New satellite data show how fast some African cities dey sink

An aerial view of Lagos, Nigeria wit di sea visible in di background. A wide, brown river snakes through a city centre crowded wit tall buildings.
Wetin we call dis foto, Four million pipo in Lagos, Nigeria fit dey exposed to extreme sea levels by di end of di century, new study say
    • Author, Alex Brian
    • Role, Climate and Science reporter
  • Published
  • Read am in 4 mins

Some of Africa largest cities dey sink faster dan we previously tink, new research show.

Scientists use radar imagery from di European Space Agency's Sentinel-1 satellites to map how much di land beneath 20 African coastal cities don move.

Di study find say some cities - including Lagos for Nigeria and Alexandria in Egypt - dey sinking much faster dan dem previously estimate for 2021 by di UN climate body, di Intergovernmental Panel on Climate Change (IPCC).

While some causes of dis sinking, or subsidence, dey natural, many be di result of human activities, such as di extraction of groundwater from underneath di Earth surface.

Lead author Oluwaseyi Dasho say effects of subsidence "dey often invisible in evriday life, but ova decades dem fit substantially increase flood exposure".

Dis na becos wen di ground sink e become lower relative to di ocean and add to di risk of di sea level rise caused by climate change.

Seven million pipo, one million buildings and $180bn (£137bn) of assets fit be at flood risk by 2050, di paper estimate.

Satellites give clearer picture

In di past, lack of monitoring stations don prevent scientists from obtaining up-to-date localised information on subsidence for Africa, Dasho say.

But by using satellite data, di researchers from Virginia Tech dey able to detect land movements as small as 1mm per year.

Senior author Manoochehr Shirzaei say Sentinel-1 satellites fly ova di same region of di Earth evri six to 12 days.

"[Di satellite] transmit di radar signal, wey hit di ground and bounce back to di satellite," di geosciences professor explain. Dis process den dey repeated on "many revisit".

Di time between sending di signal and receiving am back dey recorded, wit changes in dis value ova time revealing how much di land don move.

A view of Alexandria from a high vantage point. In di foreground na road and a line of palm trees. Behind dem na multi-storey car park attached to a hotel. A row of skyscrapers under a blue sky fill di background.
Wetin we call dis foto, More of Alexandria fit dey exposed to flooding dan we previously tink, di research say

Dem find di ground under Alexandria and Lagos dey sink average of 6mm and 5mm per year respectively.

If dis rate continue, sea levels around Alexandria go rise 36% more by 2050 dan di IPCC predicted, under di middle estimates for how much planet-warming emissions go increase.

Luanda for Angola don also sink significantly, but oda cities such as Durban for South Africa don remain stable or even risen slightly.

Shirzaei say showing wia di IPCC bin underestimate risk - but also wia di threat dey overestimated - fit help planners allocate resources more effectively.

Sinking dey caused by local activities

Di man-made drivers of subsidence dey usually "extremely local, [wey] mean say we fit combat dem by creating local policies", Shirzaei explain.

One major cause na di increased water consumption of rapidly growing cities. Too much water wey dey too extracted from di ground fit lead to di soil becoming compacted and di surface sinking.

Di Aswan Dam on di Nile fit also be trapping sediment upstream and preventing di replacement of sinking land for Alexandria, di study suggest.

For Lagos, di reclaiming of land from di ocean to create artificial islands and di construction of buildings on loose ground na oda possible causes of subsidence.

Methods of preventing cities from sinking include supplying oda water sources and growing less water-intensive crops.

"Wateva we no fit mitigate, we try to adapt to am," Shirzaei add. Dis fit mean building flood defences or moving key infrastructure to higher level.

Di professor say developing kontris dey "left out" of much of di planning for sea-level rises due to a lack of monitoring.

Di techniques developed for dis study fit potentially dey used to address di knowledge gap for oda regions, such as di Pacific islands, Shirzaei suggest.

Oluwaseyi Dasho say e hope di paper, for Science Advances, fit help African govments "prepare adequately for future challenges and more importantly for di future generations".