2027 Women's World Cup African playoff preview

Published
Read am in 7 mins

Afta Wafcon semi-finalists bin book dia automatic qualification for di 2027 Women's World Cup for Brazil, two odas still get di chance to qualify.

Malawi, Algeria, Morocco and Cameroon secure dia spot, two more spots remain for teams from Africa.

But to get dose two spots, no be chicken change; na blood, toil and sweat; sabi pipo describe am as di "complex route" to qualify.

Four teams wey bin fail to reach di Wafcon semifinal go battle among diasef for dis African playoffs, bifor di winners go continue to participate for di Intercontinental playoffs wey involve total of 10 teams.

According to Fifa, two kontris each from Africa, Concacaf and South America togeda wit one rep each from Oceania and Europe go jam for dis intercontinental playoffs.

Di tournament go happun for two phases – di first phase go happun for November and December 2026 wey di final phase dey set for February 2027.

Teams from di same confederation no go dey di same pathway for di Intercontinental playoffs.

Now make we build up to di African playoffs wey involve dis four teams on Thursday 13 August.

Ghana v Ivory Coast

Ghana bin lose to Malawi - wey now dey play for di final. Ivory Coast also bin lose to Algeria for dia quarterfinal.

Both Ghana and Ivory Coast now go jam.

Bifor di ongoing Wafcon, Ghana bin sama female elephants 1-0 for pre-tournament friendly as part of di preparation.

Dat win na hard-fought, wit di only goal by Sharin Sampson for di 75th minute of dat game, even though both teams bin create chances for dat game.

Di Black Queens and female Elephants don jam each oda a total of six times; Ghana bin win two, Ivory Coast don win two, wey di oda two end for draw.

Out of di six meetings, four be friendly games, two be competitive games – Wafu Nations Cup for 24 February 2018 and African games for 15 September 2015.

For di ongoing Wafcon, di Black Queens bin win only one game against Cape Verde; dem lose two (against Cameroon and Malawi, both finalists), wia dem play 1-1 draw wit Mali.

Black Queens coach Kim Lars Björkegren for di pre-match presser say im no dey feel any pressure.

Di coach, afta Ghana comot di competition, tok say im dey feel "empty" sake of im wan qualify Ghana to dia first World Cup for 20 years.

"For me personally, pressure no dey at all, sake of if I dey under pressure, I no go make di right decisions."

"I bin dey dis game for 20 years as coach and 10 years as player, na my whole life be dat," di Swedish coach bin add.

Di black Queens bin recently complain about di non-payment of dia bonuses for tournaments and games for years.

Inside one statement, dem tok say di Ghana govment bin dey own dem outstanding Egypt 2025 bonus, Wafcon qualification bonus, Group stage bonus, outstanding per diem among odas.

But di sports ministry respond wey dem tok say dem no dey owe di team outstanding per diem.

Di ministry confam say wetin dem dey process now be di winning bonus for dia win against Cape Verde for di Wafcon.

For di oda hand, Ivory Coast don win two games against Burkina Faso 4-1 and 2-1 against Tanzania.

Dem lose to Algeria wey dem play 2-2 draw wit South Africa.

But all dis no go mean anytin wen di Black Queens and Female Elephants face each oda.

Di objective dey different; chance to qualify for di world cup via di complex route, whoever go win dis game get di advantage into di intercontinental playoff.

Female Elephants coach Reynald Pedros say di team gatz manage key moments well for di game, to stand a chance. We gatz find proper balance between defence and attack."

"Wetin dey our hand na to play wit di same desire from di beginning of di Wafcon; to win dis game and give di Ivorian pipo somtin to smile about."

Di game go happun at 5PM GMT (6PM WAT) for di Stade Larbi Zaouli for Casablanca.

Nigeria v South Africa

Di 10-time champions Super Falcons fail to defend dia title, but dia attention now go dey on how to try to qualify for di World Cup.

Dem gatz face South Africa.

Di Super Falcons qualify for di quarterfinal wit superior goal advantage afta dem sama Egypt 6-2 for dia final group game.

But dem lose two games for di competition – 3-2 against Malawi wey eventually dey di final and Cameroon wey also dey di final.

For di Banyana Banyana, dem win only one game for di Wafcon – 1-0 against Burkina Faso.

Dem lose to Morocco and Tanzania and dem draw wit Ivory Coast.

For di 2024 Wafcon, Nigeria sama South Africa 2-1 for di semifinal on dia way to win dia 10th title.

Both teams bin face each oda total of 26 times; Nigeria don win 16 of dose games wia South Africa win 5 wit di rest ending for draw.

Any game between di two teams na fire, dis one also no go dey different.

South Africa coach Desiree Ellis tok say "we get anoda opportunity to try and qualify, na ogbonge chance for us. We gatz bring our A-game, wit no margin of error".

"Di disappointment for losing di last game go motivate us, e neva go dey easy, di players sabi how big dis game be, Nigeria also sabi, but we gatz do wetin we gatz do," Ellis tok for pre-match presser.

Di last time di Super falcons bin show for di World Cup, dem comot for Round of 16 on penalties by England.

Dem finish di group stage unbeaten bifor dem jam wit England.

Dem go hope to qualify through di playoff route, but e neva go dey easy.

For di Super Falcons coach Justin Madugu, dis na do-or-die game.

"We sabi how important dis game be, we sabi wetin dey at stake. We dey ready, we go give our best."

Oga Madugu add say "dis game no be game we go use gamble; di players we go select go give dia absolute best."

Im say im dey hope all di players go dey fit for dis ogbonge game.

Di kontri go count on key players like captain Rasheedat Ajibade, defender Michelle Alozie and Assisat Oshoala to deliver.

But dem gatz watchout for Banyana Banyana key players Refiloe Jane, Bongeka Gamede and veteran Thembi Kgatlana

Di game between Nigeria and South Africa go happun at 8 PM GMT (9PM WAT) for di Moulay Rachid Stadium for Casablanca.