How much Nigerian military personnel dey earn now and wetin go be dia new salary

Wia dis foto come from, EPA
Following di announcement on Tuesday say di Nigerian govment go increase di salary of di members of di armed forces by 30 and 80 percent, many pipo don describe am as a welcome development.
For one statement from Bayo Onanuga, di tok-tok pesin to President Bola Tinubu, e tok say about 250,000 personnel of di armed forces go benefit from dis new increment.
Also, e go add extra 26 billion naira to di moni wey govment bin dey pay di military, raising di total amount from 660 to 924 billion naira evri year.
"Di men and women wey dey help to keep us safe for our homes must to dey supported and appreciated as dem dey do dia duties to our nation," Tinubu tok for di statement.
So BBC News Pidgin do some small calculation to try to determine how much go be di new salary of personnel for di Nigerian military.
Di military dey divided into di Army, di Air Force, and di Navy, and dia ranks, even though dem dey different for name, dem dey related and dia salaries na within di same range for di various ranks.
For example, di lowest rank for di Nigerian Army na 'Private', and di equivalent for di Navy and Air Force na 'Ordinary Seaman' (OS) and 'Aircraftman/Aircraftwoman' respectively.
According to Statisense, wey be ogbonge statistics organisation for Nigeria, di current take-home salary for rank of 'Private' for Nigeria na ₦104,000 ($64).
One army personnel wey no wan call im name also confam dis to our tori pesin on Wednesday, 5 August, as e tok say di salary for "Private, OS, and ACM na within 103 to 105 thousand naira".
For di statement wey Onanuga release on Wednesday, govment do 80 percent salary increase from di rank of Private to Staff Sergeant.
E mean say di lowest rank for di military for Nigeria go now dey collect minimum of between ₦189,000 and ₦192,000 ($138-140) evri month; dat na annual salary of about 2.26m to 2.30m naira ($1,658 - 1,687)
Similarly, figures from Statisense also show say di current salary of big oga dem for di military, di rank of Major General, Rear Admiral or Air Vice Marshal for di Army, Navy and Air Force respectively, na around ₦1.15m ($851) per month.
Di new salary increment by di President na 30 percent for Brigadier-Generals, Major-Generals, Lieutenant Generals and Generals.
So e mean say a Major General for example go now dey collect around ₦1.49m to ₦1.5m evri month; wey be around 17.9m to 18mnaira ($13,134 to 13,207) evri year.
Di statement no tok wen dis new salary increment go take effect, weda na immediately from dis August abi afta.
Dis announcement dey come just less dan one month afta di Minister of Defence, Christopher Musa, tok say di least soja for di Nigerian Army dey earn 100,000 naira per month (less dan $100).
Musa tok say na under di Tinubu administration govment increase di salary reach dat amount; bifor dat time dia salary na about 49,000 naira.
Dat revelation cause plenty tok-tok dat time as pipo complain say di amount no make sense for pipo wey dey always put dia life on di line to secure di kontri.
How Nigerians react
Popular journalist Rufai Oseni describe di development as a "bold move" by di govment, "bicos wen you look at di amount di president dey put on di military today, na about half of di initial amount wey use to be di military budget".
But e add say make govment now put more moni to provide beta military equipment and hardware for di armed forces.
On top social media, Babatunde - @Tunde03_ - write say:"Dis na wetin di military need: beta welfare, technology, and ammunition. Den watch di boost for di morale of di personnel to fight terrorism and protect di border of di kontri."
For Abimbola wey im username na @Sunshineboy2001, e tok say di salary increment "na good gesture to start wit", but oda welfare package like dia daily food allowance and odas, need to also improve.
Godson - @emmagold - tok say make di president "go further and do di same for police", plus make e also "upgrade police and army barracks".










