America country music legend Dolly Parton don die at di age of 80

Dolly Parton dey perform for black and white picture

Wia dis foto come from, Tom Hill/WireImage via Getty Images

Published
Read am in 6 mins

Iconic country musician Dolly Parton don die at di age of 80, her family announce on her social media.

"Sadness lies wit us, not wit Dolly," Parton nephew Brian Seaver tok for inside one video announcement. "Dolly live for di light and for di arms of Jesus, surely."

E tok say "Dolly call me tell me say she wan rest for plush cotton becos afta life wey she don dey wear heavy rhinestone, she wan finally dey comfortable".

Her public relations team release statement wey confam di death for wia dem tok say she live "a rhinestone life wey bin shine bright for di world to see. Dolly go forever stand as inspiration not only becos of her music wey dey timeless or her ogbonge songwritinf skills, but also wey wit, warmth and kindness wey make all of us feel like say we be family."

Dolly Parton bin dey di music industry for ova 60 years for wia she bin write ova 3,000 songs.

Her most recent hit na collabo wey she bin do wit popstar, Sabrina Carpenter for di remix of di song Please, Please, Please.

Dis death announcement dey come afta ova a year wey pipo don dey fear for di health of di Coat of Many Colours singer.

For October 2025, her sister Frieda Parton bin go Facebook to ask pipo say make dem pray for her.

Di message fear pipo sotay, she gatz drop video wey she caption say "I neva die yet".

Her death come about seven months afta she lose her husband of 59 years, Carl Dean for March last year. Dem no get children, but dem share one large and close-knit extended family.

As at di time of her death, she bin dey promote di opening of her museum wey dem call - My Life of Many Colors Museum.

E dey set to open for dis year fall but dem neva announce opening date.

President Trump lead tributes as di world of country music mourn one of dia icons.

Dolly Parton fans pay tribute

Wia dis foto come from, Reuters

US President Donald Trump don order make dem lower American flags in honour of Dolly Parton.

"American flags throughout di US go dey lowered for one week beginning on Tuesday evening".

For one post on Truth Social, e add say: "Dis na true loss for millions of pipo. Nobody ever be like her, and never will."

"Rest in Peace, Dolly! Di World loves you," e write.

"I dey devastated. Truly" actor Keke Palmer tok alongside one foto of her and Parton. Di two of dem feature for one 2012 musical feem, Joyful Noise.

British singer Paloma Faith for her tribute say, "Rest in peace wonderful Dolly Parton. You be one of di greatest ever to do it!... Thank you for di inspiration and may you be singing in heaven wit all di greats."

Actor Jamie Lee Curtis say Parton na hero wey be "great example for us all".

Keith Urban, wey collabo wit Dolly Parton, say im dey "heartbroken" by di news. "Honestly... I have no words right now."

Also Parton fans don begin gada for di Country Music Hall of Fame for Nashville, Tennessee, to sign one guest book as part of di museum exhibition, Dolly Parton: Journey of a Seeker.

Following news of her death, dem don hang one frame by di guest book wit one message encouraging visitors to share memories and condolences for di book, wey dem go deliver to di Parton family.

Who be Dolly Parton?

Dolly Parton for stage wit mic in front of am and two sofa chairs behind am a little out of focus

Wia dis foto come from, Jason Kempin/Getty Images

Dolly Parton, di country singer from di Smoky Mountains of Tennessee, go dey remembered for her songs wey tell beautiful stories so honestly, like di Coat of Many Colours, Jolene and I Will Always Love You.

For her career wey span for seventy years, Parton win 10 Grammy awards, sell more dan 100 million records worldwide, and write more dan 3,000 songs.

Parton take her writing seriously, and she consider herself a songwriter over everything else. "Na my way of expressing myself," she tok. "na my therapy."

She also be correct businesswoman wey no dey fear to make tough decisions. She dey armed wit quick wit and southern charm, she took control of her show business career that spanned more than 60 years.

Dem born Dolly Rebecca Parton for 1946, she be di fourth out of 12 children, into poor farming family wey bin live for one bedroom cabin for Tennessee.

Her father, Robert Lee Parton, na tobacco farmer and e pay one missionary one sack of cornmeal for delivering her.

Music already dey run for di family - her mother, Avie Lee, dey sing folk songs all di time and her aunt dey play di guitar and write songs. During some of Parton earliest performances, her uncle, Bill Owens, follow her on di guitar - formative years for di future music legend.

From di age of six, she begin sing for di local church wia her grandfather na di pastor, and she don begin dey perform on local TV station by di time she be teenager.

For 1959, wen she be13 years old, Parton perform wit Uncle Bill for di Grand Ole Opry for Nashville - one live broadcast wey dey regarded as country music biggest stage.

She bin dey write songs give oda pipo as teenager but for 1966 she get her own hit wit di song Dumb Blond.

Na still for dat year she marry her husband Carl Deen. From 1967 she call her first few albums say dem specialize in "sad ass songs" den she drop feminist bop fir 1968 wey she call Just Because I'm a Woman.

Dolly Parton

Wia dis foto come from, Getty Images

She get her first number one hit - and first Grammy nomination – wit di song Joshua for 1971 and she finally leave The Porter Wagoner Show for 1974 to concentrate on her solo career.

To say goodbye to him, she write I Will Always Love You, one song wey many pipo think say na about two lovers wey dey part ways.

"Dat na di prettiest song I don ever hear," Wagoner cry wen e first hear am, her website tok.

Di same year, Elvis Presley suppose set record a cover of di song, but Parton end di deal wen im manager demand half of di songwriting rights.

For di 70s howeva, her hand mature for song writing and na wen she start to drop bangers like Jolene wey many artists don cover including her own god-daughter Miley Cyrus and di song I Will Always Love You wey Whitney Houston make popular.

By 1977, Dolly Parton don shift to pop super star wen she make her first US platinum album, Here You Come Again.

For di 1980s she start to dey act and bin sing di Oscar nominate song 9 to 5 and Islands in the Stream.

For 1986, she don drop anoda banger wen she open di Dollywood theme park for Tennessee bifor she act for Steel Magnolias.

Even sef na ger company Sandollar Productions rin di series for Buffy the Vampire Slayer.

She don also make cameo appearances for plenti series, like di Disney show of her god daughter wey dem dey call Hannah Montana.

For November 2020,, e comot say Dolly Parton bin drop $1m for Morderna Covid-19 vaccine effort.

More recently she don run plenti big songs featuring trending musicians as for 2024, she follow Sabrina Carpenter do di remix for Please Please Please.

We still dey update dis tori!