Na true say Emir Sanusi fail some courses for im Law degree for University?

- Author, Muslim Muhammad Yusuf
- Reporting from, BBC Hausa
- Published
- Read am in 5 mins
Di Emir of Kano Muhammadu Sanusi II bin recently return to Northwest University for Kano to study law, and e start im studies earlier dis year from second year.
One video don go viral for social media, wia one young man dey claim say entourage of Emir of Kano, Muhammadu Sanusi II, reach di university wey di Emir dey study to "settle" matter bicos dem give di Emir "carry over".
Pipo don share di video widely for different social media platforms, and dis don lead to tok-tok about why di Emir go fail courses for di subjects wey e dey study.
For di short 26-second video, dem hear di young man dey tok say: "As una dey see, dem give di Emir carry over, na why e come wit im pipo, dem dey come settle di matter... Lecturers, make una dey careful."
For some time afta e return, pipo don dey wonder how e go study for one university for Kano State, months afta e complete im doctorate degree for one university for London, Britain.
BBC investigate wetin happun, and find di Emir entourage for di entrance of one conference room for di university Faculty of Law.

Wia dis foto come from, ABBA BLOGGER/FB
Reason Emir Sanusi return university
No be only for Nigeria, Sanusi II, wey be di Khalifa of followers of Tijjaniyya order for di kontri, get strong influence for neighbouring kontris, especially for West Africa.
All dis na part of di reasons why some pipo believe say di traditional ruler don reach one level wey pass am - to join younger students to study for first degree.
But for one interview wit BBC afta e complete im studies for Northwest University for Kano for January, Muhammadu Sanusi II tok say e don long get interest to study law.
Di Emir explain say even though e don already get doctorate degree (PhD), e still get interest to study law.
Wetin BBC find
Information wey BBC get show say wen di video go viral, di examination for di class wey Emir Sanusi dey never start.
Di source tell BBC say di examination go start on 10 August - and up until dat time, di Emir never write any examination.
As pipo fit see for di video wey plenty pipo don share, di large crowd wey dey follow di Emir entourage dey accompany am wen e go school as student, "na why plenty pipo gada."
Dem say dem record di video for one event wey di university Law students organise on Saturday.
But according to di source, even if di Emir fail one course as student, e no suppose be anything to worry about.
"Even if e get 'carry over', e no be anything to worry about."
Information wey BBC get show say nobody fit access anoda student examination results because "dem dey send everybody im result through im email address."
Dis show say no way person fit see another person result if dem neva discuss am, because dem no dey publish am for notice board as di young man claim.
"Since we dey first year, dem never publish our examination results for notice board," one law student wey dey di same class with di Emir tok.
Some of di students wey dey study wit di Emir again confirm say Emir Sanusi never fail any examination.
According to di examination timetable wey BBC get, di Emir go write im first examination for dis academic session on Tuesday bicos "some of di courses wey e dey take different from di ones wey oda students for di class dey take."
Wetin Kano Palace tok
Kano Palace also dismiss di video wey dey circulate for social media.
For one statement wey secretary to di Emir office, Muhammad Ado, issue, e say di claim wey dey di video no be true, adding say di Emir dey on course to complete im studies wit di highest grade, "First Class".
E say dem record di video for one event wey di university Law students organise on Saturday.
"We attend one event wey di university Law students organise on Saturday, and na one student record di video. But e no be true.
Dem link di video to some youths wey dem allege say na dem record am and circulate am as joke.

Wia dis foto come from, ABBA BLOGGER/FB
Profile of Muhammadu Sanusi II
Dem born Muhammadu Sanusi II for Kano State for Northern Nigeria on 31 July 1961.
Sanusi II attend primary school for St. Anne School for Kaduna, den e move go King's College for Lagos, wia e attend secondary school between 1973 and 1977.
E get im first Degree for Economics from Ahmadu Bello University for Zaria for 1981, den e get Master's Degree for 1983, wia e teach for some time.
E move go University of Khartoum for Sudan, wia e study Islamic studies.
Afta e teach economics for two years for Ahmadu Bello University for Zaria, e start work for banking for 1985 with Icon Limited, and later e work wit UBA and First Bank.
E bicom Executive Director for First Bank for January 2009, and later dem appoint am as di 10th Govnor of Central Bank of Nigeria for June 2009.
Sanusi II get im doctorate, PhD, for law for London, wia e research "Codification of Islamic Family Law as an Instrument of Social Reform: A Case Study of the Emirate of Kano and a Comparison wit di Kingdom of Morocco."
During di administration of Nigerian President Goodluck Jonathan, di president suspend am from im position as Govnor of Central Bank of Nigeria on 20 February 2014 afta dem accuse am of negligence for financial matters.







