Govnor Ademola Adeleke condemn alleged arrest of Osun PDP chairman
Di govnor of Osun State and candidate of di Accord Party for di ongoing election don condemn di alleged arrest of state Peoples Democratic Party chairman, Sunday Bisi.
Di govnor say security pipo gbab Sunday Bisi for im house afta e cast im vote.
“Information wey reach me indicates say Hon. Bisi bin dey accosted for im home for Ilesa shortly afta e returned afta voting, and dem take am away to location wey neva dey known,” e tok for statement.
E say di security pipo no tell anyone di reason for im arrest.