Wetin e mean for South Africa as Jacob Zuma appoint son as deputy president for MK party as e sack and announce changes

Wia dis foto come from, Per-Anders Pettersson/ Thapelo Morebudi/Sunday Times/Gallo Images via Getty Images
Former South Africa president and leader of di uMkhonto weSizwe Party ("MK Party"), Jacob Zuma, don announce leadership changes to di party.
Jacob Zuma wey also be di president of MK party sack di current leadership of di party and appoint new ones.
Di one wey cause tok-tok na di appointment of Jacob Zuma son into di leadership of di party.
MK party na one of di leading political parties for South Africa wit parliament members wey dey represent dem including Zuma daughter, Duduzile Zuma‑Sambudla, but she later comot for di parliament.
Na Jacob Zuma create di party, and e don dey rival oda big parties like di African National Congress (ANC) and Democratic Alliance (DA).
Zuma say im decision to sack di leadership of di party and appoint new ones na based on consultation and consideration.
Who Jacob Zuma sack?
Di National chairpesin of di party dey among dose wey chop sack from leadership role.
"Nkosinathi Nhleko go comot from im responsibilities as National Chairpesin of di MK Party wit immediate effect."
"Zuma express im sincere appreciation to Mr. Nkosinathi Nhleko for di dedication, commitment and service to di Party during im tenure," di party tok.
Also, MK party president sack Dr John Hlophe from im responsibilities as First Deputy President of di MK Party wit immediate effect.
"President Zuma extend im sincere gratitude to Dr Hlophe for im leadership, dedication and invaluable contribution to di growth and strength of di MK Party."
Dr Hlope dey part of di parliament and Jacob Zuma say e go remain di 'Parliamentary Leader of di MK Party for di National Assembly and go continue to carry out im responsibilities for dat capacity.'
Jacob Zuma also sack Ms. Nomsa Dlamini from her responsibilities as Deputy Secretary-General of di MK Party wit immediate effect.
Who dey di new leadership of MK party?
Afta sacking Nhleko as National chairpesin of di party, Zuma appoint Reverend Phakathi as di National Chairpesin of di MK Party wit immediate effect.
"Di President hereby appoint Mr Duduzane Zuma as di First Deputy President of di MK Party wit immediate effect."
"Di President hereby confam Cde Tony Yengeni as di Second Deputy President of di MK Party," MK Party tok.
In di same vein, di President appoint Cde Willis Mchunu to serve as part of di Presidency collective of di MK Party.
"E go provide strategic advice, organisational guidance and support on matas wey require presidential oversight and coordination."
Zuma say Mchunu go continue to serve as di Provincial Leader of di MK Party for KwaZulu-Natal.
Ms Lindiwe Mtshali go serve as di Deputy Secretary-General of di MK Party wit immediate effect.
Jacob Zuma also dissolve di Strategic Presidential Team wit immediate effect.
"Di Team go cease to exist for any capacity within di organisational structures of di MK Party."
"Any commitments, contracts, obligations or financial liabilities wey anybodi enta into by members of di dissolved Strategic Presidential Team no go be di responsibility of di MK Party," di party tok.
MK party distance diasef from any debts or financial obligations wey di party no approve.
"Di President confam say Zandile ("Zandi") Hlophe and Mr Sibonelo Maphumulo, as members of di Presidential Task Team, and di MK Party authorise representatives and signatories wit di Independent Electoral Commission (IEC)."
Wetin dis mean for South Africa politics
For sometime now, pressure dey on South Africa president Cyril Ramaphosa ontop impeachment wahala ova allegations wey di parliament sama am.
Meanwhile, Western Cape High Court deliver judgement wey grant di president interim interdict wey go temporarily stop di parliamentary impeachment process from moving forward.
Changing of new party leaders for MK mean say dem dey try strenghten dia stronghold for di parliament to make agitations and consultaions on certain issues easier.
Jacob Zuma say e announce series of organisational decisions to strengthen di party.
MK Party dey try position diasef as di leading political party for South Africa, and dis change go mean new hands.
Zuma say di changes dey important to make di party effective and help dia leadership structure to continue dey serve di pipo of South Africa.









