'I no know say my papa death dey near' - Pete Edochie first son narrate father last wish

Wia dis foto come from, Leo Edochie/Pete Edochie via Instagram
First son of ogbonge Nollywood actor Pete Edochie say im papa no know say im death dey near.
Pete Edochie na one of di most respected actor wey Nigeria and Africa don produce, and im death shake di movie industry.
For di exclusive wit BBC News Pidgin, first son of di Nollywood veteran, Leo Edochie tok im papa last wish, last travels and legacies.
Ogbonge actor Pete Edochie die 25 November, 2026, as im family announce for statement say di actor die at di age of 79 years afta long battle wit prostate cancer.
"My papa as im no well, di sickness wey im get na terminal sickness prostate cancer, im bin do surgery six years ago abroad. But you know say finally cancer dey kill."
'I bin no tink say im death dey near'
Pete Edochie na pesin wey pipo sabi well-well sake of im deep voice, im strong character, wisdom, di way e take dey use African proverbs, and di correct way e take dey deliver im roles for feems wey mostly be di role of traditional ruler, father, king, chief and community leader.
According to Leo Edochie, e say im papa battle cancer wey e do surgery abroad but di surgery no last past six years.
"I bin no tink say im death dey near, but for pesin wey dey suffer from cancer. Na so e dey be gradually, e go dey affect oda part of your body."
Leo say im papa na strong man wey move wit strength. E add say even as im papa dey travel go different kontris, e dey move wit strenght.
"Na strength of man im take dey move, e get pipo wey go dey, dem go lay down, but im carry am still go Ghana, im don go Morocco, go do feem come back."
Edochie die few months afta e go Ghana to go launch im book about im own life.
Leo Edochie also torchlight on im papa last wish and how e battle di condition.
"Im tok say instead wey im go dey dey suffer evribody, say dem dey carry am from one hospital to anoda, instead make God call am.
"My papa believe in truth, tok am di way e be. So of all im legacies wey you know, di whole world know dis two bin din most important truthfulness, den to keep your hands straight."
Leo say im papa bin live exemplary life, say na life wey any young pesin go like follow.
"Becos I get choice not to, but di truth b say I must carry dat family along."



















