Wetin we know so far for Japan earthquake
- Author, George Wright
- Published
- Read am in 4 mins
Japan dey try comeback from dia latest major earthquake wey hit di kontri.
Nineteen pipo dey miss for Aeon shopping centre and paper factory afta di 6.8 magnitude earthquake hit Kyushu island, one official tok.
Di earthquake also cause power cuts, e damage roads, collapse one castle wall and destroy footbridge.
Tori still dey come out of Japan but dis na wetin we sabi so far.
Wen and wia for Japan wey di earthquake happun?
Di earthquake hit di Kumamoto prefecture on Kyushu island around 16:27 local time (07:27 GMT) on Tuesday, as dem tell about 300,000 pipo to comot go evacuation shelters.
Kumamoto - wia di Aeon Mall wey collapse dey - na city on di Kyushu island of Japan.
Di southern island of Kyushu na di third-largest of di four main islands for Japan, and di second most populous.
Di Kumamoto prefecture no be stranger to earthquakes.
Total of 278 pipo bin die for 2016 sake of powerful earthquakes for Kumamoto and neighbouring Oita prefectures, according to Japan public broadcaster NHK.

Wetin happun for di shopping centre?
Pipo still dey trapped inside di Aeon Mall for Kumamoto prefecture, na wetin fire service tok.
Dem neva fit account for 10 pipo wey dey for di shopping centre, one official for di Disaster Management Division of Kumamoto prefecture tell di BBC.
Dem don rescue four pipo from di mall and their lives "no dey in danger", di official add.
Japan public broadcaster NHK earlier bin report say police say di contact of 20 to 30 employees don loss.
One witness report say e see explosion and smoke for di shopping mall afta di earthquake happun.
Di witness bin see di second floor of di building collapse, wit some shoppers wey demcarry go hospital.
Japan fire and disaster management agency later confam say di second floor of di "commercial facility" collapsed, wit many pipo wey dey trapped inside.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Which oda place dey affected?
For anoda place for Kumamoto prefecture, di disaster management official tell di BBC say "dem see two pipo wit "cardiac arrest" for di paper factory and nine pipo still dey miss for di plant.
One chimney reportedly collapse for di Nippon Paper Yatsushiro Plant, according to police, wey NHK bin make reference to.
One aerial photograph of di site wey Reuters news agency get appear to show broken and collapsed chimney.

Wia dis foto come from, Reuters
Tremors bin also cause historic walls for di 17th-century Kumamoto castle to tumble.
No be di first time di castle don succumb to earthquake. Wen one 7.3 magnitude quake bin hit di region for 2016, part of di 400-year-old castle bin also dey damaged as turrets and curved walls bin collapse.

Wia dis foto come from, Reuters
One footbridge bin also collapse for di Kumamoto region.
E neva dey clear if anybody wound, or wen di collapse bin happun. E be like say Traffic still dey move for di bridge wey dey runs parallel to am.
More dan 40,000 households no get light, according to one update on Kyushu Electric website. Some roads damage.
Na more dan 60 aftershocks ranging magnitude from 1 to 4, Japan Meteorological Agency tok.
Dem bin issue one tsunami warning immediately afta di earthquake, but demmbin lift am within two hours.










