Who be Kenya former govnor wey court jail for 25 years for murder of pregnant student

Man wit open
Published
Read am in 2 mins

Former Kenyan govnor Okoth Obado don chop 25 years prison sentence for di murder of 26-year-old university student Sharon Otieno for 2018.

Im former personal assistant, Michael Oyamo, dey also sentenced to 25 years, while former Migori County Clerk, Caspal Obiero receive 18-year jail term.

High Court Judge Cecilia Githua handed down di sentences on Friday, nearly eight years after Otieno dey killed in a case wey draw widespread attention for Kenya.

Di three men dey convicted of murder on 23 July 2026 afta di court find say di prosecution don prove dia case beyond reasonable doubt.

Im her judgment, Justice Githua find say Obado bin finance and instigate di murder, while Oyamo bin help facilitate di killing. Obiero din play role for hiding di crime.

Otieno dey 28 weeks pregnant wen she dey abducted and killed in September 2018. She dey abducted alongside one journalist wey managed to escape.

Dem discova her body di following day for thicket near Kodera Forest for western Kenya.

How di murder happun

Di murder attract widespread public attention, particularly bicos Obado na di serving govnor of Migori County wen di incident happun.

Di trial last nearly eight years, and e rely mainly on circumstantial evidence. More dan 40 witnesses testify for di case.

During court proceedings for September, Otieno parents appeal to di judge to spare Obado prison sentence. Dem say dem don forgive am and want make di court give am non-custodial sentence, wey mean say e no go serve time for prison.

Her mother, Melida Auma, tell di court say sending Obado to prison go be like experiencing anoda death for di family. She also argue say her daughter's three children need Obado support.

Her father, Douglas Otieno, say Obado family members don approach dem to seek reconciliation afta di former govnor receive conviction.

E say e believe say Obado don show remorse and deserve lighter punishment, but e still get bitterness towards Oyamo and Obiero.

However, Justice Githua reject di family's appeal, saying di circumstances surrounding di murder outweigh di factors wey di three men present to ask for lighter sentences.