How Nigerians fit contribute to creation of state police for di National Policing Bill

Wia dis foto come from, Adekunle Ajayi/NurPhoto via Getty Images
Nigeria govment dey invite citizens to contribute to di process of di State Police wey dem wan create.
Dis dey come as di Presidential Working Group on di proposed National Policing Bill bring out invitation to Nigerians make dem submit memoranda and policy proposals.
Dis na part of efforts to establish comprehensive legal and operational framework for state policing.
For statement wey Bayo Onanuga wey be Special Adviser to di president on Information and Strategy release on Monday, e tok say di Chief of Staff to di President and Chairman of di Working Group, Mr Femi Gbajabiamila na im make di announcement on Monday afta di Working Group meeting wey happun for di State House, Abuja.
"Di Working Group dey reviewing di Police Act 2020, di Police Service Commission framework, police regulations, and oda relevant laws to support di development of effective, modern policing system."
Di staement add say di proposed framework "go set national minimum standards, define state readiness and grant certification, clarify jurisdictional responsibilities, ensure independent oversight, uphold human rights, and guarantee sustainable funding. E go also spell out orderly transition to di dual-policing structure."
Wen di contribution go start and wen e go end
According to di statement, di call to submit contributions go run for two weeks bifor e go close.
E go also give opportunity to citizens, professionals, civil society, security agencies, state and local govments, academics, and oda stakeholders to contribute.
Wen dem deon contribute finish, di pipo wey dey incharge go chook eyes for wetin Nigerians send, dem go pick di important ones and dem go draft bill from am.
Dem go also do " national consultation" bifor dem go finalise and send am to National Assembly.
Di new National Policing Bill go also set out requirements for recruitment, training, oversight, funding, and transition arrangements wey go ensure credible, effective, and accountable policing for di kontri.
If you wan ssubmikt your contribution see how you fit take do am.
- Make your memorandum no long pass ten pages, excluding annexes, and you must write am in English.
- Make you submit single PDF document and label any supporting annexes clearly, number di pages and put dem inside di same file.
- Use Oxford University Standard for Citation of Legal Authorities (Oscola) referencing throughout, wey include legislation, case law, official reports and secondary sources.
- Clearly identify di thematic area or areas wey you dey address.
- State your name or institution, designation and contact details.
- If e dey possible, frame recommendations as specific drafting suggestions instead of general commentary.
- Disclose any institutional or professional interest wey dey relevant to your submission.
Wetin be di National Policing Bill?
Na constitutional amendment on State police wey remove Nigeria from single police system to double. E go get di Federal Police Service and State Police Service.
Di State Police service nomgo fit start untill e dey established by State law and e dey certified say e meet national minimum standards inline wit di Act of di National Assembly.
Di National Policing Bill na di Act wey go provide how di state police system go operate to maintain national standards.
E go also check State readiness certification, routine and special inspections, criminal information systems, data sharing, complaints, accountability, federal intervention, firearms control, grant support and transitional arrangements.
E go undertake di consequential legal conversion wey dey required, sake of say existing federal and State legislation still get single Nigeria Police Force.
Di Bill dey expected to run through twenty substantive Parts and ten Schedules.
Dis bill no go just turn to law like dat, e go pass through two stages wey include to amend di Constitution to permit State police, den to pass di legislation wey go make am work.
Di first one don complete, na di second part of stage one dey go on now. Di stages wey remain na make di State Houses of Assembly approve am and e dey in progress.
Di next part for stage one na to Assent and gazetting, dis one go happun later.










