Israel and Lebanon ceasefire: Wetin to know about di deal

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Yang Tian
- Author, Helen Sullivan
- Read am in 6 mins
US President Donald Trump don announce say di leaders of Israel and Lebanon don agree for a 10-day ceasefire, wey go start from 17:00 EST (21:00 GMT; midnight local time) on 16 April.
Trump no mention Hezbollah for im statement, di Iran-backed militant group for Lebanon, wey Israel don dey exchange fire wit for di past six weeks.
But inside one post on Truth Social, Trump urge di group make dem follow di ceasefire, e tok say, "I hope Hezbollah go act nicely and well during dis important time."
Following di announcement, di US president also invite Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu and Lebanese President Joseph Aoun go di White House for more talks.
Dis na wetin we sabi about di ceasefire deal.
Wetin di agreement tok?

Wia dis foto come from, Getty Images
Di terms of di deal specify say di ceasefire go last for 10 days, and e fit "extend by mutual agreement" if dia negotiations show signs of progress.
According to further details wey di US State Department provide:
- Israel and Lebanon requested say make US continue to facilitate further direct talks wit di objective of "resolving all remaining issues"
- Israel get di "right to take all necessary measures for self-defence, at any time, against planned, imminent, or ongoing attacks"
- Lebanon must take "meaningful steps" to stop Hezbollah and all oda "rogue non-state armed groups" from attacking Israeli targets
- Pipo wey dey involved know say Lebanon security forces get di main responsibility for Lebanon security.
- Israel and Lebanon don request make di US continue to help facilitate direct talks wit di objective to "resolve di remaining issues"
Di statement add say di ceasefire deal na "gesture of goodwill" from Israel to allow "good-faith negotiations towards permanent security and peace agreement" between di two parties.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin di two sides don tok about di truce?

Wia dis foto come from, Reuters
Israel and Lebanon leaders don welcome di truce, Netanyahu tok say na "opportunity to make historic peace agreement".
Lebanese Prime Minister Nawaf Salam tok say e hope say di agreement go allow pipo wey don dey displaced by di conflict to come back to dia homes.
Hezbollah don show willingness to participate for di ceasefire, but dem tok say e must include "comprehensive stop to di attacks" across Lebanon and "no freedom of movement for Israeli forces".
Di Iran-backed group, wey dey deeply rooted for Lebanon, no dey part of di Lebanese govment security apparatus.
Iran foreign ministry don welcome di ceasefire, wit tok-tok pesin Esmail Baghaei wey express im "solidarity" wit Lebanon. Tehran don insist say dia own two-week ceasefire wit di US suppose include Lebanon while di US and Israel tok say no be so.
UN Secretary General António Guterres commend di role of di US for facilitating di ceasefire, and urge all parties to "fully respect" and "comply wit international law at all times".
President of di European Commission Ursula von der Leyen call di deal a "relief", e tok say Europe go continue to "call for full respect of Lebanon sovereignty and territorial integrity".
EU foreign policy chief Kaja Kallas add say dem must use di ceasefire to "step back from di violence" and create space for talks for "more lasting peace".
Wetin be Israel buffer zone?
Despite di agreement, Netanyahu tok say Israeli troops go still maintain 10km deep (6.2 mile) "security zone" for southern Lebanon, e tok say: "We dey dia, and we no go comot."
E add say di buffer zone need to remain to "block di danger of invasion".
Israel re-enter southern Lebanon afta Hezbollah strike for early March, creating buffer zone wey dem tok say dey necessary to protect communities for northern Israel.
One ceasefire deal between Israel and Hezbollah before, wey suppose end di 13 months conflict still record near-every day cross-border strikes.
How dem negotiate am?
Israel and Lebanon hold one direct talks for di first time for Washington dis week, dem aim to find solution to di war wey don cause deadly air attacks for part of Lebanese capital of Beirut and di fight for di southern part of di kontri.
Trump announce say di deal hapun afta "good conversations" wit Aoun and Netanyahu, but e no mention weda Hezbollah dey directly involve in di talks.
E later ask Hezbollah to "act nicely and well during dis important time" for social media.
Netanyahu, while e dey welcome di truce, also make am clear say e no go make plenty compromise for ground.
E tok say Hezbollah don insist on two conditions: di withdrawal of Israeli forces from Lebanon, and principle of "quiet for quiet".
However, e appear say ceasefire announcement don take Israel by surprise - even within di govment security cabinet.
One widely respected news outlet for Israeli tok say Netanyahu call meeting for security cabinet wit just five minutes notice, bifor dem announce di ceasefire.
Leak from dat meeting tok say ministers no even get chance to vote on di ceasefire.
Wetin dis one get to do wit di war for Iran?
Wen dem announce di ceasefire wit Iran, e get some mixed messages on weda Lebanon dey involve. Pakistani officials wey help negotiate di deal and Iranian officials tok say e dey, but Israel tok say no. US President Donald Trump Press Secretary, Karoline Leavitt, also later tok say Lebanon no dey part of di deal.
Israel attack Lebanon on 2 March as response to Hezbollah strikes. Dis one na afta di US and Israel launch strike on Iran – e make Tehran retaliate against America allies for Gulf, and from Iran proxy wey include Lebanese militant group.
Since den, Israel and Hezbollah still dey exchange fire, even though Lebanon Prime Minister don beg both sides make dem stop am.
More dan 2,100 pipo don die and 7,000 odas don injure from Israel attacks on Lebanon since 2 March, according to di kontri health ministry for Lebanon, wey no distinguish between combatants from civilians. Di number include at least 260 women and 172 children. Di ministry tok say 91 health professionals don die and 208 odas don injure for dis war, wit more dan 120 Israeli attacks wey don hapun on ambulances and medical facilities. BBC Verify analysis show say dem don destroy more dan 1,400 buildings for Lebanon.
Hezbollah attacks don kill two civilians for Israel during dis same time, and Israeli authorities tok say, 13 Israeli soldiers don die for combat for Lebanon.
On Thursday, di Israeli military destroy di last bridge wey link south to di rest of di country, making di region more isolated and dis don renew more fear among Lebanese say dis fit lead to long-term occupation for some areas.













