ICPC confam say CBN, federal govment no send money to fake agency PFICP or DG Adeyemi

President Bola Ahmed Tinubu receive di report on di investigation of Presidential Foreign Investment Promotion Council Director-General, Adeniyi Adeyemi, from di ICPC Chairman Dr. Musa Adamu Aliyu, SAN, inside di State House, Abuja, on Thursday, August 6, 2026.

Wia dis foto come from, Bayo Onanuga/X

Published
Read am in 6 mins

Afta weeks of investigations, Independent Corrupt Practice and Other Related Offences Commission (ICPC) don finally submit dia report to President Bola Tinubu ova di alledged fake agency as dia one month deadline by di president don end.

Di commission tok say federal government no send any money to di fake agency wey dey linked to Adeniyi Adeyemi, di fake director-general of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council/Presidential Economic Advisory Council (PFICP)

For February, Nigerian govment expose di fake agency wey Adeyemi dey run, at di time Adeyemi bin point finger to Femi Gbajabiamila as im accomplice

Dem later charge am to court, during di trial Justice Mohammed Umar of di Federal High Court for Abuja order for immediate arrest, days later Nigerian authorities confam say dem don arrest am.

For July, President Bola Tinubu order ICPC make dem investigate di matta and submit dia report within 30 days.

Days later, di national assembly agree to investigate how di supposed PFIPC take get di allocation of 1.302 billion ($954) allocation for di 2026 Appropriation Act even witout any legal backing.

On Thursday, ICPC chairman, Musa Adamu Aliyu tell tori pipo about di findings into dia investigations wey president Bola Tinubu bin request for di Presidential Villa, Abuja.

Aliyu tok say di fake letter of appointment no come from di president office and di agency no get any legal backing by di national assembly or any executive order by di president.

E tok say dem discover two more fake govment agencies wey dey linked to Adeyemi, di fake director-general of PFICP.

"Di appointment letter wey Adeniyi Adeyemi Mathew present dem completely forge am wit all di oda documents wey dem use to carry out di illegal activities of di fake agency," Aliyu tok.

"Our investigation show say no Federal Government no approve or disburse money to di fake PFIPC/PEAC."

"No weaknesses dey di systems of di State House or CBN and di processes dey clear."

"Di fake appointment letter of Adeniyi Adeyemi Mathew no originate from di presidency."

"Di ICPC discover say Adeyemi Adeniyi create two more fake government agencies wey be: (a) FCT Investment Promotion Agency (FIFA) and (b) Foreign Investment Promotion Agency and Public Private Partnership (FIFA-PPP)."

"To facilitate dia creation e forged legislative instrument wey dem dey call Enabling Acts and use am to support di opening of Bank Accounts."

Wetin be ICPC recommendation to federal govement?

Foto of Adeniyi Matthew Adeyemi and Musa Adamu Aliyu, ICPC chairman

Wia dis foto come from, Prince Adeniyi Adeyemi/Instagram/icpcnigeria/Instagram

Inside di report wey ICPC submit dem recommend say make di fake director general of PFICP face full prosecution.

Di commisssion reccomend say make president Tinubu impose administrative punishment to public officers wey allow PFIPC/PEAC illegal activities happun through dia negligence.

ICPC also recommend institutional reforms.

Dem dey investigate all activities, bank accounts of PFIPC, Adeniyi Adeyemi Adeyemi and him collaborators.

Di commission tok say investigation still dey go on into di bank accounts of PFIPC, Adeniyi Adeyemi Adeyemi and oda collaborators. "

Wetin bin happun?

Foto of Adeniyi Matthew Adeyemi afta im arrest by di police.

Wia dis foto come from, Bayo Onanuga/X

Nigerian govment bin expose di fake agency wey Adeniyi Adeyemi dey run PFIPC, dem tok say di agency no be lawful federal agency, even though dem dey operate from di Federal Secretariat, get official bank accounts and letters bin show say dem collect govment approvals.

Adeyemi bin deny di allegations and mention say im get accomplices for di Nigeria govment.

However, police authourities say dia investigations reveal say Adeyemi represent imself as di director-general of PFIPC and im run di operation alone.

Dem later charge am to court, during di trial Justice Mohammed Umar of di Federal High Court for Abuja order for immediate arrest, days later Nigerian authorities confam say dem don arrest am.

Afta im arrest Adeyemi dey face eight charges, and further reports from di federal govment show say about12 agencies dey linked to di fraud such as Office of di SG, di Accountant General of di Federation, CBN, di Head of di Civil Service of di Federation and di Budget Office.

For July, di national assembly agree to investigate how di supposed PFIPC take get di allocation of N1.302 billion allocation for di 2026 Appropriation Act even witout any legal backing.

During di latest hearing for di national assembly di head of di civil Service of di Federation, Didi Esther Walson-Jack, take responsibility for approving recruitment for di Presidential Economic Advisory Council/Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PEAC/PFIPC), di agency wey di federal govment tok say na fake.

Walson-Jack admit say her office no try as dem fail to do di necessary background checks bifor giving critical approvals to di 'fake agency'.

"My office bin receive di letter of appointment and di establishment act, and based on dose documents and also based on interactions wit di representatives of di PEAC/PFIPC, dem go on to issue di authorised establishment, and later di recruitment waiver.

"As we don see all di fact and observe all di document , we concede say we suppose carry out more due dilligence in di discharge of di duties of di office in issuing authorised establishment and recuitment waiver to di PEAC/PFIPC," Madam Walson-Jack tok.

While, one director from di office of di Accountant General of di Federation, Joshua Luka, tell di House Committee say na one of im junior officers no do wetin e suppose do, as e allow Mr Adeyemi to take one letter wey suppose dey forwarded to di office of di State House Permanent Secretary.

Di House Committee Chairman, Mr Gagdi, den point out say investigations don reveal say di letter no get to di Permanent Secretary, rada na Mr Adeyemi collect am.

"You allow di fraudulent DG to come and pick di letter from your office instead of allowing someone from di Permanent Secretary office to receive am. If dat letter bin reached di Permanent Secretary, dis fraud suppose don scatter immediately," Gagdi tok.

Mr Luka reply and say: "Di problem hia no be office lapse; na individual lapse. Somebody bin suppose deliver dat letter to di Permanent Secretary, State House, and e no deliver am dia."

Oga Luka say di name of di individual wey no do im job well na Bello Abdullahi who also dey present for di hearing, and e admit say true-true, e give di letter to Mr Adeyemi.