Top candidates wey dey hustle for Osun State govnor position

Published
Read am in 8 mins

Di August 15 govnorship election for Osun State, southwest Nigeria, go go be hot contest betwin 14 candidates.

Dis na even though sabi pipo tok say na about three of dis candidates get beta chance to win am.

Out of di 14 candidates, only one na woman.

As di Election day come closer, and as di candidates dey waka across di 30 local government areas of Osun State to campaign for votes, hia na brief profile of some of di candidates for di election:

Ademola Adeleke - Accord

Ademola Nurudeen Jackson Adeleke na di current govnor of Osun State and e dey contest for im second tenure for di seat.

Adeleke come to limelight for politics afta di death of im broda, Isiaka Adeleke, wey bin don serve as govnor and senator for di State.

Na afta Isiaka die for April 2017, na im di younger Adeleke contest to take im place for di Senate and e win.

Den for 2019, Ademola Adeleke run for im first govnorship election unda di Peoples Democratic Party (PDP), but lose to Adegboyega Oyetola of di All Progressives Congress (APC).

E contest again in 2022 and win to bicom di second Adeleke to sit for di numba one position for Osun State.

Howeva, sake of di internal wahala for di PDP, di govnor comot from di party and join Accord Party, and e dey hope say e go fit repeat di victory wey e bin get four years ago.

Adeleke get higher education for Jacksonville State University, Alabama, USA, wia e bin study criminal justice wit minor in political science.

But afta some questions bin come up about im education background, e later enta di Atlanta Metropolitan State College wia e also get B.Sc for criminal justice in 2021.

Adeleke dey promise more infrastructure project if e win dis second tenure. For im first term, e bring im five-point agenda wey include: workers and pensioners, Infrastructure, economic growth, education and youth, and people welfare.

Bola Oyebamiji - APC

Asiwaju Munirudeen Bola Oyebamiji (Ambo) na di candidate of di ruling All Progressives Congress (APC), and many tok say na im di biggest challenge facing di incumbent govnor, Adeleke.

Oyebamiji, who come from Ikire community for Irewole Local Government Area, don serve for di Osun State govment for many years as Commissioner of Finance, right from di time wen Rauf Aregbesola be di govnor and even during Oyetola tenure.

Im na di managing director of di National Inland Waterways Authority (Niwa) bifor e resign for November 2025 to contest for govnor.

Oyebamiji get National Diploma (ND) and Higher National Diploma (HND) for Banking and Finance from Ibadan Polytechnic, and e also get Masters degree for Public Administration and Business Administration from Lagos State University and University of Ado-Ekiti respectively.

E dey enjoy di 'Federal might' of di APC wey be di party in power for Nigeria, plus di endorsement of former govnor Oyetola.

On wetin e dey promise di Osun pipo, Oyebamiji, during one townhall event for candidates in di election on Tuesday, tok say: "The welfare of our pipo for Osun dey veri paramount; security dey veri important; dis na di tins wey I wan bring up, and we wan banish hunger and poverty, and I go invest seriously for agriculture, education and health."

Najeem Salam - ADC

Najeem Folasayo Salami - of di Africa Democratic Congress - bin don serve two tenures as di Speaker of di Ondo State House of Assembly, and tori bin even carry am one time say e be di pesin wey former govnor Rauf Aregbesola bin choose to succeed am.

Born on 8 August 1965 for Ejigbo community, Salam na graduate of di prestigious Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, wia e get im B.Sc, M.Sc and P.hd for political science.

E first come into political leadership for 2007 wen e win seat for di Osun State Assembly, and even though court cancel dat election in 2009, Salam contest again in 2011 and win, also bicoming speaker dat same year and again in 2017.

Salam dey enjoy di support of di ADC joinbodi movement, wey dia national secretary na di former Osun State govnor Rauf Aregbesola, and oda political heavyweights like di former Vice President Atiku Abubakar.

Di two-time Speaker promise say im administration go put emphasis on electricity, agriculture, infrastructure, education, security, healthcare, job creation and economic empowerment.

