Kano govment dismiss Kwankwaso EFCC allegation claim against govnor Yusuf

Wia dis foto come from, Rabiu Kwankwaso/X
Former Kano State govnor, Rabiu Kwankwaso don accuse di current govnor Abba Yusuf say e dey try to use di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) to spoil im reputation.
Kwankwaso also accuse govnor Yusuf say e dey try to use di institutions wey dey fight corruption for Nigeria for political purpose ahead of di 2027 general elections.
Kwankwaso wey also be di vice-presidential candidate for di Nigeria Democratic Congress (NDC) for di 2027 election reveal dis allegations for statement on Friday, 27 November.
E allege say di govnor personally submit request give di kontri corruption police several months ago, to carry out investigation against am.
However, di Kano state govment don deny di allegation, say di govnor no get hand for Kwankwaso issue wit EFCC.
Di govnor personally submit formal request give EFCC to come afta me - Kwankwaso
"We believe say some months ago di govnor bin personally submit formal request to di EFCC to come afta me," e tok.
Kwankwaso allege say afta e no succeed to get di commission to act on di request, di govnor begin use di Society for Anti-Corruption and Good Governance Initiative (SACGGI) to put pressure for EFCC head.
E accuse di organisation say dem stage protest for EFCC headquarters for Abuja as part of di alleged campaign against im and members of im family.
Di former govnor also allege say di current govnor and some members of im cabinet bin dey use media platforms to spread tori wey di aim na to spoil im reputation.
Im describe di development as wetin dey raise concern, sake of im relationship wit Yusuf wey don tey well-well, wey don reach almost 43 years.
"Di longstanding relationship of 43 years wit am plus di trust e get for am give am access to information and insight into di value I put on personal integrity, trust wey regrettably, don dey misused and abused."
Yusuf bin serve as Kwankwaso personal assistant, principal private secretary and commissioner bifor e bicom di New Nigeria Peoples Party govnorship candidate for di 2019 and 2023 elections.
According to Kwankwaso for di statement, Govnor Yusuf dey abuse di trust wey dem build for many years.
E also accuse di govnor say e dey using public institutions to make im political influence weak.
Kwankwaso no end dia o, e link di controversy to di political developments wey dey surround im camp for di Kano governorship candidate, Aminu Gwarzo.
E allege say attempts dey to influence institutions to frustrate im participation for di 2027 elections.
Oga Rabiu tell political actors to respect di independence of anti-corruption agencies and oda public institutions.
Govnor Abba Yusuf no get hand for Kwankwaso issue wit EFCC - Kano state govment
Wit all dis allegations and claims, di Kano State Govment no gree, as dem throway di allegations.
Dem match leg for ground say Governor Yusuf no get hand for Kwankwaso dealings wit di EFCC.
For statement wey di Commissioner for Information and Internal Affairs, Sunusi Tofa sign, di the govment say di former govnor bin get engagements wit di anti-corruption agency bifor dis present administration come.
"Di govment wish to state categorically say Govnor Abba Kabir Yusuf no dey involve for Kwankwaso dealings wit di EFCC," di statement tok.
E describe di former govnor attempt to associate Yusuf wit di matter as misleading and e dey politically motivated.
Di govment also reject Kwankwaso attempt to link di governor wit di internal kasala and court cases wey dey involve di NDC.
E say di state administration no get hand for internal affairs or legal proceedings of di party.
Kwankwaso and Abba Yusuf relationship
Rabiu Kwankwaso na ogbonge politician for northern Nigeria especially for Kanom State.
For many years, former Kano State govnor Senator Rabiu Kwankwaso enjoy close relationship wit im successor, former govnor Abdullahi Ganduje.
Ganduje bin serve as Kwankwaso deputy two times, from 1999 to 2003 and again from 2011 to 2015.
Dia alliance grow stronger between 2003 and 2007, wen Kwankwaso serve as Minister of Defence and Ganduje work closely wit am.
However, dia relationship begin spoil shortly afta Ganduje take office for 2015, wen e submit im cabinet list to di State House of Assembly for confirmation.
Many of Kwankwaso loyalists bin feel say dem sideline dem, dem accuse Ganduje say e exclude dem from key positions.
Attempts to manage di tension fail, and di mata later turn full-blown rivalry.
Dis one lead to di 2019 govnorship election, wia Kwankwaso-backed candidate, Kabiru Abba Yusuf, contest against Ganduje and lose under wetin many pipo describe as "controversial circumstances".
Di fight kontinu sotay e enter di 2023 election, as Kwankwaso support Yusuf again, while Ganduje support Nasir Yusuf Gawuna.
Even though Independent National Electoral Commission (Inec) first declare Yusuf winner, tribunal later cancel di result, and di case enta appeal.
Abba Yusuf win for court wen Supreme Court of Nigeria affirm say e win di Kano State govnorship election on 12 January, 2024.
E later port from di Kwankwaso party wey be NNPP go join di ruling All Progressive Congress (APC) for January 2026.



















