'My mama deliberately make me sick for years until one doctor catch her'

A 1982 photo show Nina Blom at seven years old, inside a house wearing a summer dress. She get short blond hair and get a shy smile on her face. She sidon in front of a display of model ships.

Wia dis foto come from, Courtesy of Nina Blom

Wetin we call dis foto, Nina Blom at di age of seven years old.
    • Author, India Rakusen
    • Author, Radek Boschetty
    • Role, BBC Outlook*
  • Published
  • Read am in 9 mins

Growing up for di Netherlands during di 1970s and 1980s, Nina Blom bin dey like a typical pikin. She love music, singing and dancing, and get happy memories of playing wit her sister for di attic of dia family home.

But dose moments of happiness dey rare.

Occasionally, she go dey allowed to go out of her house, and from di age of eight, her mama convince her say she dey seriously ill. She kon begin carry her go hospitals for tests and treatments - 15 times in six hospitals in just a few years. Ova time, she make Nina use wheelchair and tell her say she get incurable muscle disease and tell her say she go soon kpai.

Ova di years, many medical professionals examine her, but none fit explain wetin dey wrong. E take one perceptive doctor to put togeda di fragments of Nina story and uncova di true, disturbing cause of her 'illness': her mama.

Paediatric Condition Falsification, also known as Fabricated or Induced Illness (FII) or Munchausen Syndrome by Proxy, na form of child abuse wia a carer - usually a parent - go exaggerate, lie, make up or deliberately cause illness in a child. Di reasons behind am still no dey fully understood.

Di first hospital admissions

Wen Nina bin dey eight years, she begin suffer from frequent stomach problems and lose plenti weight.

Wen dem come admit her to hospital and give her apple juice and soup, strangely, she begin feel beta.

"Di doctor go say, 'Nina dey fine... she fit go home.'"

But Nina mama go insist make dem return to di hospital - and say she must tell di doctors say her stomach still dey pain her - even though e no dey pain her.

A vintage photograph show Nina at three years old, playing with an old fashioned rotary style black phone. She dey look up and smile. Di room get a distinctive 1970s patterned wallpaper and dark furniture.

Wia dis foto come from, Courtesy of Nina Blom

Wetin we call dis foto, As young pikin, Nina bin dey play happily

Dis become pattern wey dem repeat ova and ova during di following years.

Once, during one family holiday, Nina complain of soreness afta swimming - and her mama immediately decide say she get muscle disease and need to go - again - to hospital.

Wen Nina no gree, her mama tell her: "No make a fool of me. You dey in pain and you go tell di doctor so."

For Nina, e bin dey deeply confusing.

"I feel guilty becos I bin dey for ward wit children wey get cancer, wey bin really dey sick," she tok. "I dey tink ‘Notin dey wrong wit me.'"

A boy for di bed next to her die while she bin dey di hospital, wey come add to her guilt.

'She bin dey ruthless'

In a black and white photo, a small child (Nina) sidon for her mama lap on di floor. Di mama dey look down so we no see her face. Two children books lie on di floor in front of dem.

Wia dis foto come from, Courtesy of Nina Blom

Wetin we call dis foto, Nina Blom at three years old wit her mama

Nina undergo plenti tests, including painful procedures such as bone marrow biopsy. Yet di doctors no find anytin wrong.

Her mama bin always dey dia, and weneva she see Nina dey smile, she go vex and punish her.

Afta one hospital stay wey last four weeks, doctors finally decide to send Nina home. As soon as she arrive, her mama put her for wheelchair, comot her from school and make her spend her days for one bed she set up for dia living room.

She no longer dey see her friends, and her mama comot di music she love to listen to. She find solace in knitting, but her hands come dey tired and sore. Her mama immediately insist say somtin terrible dey wrong and wrap bandages tightly around her arms.

Di bandage bin dey so tight dat her hands and fingers kon dey numb - somtin wey be like say e please her mama: "I no fit tell you how awful e bin dey to see my mama look like say she dey enjoy am."

'You go soon die'

A colour 1982 photograph show 11-year-old Nina sidon for wheelchair in a living room. Di pesin dey wear a matching green-and-yellow checked outfit over a light-coloured long-sleeved top and dey hold a string of orange beads. Lace curtains cova one window for di background, and a patterned armchair dey partially visible beside di wheelchair.

Wia dis foto come from, Courtesy of Nina Blom

Wetin we call dis foto, Each time di family move to anoda house, Nina go see new doctors

As di years dey pass, her mama story change. She tell Nina: "If I find out say you no dey in pain and you make am up by yoursef, I go hurt you."

Nina kon dey increasingly confused and say she 'lost hersef.