Adesina Adeyemi-Doro - APGA

Even though Adesina Olusanya Adeyemi-Doro don tok some days ago say e dey withdraw from di contest, and say e dey endorse di APC candidate, Oyebamiji, di time don late now for di Independent national Electoral Commission (Inec) to comot im name from di list of candidates.

For im LinkedIn page, Adeyemi-Doro describe imsef as "Psychologist, Entrepreneur, Philanthropist and Social Leader" and im experise include "public speaking, customer service management, business development management and human resource management".

Olanrewaju Farinloye - AA

Olanrewaju Emanuel Farinloye na di candidate for di Action Alliance (AA), and e come from Ilesa town for Osun State.

Di 41-year old candidate describe imsef as a "problem solver" not a career politician.

Farinloye campaign promises include:

  • Job creation
  • Education and skills development
  • Accessible and effective healthcare
  • Agriculture and rural economic growth.
  • Infrastructure development, and
  • Social protection policies

Esan Olajide - AAC

Esan Olajide na one of, if not di youngest candidate for di Osun State govnorship election.

Di 39-year-old dey contest unda di Africa Action Congress (AAC), di party wey bicom popular sake of dia leader, di popular human rights activist Omoyele Sowore.

Olajide get degree for Geography and Resource Management from di University of Osun, and na entrepreneur.

E say im govment go bring dignity, renewal and purposeful leadership.

Saliu Orisunlagba - PRP

Saliu Rasaq Oyelami Orisunlagba na medical doctor and e dey contest unda di People's Redemption Party (PRP).

For di last Osun State govnorship election in 2022, Orisunlagba bin contest on top di New Nigeria Peoples Party (NNPP) and in 2018, e also contest unda di Action Democratic Party (ADP).

E get im university education from di University of Ilorin and di International University of Africa for Khartoum, Sudan.

Orisunlagba also study journalism for di International Institute of Journalism for Abuja.

E dey promise competence, compassion and reimagined future for di pipo of Osun State.

Olufemi Adesuyi - ZLP

John Olufemi Adesuyi na technologist and politician wey dey contest unda di Zenith Labour Party (ZLP).

E get B.Sc for Computer Science and Engineering from Obafemi Awolowo University, Ile-Ife.

Taofeek Adeleke - NNPP

Adewale Taofeek Adeleke na candidate of di New Nigeria Peoples Party (NNPP).

Im campaign message na to improve education, healthcare, security, infrastructure, and improved standard of living for di pipo Osun.

Masilo Adeleke - BP

Adeleke Adesoji Masilo, candidate of Boot Party (BP) na Nigerian politician wey bin contest for senate seat during di 2023 general elections.

Masilo bin don serve two times as di Osun State chairman of di Inter-Party Advisory Council (IPAC), and e also contest for di 2022 Osun govnorship election.

Adeagbo Yemisi - ADP

Adeagbo Opawoye Yemisi (ADP)- na di only female candidate for di list and she belong to di Action Democratic Party.

Madam Yemisi get bachelors degree for education, serve as secondary school teacher for many years wia she rise to di post of school Principal.

Adeagbo promise to move Osun State from di current position to model state wey oda States for di kontri go dey look up to as example of purposeful governance.

Her running mate na 43-year-old Atanda Eniola Babatunde.

Adewale Adebayo - APM

Adewale Adebayo dey contest on di platform of di Allied Peoples Movement (APM), wey e bin don serve as di party chairman for Osun State.

Adebayo don also serve two terms aschairman of di Inter-Party Advisory Council (Ipac) Osun State chapter.

"Dat role bin train me to look beyond party lines and engage issues objectively," e tok for one interview.

Adebayo believe say as e be underdog for di election, e fit be advantage to am bicos di bigger names for di contest also get big baggage.

"APM dey lighter, clearer for purpose, and aligned wit di mood of di pipo. For politics, dat combination dey often more powerful dan size."

E dey important to add say dis Adewale Adebayo dey different from di more popular politician wey dey also ansa di same name, Adewale Adebayo of di Social Democratic Party (SDP) wey don emerge as di party presidential candidate for di 2027 presidential election.

Clement Adesuyi Bamiji of di Action Peoples Party

Olalekan Ogunsakin of the Young Progressives Party