Wetin we know about di gunshots for Niger capital airport

Wia dis foto come from, Getty Images
Residents for Niger capital Niamey tell BBC say dem hear explosions and gunfire wey dey come from di airport for di capital.
"I hear di first gunshots at 06:00 (05:00 local time) wen I dey mosque. But di current situation don dey under control," one pesin tok.
Di gunfire, wey last for two hours, bin come from di entrance to di airport, one witness tell AFP news agency.
Niger don dey fight militant Islamist insurgency for about 10 years and for January suspected jihadists launch attack on di same airport.
Like dia neighbours, Burkina Faso and Mali, na military junta wey enta power dey head Niger becos of di failure to deal wit di violence.
Residents tell BBC say di army don stop di Thursday attack, and now dem dey find di assailants wey reportedly abandon dia weapons.
No group don claim responsibility for Thursday attack and di authorities neva comment. But one affiliate to di Islamic State group bin claim say na dem carry out di January attack.
Niger Defence Ministry tok say for di attack wey happun for January, four military personnel get injuries while 20 attackers die.
For dat time, di head of Niger military govnment, wey don dey power for three years now, thank Russia for helping dem stop di attack.
Abdourahamane Tiani also accuse di presidents of France, Benin and Ivory Coast say dem support di pipo wey carry out di attack.
But e no explain wetin kain help Russia give dem, and e no provide any evidence to support di accusations wey e make against di oda countries.
For di last few weeks, authorities for Niger don demolish some neighbourhoods close to di airport, saying say na sake of “terrorist risks”.
Dem also extend di airport fence and install more dan 350 surveillance cameras, according to AFP.