Becos she spend so much time for bed and wit her arms bandaged, she gradually begin lose strength. Eventually doctors send her to one rehabilitation clinic for physiotherapy.

Na dia she learn to waka again and even fall in love wit one boy wey bin also be patient.

For di first time in years, she begin to feel happy.

But wen di clinic allow her to spend weekends for house, her mama immediately take back control, and force her again to wear di painful bandages and ban her from getting out of her bed.

She say she get heart condition and one day tell her: "You go soon die."

"Dat na di first time I truly feel alone," Nina tok, "as if I dey fall into black hole."

'We want euthanasia. You fit help us, doctor?'

A colour photograph shows a young Nina outside di hospital, holding an ice cream cone with a large swirl of whipped cream in 1990. Nina dey in profile, with her hair tied back, and she wear a light-coloured top and a wristwatch. Trees and a few buildings dey visible for di softly blurred background across di water. Di image get di warm tones and candid feel of a family snapshot.

Wia dis foto come from, Courtesy of Nina Blom

Wetin we call dis foto, Nina dey eat ice cream while she dey hospital following placement outside di home for 1990.

Den somtin change.

During anoda hospital admission, Nina meet one new paediatrician, Dr Vrienten.

E tell her say e wan find place wia specialists go fit help to improve movement for her limbs and joints so she fit waka again.

Nina bin dey surprised.

Her mama always dey tell her say she get fatal muscle disease and go die from am. Deep down she get doubts, but no fit ask questions.

Her mama kon vex well-well and, wen dem reach house, she force Nina legs into X-shaped position and strap dem dia wit pillows. She restrict her food, and insert feeding tube through her nose and make her take 20 tablets a day.

During one doctor visit, she ask for Nina to die through euthanasia. Nina, ill and exhausted, agree. "Doctor, I want die," she tell am. "You fit help me?"

Di doctor step back, tok briefly wit her mama, and prescribe 24 hours of morphine.

"We go keep her asleep," e tok.

Di rescue

A slightly blurred colour photograph shows Nina sidon for hospital bed for one medical ward. Di bed get raised metal side rails and white bedding, and medical equipment dey mounted on di wall nearby. A large window dey allow daylight from di left side of di image. Cabinets, shelves and hospital furnishings dey seen for di background. Di photograph get di faded colour tones and grainy quality typical of older snapshot from 1989.

Wia dis foto come from, Courtesy of Nina Blom

Wetin we call dis foto, Nina first time to sit down in normal clothes, 1989.

But Dr Vrienten don put di jigsaw togeda and contact child protection services.

One day, one woman waka enta Nina room and tell her say she dey take her to different hospital. Nina beg her: "No, abeg. Make I die."

She notice say her mama don begin to panic. Two police officers bin dey stand nearby.

Soon, dem lift her onto one stretcher and take her away by ambulance.

Dem remove di bandages from her arms and legs and install video camera for her room.

For two days, she no see any of her parents.

Wen dem finally visit, Nina repeatedly tell dem: "I no dey sick."

She tok am again and again - 18 times in all.

Her mama forget say di camera still dey record and kon dey angry - evidence of wetin don dey happun all dis years.

Rebuilding her life

A present day photo show an adult Nina looking and smiling directly at di camera. She get short, light-coloured hair and wear a patterned top in shades of green and pink, a pendant necklace with an oval-shaped stone, and a small silver nose ring. Di image dey tightly cropped around di head and shoulders, with a softly blurred indoor background. Bright colours and natural lighting give di photograph a clear, modern appearance.

Wia dis foto come from, Courtesy of Nina Blom

Wetin we call dis foto, Nina decide to leave her past behind and celebrate her survival.

Afta some time, Nina decide to cut all contact wit her parents. She move to one treatment centre wia she receive physical and psychological therapy, and eventually settle for one new city under different identity.

She don build new life: graduate from art school, find work and fall in love.

Her parents no eva acknowledge say wetin dem do - and at one point, dem bin hire private investigator to find her - na somtin wey cause her big amount of new stress and distress.

She bin consider reporting dem - somtin wey no one bin don do at di time dem rescue her. But in di end she leave am, and a few years later, her parents die, one after di oda.

"Wetin my parents do me na crime," Nina tok, "na severe child abuse, and I barely survive am."

But she dey grateful say now she dey in good place.

"I dey so happy say I survive, and so much dey to live for."

Dis article dey based on one episode of di Outlook programme on di BBC World Service.

Nina memoir na 'You Are a Horrible Child' and her story dey told for di graphic novel 'You're Going to Die', by Margreet de Heer and Nina Blom.