Lamerd, wey kill at least 21 civilians, including seven children, according to local authorities.

Again, di fact-finding mission experts say di sports complex dey clearly identifiable and no information dey wey show say dem dey use am for military purposes.

Dem conclude say dem get reasonable grounds to believe say na di US carry out di strike, based on di evidence wey dem gada. Dem point to di fact say na only US among all di parties involved for di conflict get Precision Strike Missile (PrSM) for dia arsenal and dis na one of di key evidence wey support dia findings.

For both incidents, di fact-finding mission experts tok say dem get "reasonable grounds to believe say di United States commit di war crime of launching indiscriminate attacks, wey lead to loss of civilian lives, injuries to civilians, and damage to civilian properties".

US military tok say dem no carry out any strikes on Lamerd dat day and dem no agree wit reports wey identify di weapon used as a PrSM.

Di experts tok say di level of violence and repression wey take place during di crackdown pass wetin don happun for similar situations bifor. Dem say security forces use lethal force on a large scale, wey lead to di killing and injury of many pipo, while authorities also carry out widespread arrests.

Dem cite witnesses, health workers and victims families wey tok say security personnel position demsefs on top roof and oda elevated positions, and fire dia assault rifles into crowds.

Protesters also sustain severe wounds to di head, chest and eyes from metal shotgun pellets, wey cause permanent blindness.

As di crackdown escalate, security forces attack healthcare facilities, beat and arrest wounded demonstrators and arrest some healthcare workers, wey stop victims from seeking life-saving care, according to di experts.

Dem also discova say di tens of thousands of pipo wey dem detain during di protests face torture, solitary confinement and denial of legal counsel.

Di experts warn say govment don since intensify dia use of di death penalty against protesters, and dem don execute at least 29 men following expedited trials on charges wey connect to di unrest.

Di fact-finding mission report note say e no dey possible to independently verify di death toll from di crackdown but say strong grounds dey to believe say e high pass di official figure of 3,000, di majority of whom di govment bin identify as members of di security forces or bystanders.

Di US-based Human Rights Activists News Agency (Hrana) tok say dem don confam di killing of more dan 7,000 pipo, and almost all of dem na protesters.

Di fact-finding mission experts conclude say Iranian authorities don commit "many gross human rights violations" during di crackdown and say dis amount to "di crimes against humanity of murder, imprisonment plus oda severe deprivation of physical liberty, torture, and oda inhumane acts wey dem commit as part of one widespread and systematic attack wey dey directed against a civilian population".

Iranian authorities accuse US and Israel of starting di unrest and dem blame di deaths on wetin dem describe as "terrorists" and "rioters".