You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Why White House press secretary Karoline Leavitt leave di job
- Author, Sareen Habeshian & Bernd Debusmann Jr, White House reporter
- Published
- Read am in 4 mins
White House press secretary Karoline Leavitt go step down from her position for di end of di month, President Donald Trump announce.
Leavitt, wey di president call one of im "most trusted aides", go leave from her role to spend time wit her young children and family - "one decision wey I totally understand and respect", Trump write for one social media post.
"Karoline now go be one of my top outside advisors, and influential voice within di Republican Party," e add.
28-year-old Leavitt bin take di job as White House Press Secretary last year – wey make am bicom di youngest pesin to ever get di role.
E neva dey immediately clear who go replace her.
Leavitt and her husband Nicholas Riccio bin welcome her second child, a baby girl, for May.
She also get one two-year-old son. She return to work from maternity leave last month.
She write on X afta di president announcement say her work na "di honour and adventure of a lifetime".
"To be mama and to get new baby and to still dey work na one of di most demanding jobs for di world and di same time di most rewarding, but at di same time di most challenging season of my life, to say di least," she write.
"Di truth na say since I return to di White House afta I born my daughter, I no for my heart say I no fit be di best mom my two young children deserve as I go dey devote my constant time, energy, and attention wey dey required of di White House Press Secretary - and dat na why I don ultimately make di bittersweet decision to comot di White House and embark on a new chapter in my life," she continue.
Leavitt and her husband Nicholas Riccio bin welcome her second child, a baby girl, for May.
Bifor her tenure for di White House as press secretary, she bin don dey work wit Oga Trump for a long time, first as assistant press secretary and speech writer during im first term in office.
She later bicom one top aide to New York Republican congresswoman Elise Stefanik as communications director.
For 2022, Leavitt bin run for Congress for New Hampshire but she no win. She bin win di contested Republican primary to bicom di party candidate but sje later lose to Democrat Chris Pappas.
Leavitt sometimes dey get small katakata relationship wit di media wen she dey di position. She bin accuse some tori pipo say dem no dey neutral and say some of dem dey support left-wing politics.
For February last year, her office bin seize control of di White House press pool, remove organisational duties from di White House Correspondent's Association plus ban di Associated Press ova dia refusal to adopt di term "Gulf of America".
However, among supporters of di Trump administration, dem dey hail her well-well say remain "on message" and dey defend di president policies wit her full chest.
She be di second longest-serving press secretary for either of Trump administrations, afta only Sarah Huckabee Sanders.
E neva dey clear who go bicom Trump sixth chief spokesperson across im two administrations.
During Leavitt roughly seven-week maternity leave earlier dis year, different senior Trump administration figures don take di podium including Vice-President JD Vance, Secretary of State Marco Rubio, and Secretary of di Interior Doug Bergum.
BBC don contact di White House for comment on potential choices and di timeline of her replacement selection.
For one interview wit Fox News on Wednesday, White House Deputy Chief of Staff Stephen Miller - call Leavitt a "close friend" and "role model".
"We go continue to work togeda evri single day," e add. "Her tori just dey start. I no fit wait to see wetin her future hold."