Osun State election result across 30 LGAs

Wia dis foto come from, Ademola Adeleke, Bola Oyebamiji, Najeem Salam/Facebook
Residents of Osun State don return Govnor Ademola Adeleke for second term during di govnorship election wey happun on Saturday, 15 August.
Di Independent National Electoral Commission (Inec) declare Govnor Adeleke winner of di election as e score 511,067 votes for di poll wey 15 candidates bin contest for.
Bola Oyebamiji of di All Progressives Congress (APC) poll 444,815 votes, while African Democratic Congress (ADC) candidate Najeem Salam score 17,180 votes.
Di voting wey start by 8:30am end by 2:30pm but e extend beyond dat time for some polling units.
Di kontri electoral bodi begin upload di results shortly afta voting end for several polling units across di state.
Meanwhile, plenty jubilation bin happun across Osun State, southwest Nigeria as Inec declare Govnor Adeleke winner of di election.
Di celebrations full Osogbo, di state capital and for Ede wia Adeleke come from, as supporters gada for streets dey sing and dance as dem express joy on di outcome of di election.
For di Inec collation centre for Osogbo, supporters gada as di returning officer Joshua Ogunwole announce results from di state 30 local govment areas.
Check di map below to see di election results from different local govment areas of Osun State.
Why dem dey hold di election for off cycle
Since dem create Osun State for 1991, elections for di state dey always sound like battleground as both di candidates and even di electorate dey always feel di heat.
All di govnorship elections wey dem don hold for di state since di return of democracy dey always end for tribunal or legal battle, na only dat of 2007 wey court comot di sitting govnor and install anoda govnor.
Koko be say for 2007 election, Inec declare Olagunsoye Oyinlola of di PDP winner, but afta three years of legal battle, Court of Appeal nullify Oyinlola election and declare Rauf Aregbesola of Action Congress of Nigeria (ACN) winner and change of govment happun immediately.
Dem count Aregbesola govment tenure from di day im enta office, even though Oyinlola bin spend three years for office.
Sake of dat legal challenge and di change of power, elections for di state stop to dey happun for same time wit oda states.
As Ademola Adeleke don win re-election, e go lead di state again from 2026 to 2030.










